Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,327 members, 7,808,102 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 07:16 AM

My Valentine With An Ilesha Babe - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / My Valentine With An Ilesha Babe (2559 Views)

Checkout My Valentine's Gift For My Boo(photo) / Would You Serve Jail Term For Your Babe To Be Released? (photo) / Celebrating Valentine With Your Partner In A Long Distance Relationship? (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:25pm On Feb 20, 2013
na wah oooo for the babe wey i come spend my valentine with ooo.na one ilesha babe wey i friend for facebook na im i come invite come my place for benin for the valentine.ever since this babe dey always dey worry me say she wan know my place so durin this valentine wey pass so na im i come invite her come benin.i send transport money to her account and on the night b4 the valentine she come land for benin.when i see dis babe i jus come dey dissapointed .Na so she come get ezema for her forehead and she come wowor no be small.me sef come dey wonder how manage she fine for her facebook picture.so na white wash wey she white wash her picture jus come deceive me like dat.Yansh sef she no get and the thing jus flat like sand paper and when she dey waka wit me i come notice say she get K-leg.anyway i just put mind say i go jus manage this babe for the valentine and on valentine night i come take her to Mr Biggs and GT plaza.i buy those five hundred naira ice cream wey dem dey put for small bucket and b4 i say make i bring plastic spoon for this babe omo she don lick all the ice cream finish with her tongue and fingers.na so me jus open mouth dey look dis babe.i buy fried rice with chicken for her and she begin to dey demand for santana with pepper soup and squardron 5 plus alomo bitter.omo this babe sabi chop no be small and b4 i comot for the fast food joint i don already burn 20k.chai! no god safe me say i collect better money from bank dat day otherwise na toilet window i for take escape ooo.anyway to cut a long tory short i carry this babe go my house to do the main valentine thing for my bedroom.kai! can u imagine say this babe yansh strong like palm kernel.kiss she no sabi kiss and na so she jus lie down like log of wood while i dey stress my waist angry.mennn this valentine this year na real fuk up for my side angry
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:27pm On Feb 20, 2013
grin grin grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by clockwise(m): 4:39pm On Feb 20, 2013
@ op i dey feel dis ur story o. dis is what we call AROSO. LOL
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:46pm On Feb 20, 2013
grin grin Too many comedians on NL

1 Like

Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:48pm On Feb 20, 2013
lefool lefool...you don show again grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:51pm On Feb 20, 2013
cheesy cheesy cheesy cheesy

my belle o
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:56pm On Feb 20, 2013
ItsModella: lefool lefool...you don show again grin grin
yes ooo i don show cheesy
me sef i dey feel say dis ilesha babe scam me ooo.dis money wey i spend on her she no deserve am ooo
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:58pm On Feb 20, 2013
binger: grin grin Too many comedians on NL
no dis one no be comedy ooo.dis really happen to me last week
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 5:10pm On Feb 20, 2013
lefulefu:
no dis one no be comedy ooo.dis really happen to me last week
If i hear
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 5:11pm On Feb 20, 2013
~vicky~:
cheesy cheesy cheesy cheesy

my belle o
my head o
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 5:20pm On Feb 20, 2013
^^^
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 6:18pm On Feb 20, 2013
^^^undecided undecided undecided
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 6:39pm On Feb 20, 2013
cheesy cheesy cheesy
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by chikeorji123(m): 7:32pm On Feb 20, 2013
binger: my head o

My stomach oo!.
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by chikeorji123(m): 7:36pm On Feb 20, 2013
cindyrella long time..
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by stpat1(m): 8:29pm On Feb 20, 2013
All the stuffs wey she don dey chop for dream don finally materialise. It will be her most memorable Val grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by cindyrella(f): 8:57pm On Feb 20, 2013
chikeorji123: cindyrella long time..
I dey o!
smiley

@topic
LWKMD!
Lefool, you no go kill pesin. chei! grin grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by 2goodbobo(m): 9:54pm On Feb 20, 2013
Kai I don laff sotay I fall for ground. Loool
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by visita: 1:20am On Feb 21, 2013
lol...don't worry guy, am sure some people had worse valentine
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by mrofficial(m): 6:03am On Feb 21, 2013
@Op, you no get eyes? At least, after you don see am say she ugly, you go form broke or something else. You come let ugly girl drain you with no reward for your money.

1 Like

Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Coldfaya(m): 7:51am On Feb 21, 2013
grin grin
Choi lefulefoo no go kee persin. I hope say u cover her exyma face with pillowcase b4 u start knack akpako. grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 8:21am On Feb 21, 2013
Ndoh angry angry angry. tongue tongue tongue tongue
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by brushstrokes(f): 8:35am On Feb 21, 2013
grin grin

Why in sanity sake did I open this thread grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 3:34pm On Mar 12, 2013
brush_strokes: grin grin

Why in sanity sake did I open this thread grin grin
curiousity kills the cat abi? grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by mkoabiola: 6:12pm On Mar 12, 2013
20k burn jus lik dat.
Lol,
U need to invite her again for nx val.
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 7:30pm On Mar 12, 2013
Lefu lefu you be real comedian o.but you sef no dey fear o.how you go meet babe wey you no know anything about am from adam except facebook,you con chop belleful get mind to log into her * you no dey fear std,gonnorhea,syphyllis and even hiv/aids cheesy as for the 2ok,no mind that one.you just do sara for the girl.but on a serious note,you mean say that same day wey you meet am face to face,con buy am ice cream,fried rice and chicken,na that same day you log in into her *.chaaaiiii fork don cheap pass pure water o.the girl sef no get shame cheesy by the way you sure say the girl no get ogbanje,this one wey she just open her * for you just like that that same day plus hope you remember wear condom sha cheesy
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by ikekings(m): 7:41pm On Mar 12, 2013
Lmfao... Lol @yansh strong like palm kernel... grin grin grin grin grin grin
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:28pm On Mar 14, 2013
Cold faya: grin grin
Choi lefulefoo no go kee persin. I hope say u cover her exyma face with pillowcase b4 u start knack akpako. grin grin
guy solid kongi hold me sadsotay i no even bother to use pillow case cover her face sad
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:33pm On Mar 14, 2013
kulyie: Lefu lefu you be real comedian o.but you sef no dey fear o.how you go meet babe wey you no know anything about am from adam except facebook,you con chop belleful get mind to log into her * you no dey fear std,gonnorhea,syphyllis and even hiv/aids cheesy as for the 2ok,no mind that one.you just do sara for the girl.but on a serious note,you mean say that same day wey you meet am face to face,con buy am ice cream,fried rice and chicken,na that same day you log in into her *.chaaaiiii fork don cheap pass pure water o.the girl sef no get shame cheesy by the way you sure say the girl no get ogbanje,this one wey she just open her * for you just like that that same day plus hope you remember wear condom sha cheesy
bros make u no worry.i take enough sapele water mixed with original secret concortion wey my grandpapa prepare for me.this concortion when mixed with enough sapele water e fit pursue all the HIV ooo,sypilis ooo and any yama yama disease wey dey person body cool
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:36pm On Mar 14, 2013
kulyie: Lefu lefu you be real comedian o.but you sef no dey fear o.how you go meet babe wey you no know anything about am from adam except facebook,you con chop belleful get mind to log into her * you no dey fear std,gonnorhea,syphyllis and even hiv/aids cheesy as for the 2ok,no mind that one.you just do sara for the girl.but on a serious note,you mean say that same day wey you meet am face to face,con buy am ice cream,fried rice and chicken,na that same day you log in into her *.chaaaiiii fork don cheap pass pure water o.the girl sef no get shame cheesy by the way you sure say the girl no get ogbanje,this one wey she just open her * for you just like that that same day plus hope you remember wear condom sha cheesy
\
wether na ogbanje or mammy water dat one no be problem.na inside juju dem for born bcause my grandpapa na strong medicine man.the only thing wy dey pain me na the money wey i waste on the babe.if no be the kongi wey hold me i suppose reason with the babe to carry her to cheap buka and yansh the babe on credit.she suppose for understand sad
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:42pm On Mar 14, 2013
lefulefu: \
wether na ogbanje or mammy water dat one no be problem.na inside juju dem for born bcause my grandpapa na strong medicine man.the only thing wy dey pain me na the money wey i waste on the babe.if no be the kongi wey hold me i suppose reason with the babe to carry her to cheap buka and yansh the babe on credit.she suppose for understand sad
cheesy lmao hope say you sha wear condom
Re: My Valentine With An Ilesha Babe by Nobody: 4:55pm On Mar 14, 2013
kulyie: cheesy lmao hope say you sha wear condom
no nah cellophane i wear cool

(1) (2) (Reply)

Guys, How Long Can You Wait For A Lady You Ask Out To Make Her Decision? / Ways To Tell Your Girlfriend/fiance Is Cheating On You / Help!!! This Man Is In Soup

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 39
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.