Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,842 members, 7,806,372 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 03:31 PM

Girls And Their Palava.... - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Girls And Their Palava.... (961 Views)

Bed Sheet Palava: A Short Story / Me, The Girls, And My Guys Dem / WARRI PALAVA: U Go Laff Tire. (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Girls And Their Palava.... by agidaizzy(m): 3:25pm On May 23, 2013
Girls!!! Girls!!! Girls!!! AFTER GOD, FEAR GIRLS No be today weySOME African Ladies don dey lie, e don tey well well. Their lies dey turn belle, but e get one particular system of lying wey dey make my head scatter.Person go update her status,like "I Love You"....wenyou ask her who she dey love, she go say na Jesus Christ she dey Love. Okay, no wahala. Another girl go update her status like, "I miss my baby so much".....if you ask am who be her baby, she go say na Jesus. Hmmmmm, una don see how some girls dey call Jesus baby ba? Some go write "I can't breathe withoutyou"..... and demgo say na Jesus dem dey talk about. Even wen people wey no believe in Jesus dey breathe wellwell everyday, people like Brad Pitt. Fat fat lies. The one wey dey pain me na when some ladies update their status like"I miss you baby, I wanna be in your arms".....and them go say na Jesus dem dey miss. Haba, wich kind thing be dis fa. So na Jesus arms dey hungryyou shey Make una stop dis tin abeg. Hmmmm, the drama no stop there oooo, their boyfriends and assistant boyfriends go go their inbox tofind out weda nadem she dey talk about. Comesee lies na, she go twist their heads and use reverse psychology takefinish them. Come see wetin she go yarn; "so Michael you don't believe me, it is you am referring to in that status and I must not put your name to prove my love for you. If you don't believe me, fine, I won't kill myself" O boy, with dis line, the girl go kill their moral and na the boys go come begin dey beg her. Thegirl go come dey form vexing tins and in order to cool her down, some of the jonzing boys go wire some money enter heraccount or buy her big recharge cards.... see hammer na...Chai, fear some African girls, walahi. So any time una see some African girls dey update their status like dat, make una bone dem. They are still learning.....lo ­­lz Kai, African girls, I hail oooo... I dey feeluna die.....
Re: Girls And Their Palava.... by agidaizzy(m): 1:41pm On May 27, 2013
Add ur own tot about grls...

(1) (Reply)

Apocalypse [a Horror Story] / Invasion Of Lagos By An Area Boy written By Edozie Udeze / Where There's Smoke (short Story On 54 Artistry)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.