Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,437 members, 7,808,563 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 01:29 PM

How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo (2526 Views)

How I Got Duped With My Money,time,and Makeup!!! / How I Got Married At The Age Of 35!!! / My Aunt Married At 39 (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Nobody: 10:16am On Aug 31, 2013
Here is this inspiring story to encourage all our single ladies who are diligently praying that God should send Mr right to them...

My name na Pamela, e don teh me for this world, I dey 38 years of age. I just marry last 2 weeks. I want to yarn una how the thing happen. All my friends wey all of us graduate from the university together don marry but my own case different and e come be say I dey go church well well and be good Christian. For naija wey we dey so, if u don reach 30 say u never marry, your family go dey disturb, people go surely talk say dem they follow you for your family. Na so people com dey talk for my own case. E never finish ooooo. Were I dey walk, na only N15,000 dem dey pay me monthly and e no dey reach me anywere. I go pay transport reach were I dey work. I no know wetin to do. My parents dey tell me make I marry but na me go go find the man? No be if dem come I go access them.
For about 4 years now no man don come tell me say I fine or him love me but I still put everything for BaBa God hand. I know say one day BaBa God go do am.
I dey come back from church this evening wey I see car dey follow me for back, I come turn and the light come flash me for eye. I jeje comot for road make the car no hit me. As the car reach were I dey, e come stop. Na so one fine man come come out inside the fine car. The man come ask me were I dey go, I tell am say I dey go house, he talk say na me he dey follow, n aim I ask why he dey follow me. He talk say he just like me say he dey normally dey see me dem come back from church and he just come back from Denmark and he dey normally dey come him friend shop come just play with am as e be say he still dey register him business. So each time he come around , he go c me dey go church and dey come back. The one wey surprise me be say he talk say him like. The uy just dey polite. Na him I laugh hahahahahahahaha… I laugh in hausa. He talk say why I laugh na im I tell am say na wetin him dey talk n aim dey make me laugh. He talk say if he go carry me for him car go house, I tell am no say I don already reach my house as na inside gate I want to enter. He say ok make him follow me n aim I tell am no. Na im I think of this thing again because even if say na unbeliever he be and if I want to convert him, I got to be friendly. Well I come tell am make he come. We enter inside gate n aim I open my one room, he come follow me enter. As I enter, I dey hungry well well and na the last garri wey only one person go chop na im remain with small soup wey only head of fish dey inside. I come make d eba finish, I no even bother myself because the man na ajebutter so he no fit chop dat kind food. I put my eba for plate and soup too, I just tell am make he come chop, before I know wetin dey happen, this man wash him hand come follow me dey chop. I dey surprise ooo. He come even dey drag my head of fish with me. Na im I come dey regret why I call him. After we chop finish n aim e tell me whether I dey surprise say him chop with me? I tell say yes oooo but because I be Christian and bible talk am say there is love in sharing and I see say him na stranger and he dey hungry and na be be d good Samaritan dat is why I give him the food. The man look me laugh. He stand up come tell me say he done dey go, n aim I come start to escort him to gate were him car dey. He come dey yarn me say him like me and he go like to marry me. I turn to this man come say “just like that” , because you just meet person for the first time and you don dey talk marriage. Before I know wetin dey happen bobo don dey quote bible, both of us start to dey quote bible. We argue for about 1 hour for outside about marriage and courtship. Na there I realize say this man even know the bible pass me. He come tell me say he go dey go and the next day he go come make we finish the topic.


The next day the man come for night, I no even ask am him name but he already know mine. He come with some gifts and with that him friend wey he talk say he dey come visit for that area. E come be say that him friend na my good friend wey get one popular laundry for that our area. We talk and spend over 2 hours and them come go. Na so this guy start to dey come my house everyday. He dey beg me say he want to mary me. I tell am say make he give me some time make I think about am. Well I come use the opportunity of the time come access him background, come know him family and friends and finally I come pray to God and my friends come help me in prayer. I wanted to be sure. After 2 months na him I agree to marry this bobo. Today am married to a wealthy business man and a good Christian. It is indeed what waiting for and it’s what waiting for. I will advise my fellow sisters who are experiencing what I went through to be prayerful and keep hoping on God. He go surely do am as he don promise.

http://www.hovabuzz.com/news/439-how-i-got-married-at-last-baba-god-don-do-am-ooo
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by ITbomb(m): 12:02pm On Aug 31, 2013
As in eh , you hear say the guy just land from Denmark , ur brain touch , u come show am wey u live with immediatification.
To say na me , u for say ur parent dey inside , say ur church no dey gree u talk with man for road .
I must drive Jeep before next year end so that I fit stop any girl for road and she carry me go her room
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Iaz93: 2:25pm On Aug 31, 2013
undecided undecided
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by holyvirgin: 5:16pm On Aug 31, 2013
I no sabi write for pidgin english abeg, how I wan take start?
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Lucasbalo(m): 8:48pm On Aug 31, 2013
Really interesting.
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Nobody: 12:20pm On Sep 01, 2013
holyvirgin: I no sabi write for pidgin english abeg, how I wan take start?
well u have to start from somewere. Not every good writers can write in pidgin English. But if you really can write in English, pls stick to it.
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by alienware(m): 2:05pm On Sep 01, 2013
ITbomb: As in eh , you hear say the guy just land from Denmark , ur brain touch , u come show am wey u live with immediatification.
To say na me , u for say ur parent dey inside , say ur church no dey gree u talk with man for road .
I must drive Jeep before next year end so that I fit stop any girl for road and she carry me go her room
why her head no go touch ? What if na u ?
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Godson201333(m): 4:29pm On Sep 01, 2013
aBEG na who don finish reading everything make dem summarize dem to me
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Nobody: 6:48pm On Sep 01, 2013
Godson201333: aBEG na who don finish reading everything make dem summarize dem to me
38 year old girl meet man wey get jeep for road, come carry am go im house, come cook eba with fish head wey the man follow am chop na im the man talk say im wan marry the girl. ma so dem marry after 2 months. tori don finish.

2 Likes

Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Sunbellar: 6:50pm On Oct 01, 2013
Bludeville:
38 year old girl meet man wey get jeep for road, come carry am go im house, come cook eba with fish head wey the man follow am chop na im the man talk say im wan marry the girl. ma so dem marry after 2 months. tori don finish.

And na watin d man come chop join. Anyway sha, the major thing be say she don catch the man @last. 38yrs lady no de joke with such opportunity. Congrats and begin make children quick quick b4 men-go-pause.
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by mspee(f): 7:14pm On Oct 01, 2013
Oboy! Wetin I need as my independence gift right now na summary to this novel. Any kind pesin to helep me? Abeg, I no go school. embarassed
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Nobody: 9:19pm On Oct 01, 2013
lipsrsealed grin grin cheesy cheesy Nairalanders, una no go kee me with laff oooooo! Sis, U no tell us whether na U senior am or not. U for use your Church mind, let us in on that
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by Nobody: 12:07pm On Oct 02, 2013
Madam this ya story get kleg' wetin you been dey do wen you no fit grab bobo till you jam 38? You never hear of menostop how you wan take born? I even come they wonder how your wishi-wishi go dey. undecided
Re: How I Got Married At Last, Baba God Don Do Am Ooo by homesteady(m): 12:18pm On Oct 02, 2013
^^^
Menopause never reach na!
Which one come be wishi-wishi again? gringringrin

(1) (Reply)

If I Know She Was Married I Couldn't Have Done It. / The Catastrophes That Come With Kissing / Does Class Matters When Searching For A Life Partner?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 27
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.