Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,017 members, 7,806,973 topics. Date: Wednesday, 24 April 2024 at 08:05 AM

Warri Talks/ Proverbs - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Warri Talks/ Proverbs (9667 Views)

Some Funny Nollywood Proverbs.. / Check Out This Hilarious Collection Of Proverbs / Proverbs And Adages As Told By Children (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Warri Talks/ Proverbs by coolestca(m): 12:09am On Oct 09, 2013
A warri friend once wanted telling someone he does not want to hear any complain later on said...
"I no want hear say dem shoot bird na im pesin mama fly, who you wan say carry am..."
it waz kinda stomach turning with laff, so pls add yours...
don't kill Da fun!!!
grin grin grin grin

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 12:27am On Oct 09, 2013
1.Leg wen swell up nor be rainboots
2.Okpolor(big eyes) nor be open eye
3.Fly wen dey dodge flying bullet anyhow na broom dey kill am
4.Who dey sell pepper no dey use hand dey scratch pri*k
5.The nama when rush go yankee na him dey come back as corned beef
6.Dem nor dey see snake pick
7.Nor be by power dem take dey stand pri*k
8.Pri*k wen stand nor get conscience
9.Who naked nor fit put hand for pocket
10.Play play na him dey turn to chop am go
11. Na only who something happen to dey know how e be
12.Winch nor dey fly for day tym
...... To be continued

4 Likes 1 Share

Re: Warri Talks/ Proverbs by coolestca(m): 12:37am On Oct 09, 2013
grin
LWTMB
onuwaje: 1.Leg wen swell up nor be rainboots
2.Okpolor(big eyes) nor be open eye
3.Fly wen dey dodge flying bullet anyhow na broom dey kill am
4.Who dey sell pepper no dey use hand dey scratch pri*k
5.The nama when rush go yankee na him dey come back as corned beef
6.Dem nor dey see snake pick
7.Nor be by power dem take dey stand pri*k
8.Pri*k wen stand nor get conscience
9.Who naked nor fit put hand for pocket
10.Play play na him dey turn to chop am go
11. Na only who something happen to dey know how e be
12.Winch nor dey fly for day tym
...... To be continued
Re: Warri Talks/ Proverbs by Nobody: 6:43am On Oct 09, 2013
coolest ca: A warri friend once wanted telling someone he does not want to hear any complain later on said...
"I no want hear say dem shoot bird na im pesin mama fly, who you wan say carry am..."
it waz kinda stomach turning with laff, so pls add yours...
don't kill Da fun!!!
grin grin grin grin




Thats not a warri proverb...

@onuwaje....nice one.. grin
Re: Warri Talks/ Proverbs by Acidosis(m): 6:52am On Oct 09, 2013
onuwaje: 1.Leg wen swell up nor be rainboots
2.Okpolor(big eyes) nor be open eye
3.Fly wen dey dodge flying bullet anyhow na broom dey kill am
4.Who dey sell pepper no dey use hand dey scratch pri*k
5.The nama when rush go yankee na him dey come back as corned beef
6.Dem nor dey see snake pick
7.Nor be by power dem take dey stand pri*k
8.Pri*k wen stand nor get conscience
9.Who naked nor fit put hand for pocket

10.Play play na him dey turn to chop am go
11. Na only who something happen to dey know how e be
12.Winch nor dey fly for day tym
...... To be continued

grin grin grin grin grin grin grin grin cheesy
Re: Warri Talks/ Proverbs by coolestca(m): 10:01am On Oct 09, 2013
gbosaa:




Thats not a warri proverb...

@onuwaje....nice one.. grin
but na warri talk kinda...

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 10:06am On Oct 09, 2013
Part 2
1.Goat na Goat if u like carry am cross border
2.Monkey smart na because tree near tree
3.Nigeria bad nor means say I go travel go mali
...... To be continued.. As the day progresses I go dey get inspiration to bring more

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 4:20pm On Oct 09, 2013
Part 3
1.Na who get money problem dey meet!
2. Maggi nor dey do the work of salt ..... Still lacking d inspiration to type more... Just be patient lemme think

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 4:57pm On Oct 09, 2013
Na small sh*t dey stain trouser

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 6:02pm On Oct 09, 2013
Pickin when wash him hand clean dey chop with king
Re: Warri Talks/ Proverbs by Nobody: 7:48pm On Oct 09, 2013
onuwaje: Pickin when wash him hand clean dey chop with king


not waffi proverb..
Re: Warri Talks/ Proverbs by coolestca(m): 2:03pm On Oct 10, 2013
gbosaa:


not waffi proverb..
bros put ur own Join nah nor dey kill mora
Shuo...
Re: Warri Talks/ Proverbs by coolestca(m): 2:04pm On Oct 10, 2013
gbosaa:


not waffi proverb..
bros put ur own Join nah nor dey kill mora
Shuo...
Onuwaje abeg thumbs in Da Air

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 9:33am On Oct 11, 2013
1. At all at all na im bad pass
2.Devil nor dey wear shoe
3.Toto nor dey get bone
4.No matter how life bad reach ashawo must get serious boyfriend
5.We don come this life na to go remain

1 Like 1 Share

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 9:33pm On Oct 11, 2013
No matter how you lazy reach u must get strenght to mess

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by drlaykay(m): 10:02pm On Oct 11, 2013
1.no be who call police dey win case
2.na for poor man mouth small stout dey bitter
3.i get am before nor be property

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 9:06am On Oct 12, 2013
No matter how woman wowo reach she must carry belle
Re: Warri Talks/ Proverbs by Nobody: 1:30pm On Oct 12, 2013
whr una come take dey see all dis proverb, obob for waffy men nor dey yarn like dat again, we don mature, na good english we dey speak nw,. Make una nor dey make mockery of warri again.
Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 8:25pm On Oct 12, 2013
ashezbrown: whr una come take dey see all dis proverb, obob for waffy men nor dey yarn like dat again, we don mature, na good english we dey speak nw,. Make una nor dey make mockery of warri again.
you talk like an unbeliever man..... All those proverbs I listed are mixed in our everyday langua(I use many of 'em)... So don't feel as a warri guy we make jest of our sef.. Its something we re proud of and its blended in our system. I don't think I even take note when I speak 'em. The average warri homie when grow up for places like okumagba layout,ugborikoko layout,iyara,okere etc.. They don't speak english. I guess you live in lagos or port harcourt so I doubt when last u come warri(that's if ur even a waffarian) so stop blaspheming!! ... Abi u join the world people crew?

2 Likes

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 9:24pm On Oct 12, 2013
Hunter nor need noise for bush

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by stanech: 6:10am On Oct 13, 2013
Bullet wey go meet facecap no be warning

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 8:45am On Oct 13, 2013
Dem nor dey test bullet proof jazz for pr*k
Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 5:49pm On Oct 13, 2013
1.Who dey stay with gun nor dey fear sword
2.Na only who hold gun dey laff who dey carry dagger dey come
3.Na only winch wen dem carry for back cross river dey complain say him leg dey touch fish
4.No matter how things red reach u cannot use chain tie goat
5. U nor fit dey 9ja dey barb who dey yankee hair

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 5:02pm On Oct 16, 2013
To give monkey banana nor be issue but to collect am back....

1 Like

Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 8:40am On Oct 18, 2013
1.Who short na where him hand reach him go hang clothes
2.E better for my teeth pull for ma pr*k to die
Re: Warri Talks/ Proverbs by bunmioguns(m): 9:41am On Oct 18, 2013
I no knw hw i go take contribute on top dis thread

arrrrrrrrrrrrrghh
Re: Warri Talks/ Proverbs by onuwaje(m): 7:56pm On Oct 19, 2013
Them nor dey tell deaf and dumb say trouble dey b4 him dey run
Re: Warri Talks/ Proverbs by Freshestprinxx: 1:11pm On Oct 20, 2013
Na who get power dey laff o

Na play play dey turn eat an go
Re: Warri Talks/ Proverbs by coolestca(m): 5:23pm On Oct 23, 2013
onuwaje: Them nor dey tell deaf and dumb say trouble dey b4 him dey run
wen him eye nor be film trick

(1) (Reply)

Top Slangs Presently Used In Unilag / Funny Meme Come And Laugh Away Your Problems (no Ugly Girls Allowed) / Nairaland House Of Representative. A.k.a House Of Share The Money. U are Welcome

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 30
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.