Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,521 members, 7,801,436 topics. Date: Thursday, 18 April 2024 at 03:12 PM

Letter To Harmattan - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Letter To Harmattan (12413 Views)

Photo: How We Bathe During Harmattan / My Open Letter To Harmattan (UGURU) / How To Have Your Bath During Harmattan (image) (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Letter To Harmattan by I2nu: 5:30pm On Dec 21, 2013
Bros H, how far na? My country people dey hail u oooo! I know say wherever u dey now belle don dey sweet u because tym to show ur talent don reach, bt bros as i dey write u dis letter i dey on my knees,i take god of ASUU take beg u, let by gone be by gone, abeg i know say we don offend u bt pls forgive and forget. Last week i see oga rain as im dey pack im load sake of say im wan go on holiday, na im i ask am say how bros H na, d way d guy reply me i know say wahala dey! Our lips are in trouble, na so e go jst dey tear anyhow, if we do mistake baff cold water naso we go dey shake like nokia 3310 on vibration, we no go fit know which 1 be public bus or private car again bcus dust don finish deir body! Girls no nid to use brown powder again na to jst stand for outside make dust cover dem!
No matter d cream we rub even if we rub 6 gallons of palmoil on our skin e go still dry like envelope wey dem take send letter bomb to dele giwa. Bros na beg we dey beg, postpone ur visit till next year!
Bros na we we ooo thanks
Yours faithfully
Victim of harmatatiaisis

53 Likes

Re: Letter To Harmattan by I2nu: 1:29pm On Dec 22, 2013
107 views nd no comment, dat's bad

2 Likes

Re: Letter To Harmattan by ivycrest: 2:20pm On Dec 22, 2013
.......
Re: Letter To Harmattan by geesilver(m): 2:21pm On Dec 22, 2013
S
Re: Letter To Harmattan by jonescyras(m): 2:21pm On Dec 22, 2013
O angryne word for the OP

1 Like

Re: Letter To Harmattan by cutebobo(m): 2:21pm On Dec 22, 2013
My galfriend dey complain say we don kiss for long time now. Why? My lips don tear finish
Re: Letter To Harmattan by Ademuyiwa59(m): 2:21pm On Dec 22, 2013
Nice Write up, I like it
Re: Letter To Harmattan by 3pleo: 2:22pm On Dec 22, 2013
:-)
Re: Letter To Harmattan by dryakson(m): 2:23pm On Dec 22, 2013
Lwkmd.
Re: Letter To Harmattan by Nobody: 2:23pm On Dec 22, 2013
who read it? please summarize for me..

yours faithfully,

Obasgilbert Coin

1 Like

Re: Letter To Harmattan by MilesLamar(m): 2:23pm On Dec 22, 2013
Dry
Re: Letter To Harmattan by Otunbab: 2:23pm On Dec 22, 2013
Nw wah o, Wetin make we wey come dey inside snow talk?
Re: Letter To Harmattan by Nobody: 2:23pm On Dec 22, 2013
My harmattan is not as harsh

1 Like

Re: Letter To Harmattan by paulworld(m): 2:23pm On Dec 22, 2013
I see, but you sure say the guy dey in the mode to negotiate with you
Re: Letter To Harmattan by jesse8048(m): 2:23pm On Dec 22, 2013
bros Wetin u want make country people do na? Wetin u want us to reply?
Re: Letter To Harmattan by Nikapetrelli(f): 2:24pm On Dec 22, 2013
Nice one,but d harmattan don go already
Re: Letter To Harmattan by Kunle106(m): 2:24pm On Dec 22, 2013
Nice one.. I gbadun am like oyinbo dey gbadun ciga
Re: Letter To Harmattan by jumzzy448: 2:24pm On Dec 22, 2013
And dis tin dey fp. Na wa oooo
Re: Letter To Harmattan by Drdaps(m): 2:26pm On Dec 22, 2013
This one is strong coz dis harmattan wan kill person
Re: Letter To Harmattan by 2shade(m): 2:26pm On Dec 22, 2013
pictures or it didn't happen

5 Likes

Re: Letter To Harmattan by homesteady(m): 2:32pm On Dec 22, 2013
Girls no nid to use brown powder again na to jst stand for outside make dust cover dem!

grin grin grin
Re: Letter To Harmattan by rioemmanuel(m): 2:32pm On Dec 22, 2013
2shade: pictures or it didn't happen
Pictures of what
Harmatan

2 Likes

Re: Letter To Harmattan by PointB: 2:33pm On Dec 22, 2013
@op,
Bros, abeg free bros Harmattan biko. Without him some fruits no go dey next year be dat o. That fit be another wahala. Make we leave things as God plan it. Bath hot water and cover body sleep.
Re: Letter To Harmattan by drstan(m): 2:33pm On Dec 22, 2013
Reply from harmatan:.
When you day do your own you day laf abi, when ASUU do he own waytin you tell am. You say you like am because you don day work they collect money, when rain day do he own you day happy they pack water day full your drum and bucket, now e don reach my turn you day complain, no be selfishness be that, you know want make i flex my muscle ba, during rain time, i scope chioma she bounce me because rain make her look fresh, i tell her say i go show her when e come my turn, now e don come my turn you day beg me, hope you go understan my plight na for just small time i get abeg make i use am well,my people i talk bad? thank you say you understan me.

16 Likes

Re: Letter To Harmattan by Gabreal1(m): 2:33pm On Dec 22, 2013
Lol... nice one
Re: Letter To Harmattan by vosquare: 2:34pm On Dec 22, 2013
grin grin grin grin grin
Re: Letter To Harmattan by Nobody: 2:36pm On Dec 22, 2013
cant even comprehend the writeup,its good to be an ajebutter. Write it in good english,for sake of ajebutter like me.
Re: Letter To Harmattan by johnstar(m): 2:39pm On Dec 22, 2013
Obasgilbert: who read it? please summarize for me..

yours faithfully,

Obasgilbert Coin
otondo, it means u r so daft for clicking on dis thread... a$$hole
Re: Letter To Harmattan by IAMBREEZY: 2:51pm On Dec 22, 2013
Good.
Re: Letter To Harmattan by Lordseyad(m): 2:52pm On Dec 22, 2013
Yomieluv: cant even comprehend the writeup,its good to be an ajebutter. Write it in good english,for sake of ajebutter like me.
lol, ajebutter ko ajeindomie ni... no b u dey 4 iya sola's shop wey u dey sell bizc.... mah stop here b4 u bomb me... jxt joking
Re: Letter To Harmattan by EejaNla01(m): 2:54pm On Dec 22, 2013
Harmattan VS Single brothers cheesy
Nd now that pre marital se.x is d debate on nL
*coughs* God save us

(1) (2) (Reply)

For Funny Pictures, Meme Freaks Come In And Update Your Meme Library Here / Ugly People Dating Site / When Whatsapp Chat Enters Wrong Hands. (screenshots)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 22
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.