Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,916 members, 7,806,663 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 08:16 PM

A True Life Story In Pidgin, Julie And Friday - Nairaland / General - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / A True Life Story In Pidgin, Julie And Friday (694 Views)

Federal Government Declares Thursday And Friday Public Holiday / True Life Story: My Ordeal With An Alien/Demon/Witch / Meet Me Here And On Facebook For Your Laptop Problems Every Wedesday And Friday (2) (3) (4)

(1) (Reply)

A True Life Story In Pidgin, Julie And Friday by Iceking1(m): 6:39pm On Sep 09, 2014
DIS NA BIG WAHALA O! I beg, I go try make this story nor long. I want
make e short like Aki and Pawpaw and also make una nor vex 4 me say i use pidgin do dis write up, i use pidgin bcus i no go skul and i nor sabi speak english . Friday dey friend Julie for more than 3 years. The
time when Friday cum ready to marry Julie, nai e
mama and papa send for am from village say
make e come.
Say, their tradition for every first boy pikin na to
marry woman wey come from their village becos na royal home dem for come.
And the marriage of first born pikin to indigene
na criteria for person to be king.
For their village, na gate by gate dem dey rotate
their kingship.
As Friday quarrel reach, e papa and mama give am deaf ear becos na him be their senior pikin.
Dem just tell am say dem dey wait make e talk say
e wan marry. As soon as e talk am, dem go give
am e wife wey dem don already choose for am
from small pikin. Why dem nor tell am since?
E nor get right to choose e wife?
Dis kain thing still dey happen for this modern
age? All those question nor concern anybody.
Tradition na tradition.
If you flaunt am, na only you go tell your story
with tears. Friday nor know how e wan take tell Julie becos e
know say Julie love am as winch love to suck
small pikin blood. So that day, Friday don booze any how.
E say e must go meet Julie make e burst the koko
for her.
Where e for dey kane e big jeans, nai Julie enter e
bunk.
After dem don chill for sometime, nai my guy clear her the koko. The cry wey Julie cry fit reach aboki take wash
gbola. Meanwhile, Julie get one backup maga, Omasan. Where Julie for dey reason how she go take
continue her life, nai Omasan begin show
seriousness.
Omasan dey work all this their 21 days on and 7
days off work for EGTL. Like play, Omasan cum tell Julie say e wan marry
her.
Dem cum do marriage like January. Like March,
Julie belle don full. As e tell Omasan say she get Belle, nor be small
sugar Dangote pack for e belle. God cum bless dem with a baby boy. That same year nai Friday go marry e wife wey e
papa don arrange for am. One year pass, no pikin.
Two years pass, no pikin. Friday cum suggest make dem go for medical
check up.
Na for St James nai Friday for jam julie with her
first son.
She don eat belle full again. E be like say na
antenatal she cum for that day. As Friday see the small boy, e cum dey somehow
shocked base on say the pikin resemble e own
younger brother well well. Friday cum tell Julie say make she try cum see am
for house say dem get matter to trash as per the
pikin so. Julie cum wait make her hussy travel go work
before she cum agree make Friday cum see her
for house.
Na there Friday for tell her say make she talk true,
who really give her the belle wey she take born
her first boy pikin? Truly sha, that month when Friday take tell her
say e nor want again, na that month e take get
belle.
But she notice say her menses nor flow when
Omasan take come for marriage.
Base on say she dey fear abortion, nai she take code the belle put am for Omasan head. So, Julie know say na friday get the pikin,
Omasan, feel say na him get the pikin.
Friday dey feel say na him get the pikin. The situation nai be this, TO ALL WOMEN If na you be Julie, wetin you go do? TO ALL MEN If na you be FRIDAY, wetin you go do? If na you be OMASAN, wetin you go do, if you last
last hear the matter? FACTS Many first pikin for many homes, nor be the papa
nai give the mama the pikin belle. ADVICE Befor you start marriage plans with your woman,
try go do pregnancy test.
Many Churches dey doam.
But court or registry nor dey doam.
As a guy man, play your card well make you nor
loose. In all, those families wey dey experience this kain
situation, make unu nor let the matter scatter unu
marriage.
Just return the pikin to e papa make unu move
on.
Bury the past and let it stay buried. That na my own suggestion to the family wey
bring this matter cum my studio.
But I tell dem to wait, say I want make pipo wey
get big brain box and Solomon sense for this
forum, throw their words put for the matter. Oya, make all nairalanders talk put 4 dis matter.

1 Like

(1) (Reply)

THE ILLITERACY AND IGNORANCE IN THE REMOVAL OF ARABIC NAIRA / SAVE NIGERIA / 10 Things Extraordinary People Say Every Day

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 24
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.