Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,496 members, 7,808,833 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 05:41 PM

Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. (734 Views)

Pre-Independence Day: Nigeria My Beloved Country... / APC Sent Greetings To President Jonathan On His Birthday / Awolowo Foundation Sends Condolence Greetings To Mrs Bianca Ojukwu (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by HisRoyalHardnes(m): 5:33pm On Dec 20, 2014
Thank you sir, for shortening my trip (by road) from Lagos to Abia by four Hours.
Oga, that Ore- Benin road just clear like say no be him again. As I dey approach Benin, d road come over smooth so Tay I fall asleep.

As I wake up check time, na 1:35pm dey nack. I look around to know where we dey, na him I see modotel hotel.(dem don renovate am but I still recognize am) I shout say na lie, how we take reach OWERRI now now? My driver tell me say sleep sef been dey catch am for the "nylon tar".
Oga Jona. No mind all those Yeye propaganda people wey dey deceive us for Lagos. U dey work o. U dey try. E no easy to change all the thing wey Buhari and co damage for several years in four years. You don touch agriculture, railways, my road, free and fair elections etc.

I know say we plenty wey dey see the things you dey do from North to East, south to west... And we go give you extra four years to touch Power more, healthcare more, unemployment more and security more etc.

Oga Jona, we know say if no be for those craze boko haram elements, you for don top chart well well. We dey behind you for the fight for real life and for twitter and online. We no go fit lose that battle. Lai Lai. We know say you no go smile with any boko( sympathizer o, negotiator o, sponsor o) again for your second term. We go crush them.

Oga Jona, things hard for us well well o. No forget to spread some of the goodie them wey you retrieve from Tinubu( Oando allocations) and OBJ, ( crude marketing allocations) wey make them dey complain, to we the masses as palliatives. Some of our pikin and us sef, na student. We go like am say you reduce our tuition and school fees at least by 50%.

Stealing na crime corruption na different crime so no vex when some people do like say them no understand you. Oga Joe, d corruption wey affect Naija pass na d one wey dey happen inside each and every of our household and institution dem. The one wey you go pay for your pikin expo and the one wey police go say make you bring money for biro/paper/petrol/kerosene to write statement. The one wey them collect N1000 from me for road safety office to capture my temporary licence.( e happen for agege in APC controlled Lagos)

Oga J, d corruption wey dey to fight na for Grassroots. No arrest Tinubu or Rotimi or Shettima for your second term with efcc, say you dey fight corruption o. These people have companies employing hundreds of thousands of Nigerians. The grass go suffer o. Instead Oga J, start am with principal of Nursery school wey dey allow Expo. Vice chancellor wey dey admit and tolerate cultists, people wey dey do fake and substandard items and Jobs, your cabinet members wey dey sleep on duty come dey pack our money, people/companies wey dey promote dancing/fashion/beauty competition with millions of naira, when intelligent people no fit see one science/essay competition etc. na these kind of Yeye attitude dem no let our economy grow. Na dem give rise to churches wey dey sell Hope, na dem born militancy, na dem give rise to stealing, na dem train impunity, na THESE BE THE CORRUPTION.
Oga Jona, I hope say you go fit read all these na why I wan stop here till new year. Many many people for nairaland no fit read anything wey pass one sentence so, no vex if you see some Yeye comment wey resemble dog and baboon vomit.

Have a blessed Christmas My Beloved President Goodluck Jonathan.
Hi to Mama Peace. I suggest you allow her more press conferences because, she does crack me up.

Long live GEJ
Long live Nairaland
Long live Nigeria

Merry Christmas to all the nairaland politicians( friends and foe alike)

Merry Christmas Sincere9gerian,firefire,ceo4eva,phockphockman(amaechis nemesis)atlwireless,ochejoseph,Ngwakwe,mynd44,Seun,chukwudi44,omenka,gberem, gbawe, obiagelli, therealmrstan,lalasticlala,ngeneukwenu,Descartes and all my buddies here too numerous to remember instantly.

As we continue to enjoy
Musiwa and cramjones.

Merry Christmas to y'all.

3 Likes

Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by Hadone(m): 5:34pm On Dec 20, 2014
Merry Xmas Mr. Clueless
Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by Firefire(m): 5:45pm On Dec 20, 2014
The journey of a thousand miles begins with a step, GEJ is changing the face of Nigeria.


Merry Christmas as you all, as you all travel on the good road made by GEJ government. Enjoy your vacation. cool

2 Likes

Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by mazzi: 6:57pm On Dec 20, 2014
Merry xmass my beloved presido.
Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by PhockPhockMan: 7:06pm On Dec 20, 2014
@Op, happy Xmas. Those who pick irrelevant things as reasons to insult the president hardly ask themselves their personal achievement since Five years because they know they're failures. Instead of admitting their lazy life, they blame the president.
When compared with other presidents
since independence, Goodluck Jonathan has done well.

HAPPY XMAS.
Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by ceo4eva: 7:58pm On Dec 20, 2014
Merry Xmas to you HisRoyalHardnes and everyone. No evil shall befall on us this season. Let's remember the reason for the season. We shall all live to witness 2015.
MERRY XMAS TO EVERYONE!
Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by HisRoyalHardnes(m): 1:26am On Dec 25, 2014
Prices of foodstuff remain stable. From Rice to Onions to tomatoes to Chics and booze, all stable.

GEJ TIL 19 JARE
Re: Seasons Greetings To My Beloved President, GEJ. by clevvermind(m): 2:08am On Dec 25, 2014
merry xmas to oga presido. Jonathan till 2019.

(1) (Reply)

Buhari Joins Twitter, Thanks Supporters / Nigerian Army Dismisses 203 Soldiers After Secret Night Trial / Buhari/Osinbajo's Campaign Rally Live In Rivers State.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.