Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,698 members, 7,805,869 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 07:37 AM

Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) (1279 Views)

That Moment When You Have To Woo A Lady In Pidgin Language. / Ekene And Judith, A True Life Sexual Story In Pidgin English / Love Story: I Wish I Had Held Back ( Very Touching) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) by Iceking1(m): 10:30pm On Mar 25, 2015
MR. AGOMUNE.
(TRUE LIFE STORY)



When Agomune go put e 18 seater bus
for road to load passengers go Port
Harcourt from Warri, the bus go stay for
like 4 hours befor e go even fit get 6
passengers. He go cum drive am go park
make dem help am complete am for am befor e go drive. Sometimes, e nor dey
even get passengers at all. For e mind, e
really like to get a very big motor park
where e for go fit dey load passengers
steady.




As a man with big dream, e cum dey ask pipo how e go take make this dream
come true.



Unu know say, word wey papa and mama
hide from pikin, na outside dem for dey
tell the pikin.
And when dem tell am, na the wrong one
dem go tell am.



One day, Agomune wife cum tell am say
she wan go see her papa for Eku say her
papa nor well and e don send message
cum say make she cum. When she tell
Agomune, e cum tell her say e go carry
her go drop for early morning. But the three pikin wey dem get, all of
dem go stay house.
Agomune say no problem. In the morning,
the children still dey sleep when
Agomune wake the senior one say e dey
carry their mama go village. Na for village when Agomune wife don stay for about 2
days nai she get message say fire burn
their house to ashes for night.




Everything for the house burn finish. And
the three children burn too. The news
almost make her crase. When she reach
Effurun, nai her husband for tell her how
e happen. Say e dey work dey hustle when
the thing happen becos e go for one charter for Bayelsa.




Compound pipo say na candle wey dem
sleep leave nai fall burn curtain wey burn
the house.
Another story say na high voltage wey
NEPA bring. One story say na gas explode.



But wetin surprise Agomune wife be say,
na only their side burn for the compound.
The fire nor enter the next flat. After 7
days when dem bury the children nai
Agomune drive one new coaster bus
come house show e wife say na e buy am.



The wife nor fit sleep that night. Na
around 2 nai Agomune for cum tap her
wake up. E cum take her go the children
room. Na there e for draw one Ghana
Must Go bag from under bed. When e zip
am open, na dollars full inside.



Na so e take confess give e wife how e
take use the three children for money
rituals.




As e dey talk, na so cold dey catch e wife.
At the same time, she dey cry.



He beg the wife make she nor reveal the
secret becos e nor go ever marry another
woman join her. And say she and am don
too suffer nai make am doam.



When day break, e cum tell the wife say e
dey go meet land agent make dem find
land for am wey e warn build motor park
put.





When e comot, the wife just dey think of
how to suppress the whole thing.


Na dey very confuse. But she decided to
keep quiet.



And today, Agomune get one of the
largest transport line for this country. The
wife born other children and dem dey live
in affluence.



But wetin pipo nor go talk be say, most
times, the three pikin blood wey stain
their hands still dey smell follow dem.



And anytime e dey smell, na cry the
Agomune dey cry.
The rich also cry indeed.



Now, make we relate am to our lives. As a good wife, wetin you suppose do in
this kind of situation?



Back your husband and enjoy the money?



Report your husband to the appropriate
authority make dem punish am for the
murder of unu 3 children?



Park comot from e life make you for nor
join eat for the blood money?



Mind you, you nor catch your husband o.
But e know say you go know one day nai
make am open up.



Dem say truth dey put person for trouble
sometimes.




As a man, you fit tell your wife something
like this when you don succeed doam
finish?



Yes



Or no?




Dem say, love your woman, but nor give
your heart to her.
Re: Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) by Enegod(m): 10:36pm On Mar 25, 2015
undecided
Re: Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) by mraventurah(m): 10:43pm On Mar 25, 2015
yawn!
Re: Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) by goodmorning40: 10:57pm On Mar 25, 2015
I don't have the gift of reading stories
Re: Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) by SkinnyDude(m): 11:15am On Mar 26, 2015
yawn
Re: Mr Agomune, A True Life Story In Pidgin English (very Touching) by yahx(m): 1:37pm On Mar 26, 2015
I enjoyed da write up![size=30pt]but lemme go spiritual tru tru anytin dat does not come frm d lord is a curse you ma tink you are enjoying life but judgement awaits you the blood of d innocent nver sleep they will hunt you down[/size]

(1) (Reply)

EXPOSED Cheating Girlfriend / No Finance,no Romance...how True? / Easy Ways You Can Get A Guy To Like You

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 19
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.