Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,825 members, 7,806,315 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 02:39 PM

Jonathan For Otuoke - Literature - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Jonathan For Otuoke (592 Views)

(2) (3) (4)

(1) (Reply)

Jonathan For Otuoke by ebiagtales: 4:46pm On Mar 29, 2015
This is a fiction, so don't mistake the identity of my fictitious character with any real life person o.
You can critique, abuse and do whatever to the author; he is not moved. But I am assuring you, the story is just about fun and figments of reality.

It is a pidgin Tory, so make you enjoy yasef.

1 Like

Re: Jonathan For Otuoke by ebiagtales: 4:58pm On Mar 29, 2015
Chapter One

My name na Jonah, but some people like to dey call me Jonathan, although no be wetin my parents call me be that. Na from Oshodi Oke den born me, but people like make den dey twist am say Otuoke because e get one Bayelsa guy wey be my classmate that time. Na the guy sef change my name to Jonathan because him tok say him get one friend for Bayelsa wet hin name be Jonathan. Him tok say that Jonathan na from Otuoke hin waka come.

I be very gentle guy, slow to dey do things so tey den begin call me slowpoke. Wetin I do people nah? I no deserve this kine name nah? Treat me well na? I go just dey cry pursue those guys wet dey frustrate my life.

My best friend name na Osunbo. Na from Benin him take waka come. I remember say those times we never dey wear shoe go school; all these Jakande school for Lagos. Chai! If you see the group black and white pictures wey we dey take those days eeh...the whole school go gather take picture.

One time like that, I go my state of origin for Rivers. My grandma carry me go meet one herbalist. The juju wey den do for me na to dey get goodluck for anything wey I do.

I stay for village for like one month when this smallpox strike our village for Rivers. The thing catch like 200 children including me. All of them die na only me survive. This thing don confirm wetin the herbalist man tok about me.

The smallpox cure after drinking many concoction. Nobody teach my mama before hin non carry me comot for River state come Oshodi back.
Re: Jonathan For Otuoke by bigwig97(m): 7:13pm On Mar 30, 2015
i can't read pidgin very well, talkless of understand

(1) (Reply)

The Downfall Of Anne Boleyn (poem) / Penastory: A Little Drizzle / The Tale Of Her

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.