Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,886 members, 7,806,555 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 06:15 PM

Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria (2395 Views)

Naija Joke - Ashawo Plan =) / See Wetin COCA COLA Don Cause O. (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by nairawallcom: 12:27pm On Apr 22, 2015
THIS POST HAS BEEN MADE TO PUT SMILES ON YOUR FACE EVEN IN THE MIDST OF NIGERIA'S PRESENT CONDITION.. LOLS

Na only for Nigeria you fit win
Aeroplane by loading N200 MTN
Recharge Card.
Very soon Etisalat go say recharge
N200 and win a big ship.
Then Airtel go com follow sey,
recharge N100 and win Benin
Republic.
Glo, go just kuku say... Recharge
N500 and win Nigeria because their
colour na Green.
Na only for Nigeria you go see fish
inside"MEATPIE"
Na only for Nigeria we dey count
money after we withdraw am
from ATM because we no even
trust ATM machines.
Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if
you pay your light bill. (wat a pity)
Na only for Naija people dey horn
for traffic light make e quick
change from Red to Green.
Na only for Nigeria Pharmacy dey
sell Coke, Recharge Card, Chin chin,
Puff puff and beer.
Wetin you no see for Naija, you no
fit see am anywhere in d world...
Trust me.
Na only 4 naija you go find a
graduate of Mechanical
Engineering dey do him NYSC 4
Police station.
na only 4 naija you go see one
person dey use Bold5, X3, Ipad2
and Nokia N8 all at once.You be
Bill Gates? Abi na you invent
internet?
Na only 4 naija you go see a
graduate of law dey work as
generator repairer.
Na 4 only Naija, you go see
madman dey control traffic,
people wey their head correct dey
obey...
Na 4 only Naija, wey you go see
the president senior the country
herself.
Na 4 only Naija, you go see advert
from native doctor on how to
make quick money.
Na 4 Naija obituary poster dem go
say "MAMA HAS RELOCATED"

God belss my one nd only country"

SOURCE: http://www.nairawall.com/edo/ukpoba/resources/arts-entertainment/46
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by ahmedox(m): 12:29pm On Apr 22, 2015
...
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by ahmedox(m): 12:31pm On Apr 22, 2015
Naija kwenu!!
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by kinibigdeal(m): 12:32pm On Apr 22, 2015
undecided
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by agoadiv(m): 12:35pm On Apr 22, 2015
i first heard dis jokes wen i was in ss2,now am in level 300 so op calculate how retarded ur brain works
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by Penssuwa(m): 12:53pm On Apr 22, 2015
i no wan laugh, na by force?
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by Faremisodeeq(m): 12:55pm On Apr 22, 2015
U try sha

1 Like

Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by nairawallcom: 1:17pm On Apr 22, 2015
LOL
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by nairawallcom: 7:40am On Apr 24, 2015
kk
Re: Naija Joke Of The Year - Wetin Dey Happen Inside Nigeria by meloo(m): 8:05am On Apr 24, 2015
op dis na copy and paste e don tey wey dis joke circulate na abi na now ur brain dey boot?

(1) (Reply)

Pics: The Way Ladies Jump Into Conclusion / Not Every Stick Is #selfie# Stick..(lol) / Lok At This Guys Facebook Profile

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 9
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.