Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,903 members, 7,802,931 topics. Date: Saturday, 20 April 2024 at 03:54 AM

We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm - Romance (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm (2657 Views)

. / 10 Simple Things Guys Do To Deceive Girls.. Which Won't Stop After Reading This / My Neighbor's wife Won't Stop Disturbing Me (2) (3) (4)

(1) (2) (Reply) (Go Down)

Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by Dollyak(f): 7:29am On May 21, 2015
Hmm lipsrsealed lipsrsealed
Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by loomer: 7:53am On May 21, 2015
Bravedaveo:


And wetin YOU don do about war, hunger and others?

Abeg, No sex until marriage jare
I


Wetn concern me and people wey go have sex before marriage. How that one wan take affect my hustle
Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by Bravedaveo: 8:03am On May 21, 2015
AtheistD:
Male virgins too. Where the male virgins at tongue

Here I am

Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by Bravedaveo: 8:07am On May 21, 2015
loomer:
I


Wetn concern me and people wey go have sex before marriage. How that one wan take affect my hustle

So if you get pikin(daughter) after marriage, you no go mind if she dey do anyhow?

Me I go mind o!!!
Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by loomer: 8:12am On May 21, 2015
Bravedaveo:


So if you get pikin(daughter) after marriage, you no go mind if she dey do anyhow?

Me I go mind o!!!

Ok I hear
Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by Bravedaveo: 9:50am On May 21, 2015
loomer:

Ok I hear
Seeing the beauty in a #sexuallyPure world now?
Re: We Won't Stop Until Sexual Purity Becomes Norm by profchimex(m): 9:32pm On May 21, 2015
Title: 2015 STUPID VIRGINS
***Scriptwriter, Produced & Directed by***
Chimenem Fortune (2A9B03E4)
Act 1 Scene 1

Bobo: Nna obaby fakanfa my tin dey scratch me welllllalalala (Jumping & Panting), e dey do me riko riko
Obaby: Nna take am easy Jare
Bobo: Open na, Just this once - I no go ask again
Obaby: See guy na No-SUM tins o
Bobo: Wich 1 b No-SUM again
Obaby: (Smiles) na No Sex Until Marriage na, abi you ma never hear?
Bobo: How dat fake rubbish use concern me na (Sighs) Pretenders!
Obaby: Wait first you go know if you no control that pipe
Bobo: Okay I go use CD
Obaby: Which 1 come b CD
Bobo: (Angry) Haba! Kilonshele? You too ask question, CD na Condom na... Wetin dey walk you na? Since 6 months plus now we dey date, you no wan open for me - Na you born Jesus? (Sighs)
Obaby: Bobo mi! Free that thing even CD no change the matter, I don tell you from the beginning na NoSUM tins o, Me don agree with myself & I, say we go dey kajardly kajard till marriage, Only my husband fit penetrate tear that blood sack - If you go wait, na you get am else... SOYO o
Bobo: SOYO?
Obaby: Ehen na! Strictly On Your Own - SOYO; Me na Virgin and I go wait, No be say I no wan kpolash o but no matter how e be, I just gats wait

Bobo disappointed waka comot as na only him waka come...
FADE OUT

Act 1 Scene 2
Bimpe: Guy you no fit perform? Wetin that stick dey your leg dey do na? Bring knife make I slice am use do suya make we chop at least we go benefit from am wella - The protein
Emeka: (Smiles) See babe no dey call my pp, stick o! I fit give woman belle na me no just...
Bimpe: No just wetin? Prove am! (Bimpe Interrupts)
Emeka: na me no just wan wire now, I don take my stand
Bimpe: Stand to sell pure water for market?
Emeka: Stand for Sexual pure rity, I no wan f...
Bimpe: see this fool o, since when? No be you cable me last month?
Emeka: That 1 na then, now I don change
Bimpe: o o o o o, no tell me say those deceivers wey dey shout NoSUM don wash your brain too
Emeka: if say na hypo dem dey use wash am, I for give dem 60 gallons to bleach am well well
Bimpe: You no even be virgin, you dey join dem
Emeka: Yes o, I don make mistake before but from now on... I don mellow down, Na better NoSUM tins o
Bimpe: Chei! Na so life be? After you cable me 6 rounds the last time, now you open your mouth dey tell me say you don change; Since when devil start to dey go church na...
Emeka: no be church something, na just my decision, I no wan do again; the one I don do, don do!
Bimpe: Instead of to tell me say you don arrange 1 asanwa keep for 1 corner wey you dey cable you come dey tell me say you no want wire me?
Emeka: See only God know say I no get any other babe wey I keep somewhere, Anyway believe me or not - You go try excuse me cos I need go our forthcoming World Virginity Day Celebration Rehearsals o, e go shelle
Bimpe: Virgins no exist again, make una no dey kill una self, una don scatter finish
Emeka: hmmmmmmmmmm dey dere na; Virgins still plenty pass people like us wey don scatter sef, dem plenty! If you doubt me, come on Saturday, 13th June 2015, your eye go big!
Bimpe: (Sighs) infact I dey wear my cloth back, you no serious... Jew man, manchi like you
Emeka: No forget o na 13th June, Just 23 days to go
Bimpe: concern you, Thank God I no go dey around that time; I go dey Akure, Ibadan or Uyo
Emeka: E dey happen anywhere you run go; whether na Lagos o, Ife, Port Harcourt, Ekiti, Abeokuta, Makurdi infact anywhere at all
Bimpe: No call my line again again o, Even if them be virgins, dem be STUPID VIRGINS, With all the wahala wey dey we country & d world sef, who be d FOOLS wey dey talk about Virginity or Sexual pure rity? How e come take make d world better? Make u & dem park well jare
Virgin ko, Virgin ni - Mgbo? Psycho!


Bimpe angrily bangs the door & walks out of Emeka's room
FADE OUT

...To be continued!



We are NOTHING but containers in the hands of the CREATOR


Watch Out for the next episode of
'2015 STUPID VIRGINS'

MINE Media Productions

M: +234 818 321 1898
E: info@mineteenageministry.com
BBP: 2A9B03E4
Twit: @Mineministry
Instagram: @Mineministry
FB Group: MINE Magazine Friends
FB Page: MINE Teenage Ministry
YouTube Channel: MINE Teenage TV
www.mineteenageministry.

#NoSUM
#ShoutOfPurity
#TakeAStand
#June13Loading
#VirginityDay

(1) (2) (Reply)

Wat Konji Can Cause :-\ / Help# My Girl Friend's Best Friend Is In Love With Me / .

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 21
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.