Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,143,316 members, 7,780,769 topics. Date: Thursday, 28 March 2024 at 09:39 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (60798 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:10pm On Feb 19, 2009
[quote author=olulu link=topic=232650.msg3482690#msg3482690 date=1234

oya i no fight again,
since my love u no fit gain,
and if i don cause u pain,
no seek me to slain,
so go deal with ur love matters,
but abeg, no do love for corner corner
[quote][/quote]

I beg make you no fight,
Quarrel and fight no dey right!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 1:23pm On Feb 19, 2009
maedan:

yes o, true true wahala we no get
na only one troublemaker make us forget
d real purpose of this sweet thread
but devil is a liar, 'im go regret
d day e try disturb true vals cheesy
who don dey turn into real pals
so rotimy, how u dey
hope u still tanda as u say
abi d love don dry
well, friend in need na friend indeed
remember say u don plant d seed
make u no slack make e turn to weed . . . grin
My love 4 U still tanda like Olumo rock,
And playa Olulu I go soon give a knock!
I dey wonda how e like always to make trouble,
But we go soon join hands to pay him back double.
Him own na e-jealousy on 2 hearts that beat as one,
But even sef e take head waka, You be my only one!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:53am On Feb 20, 2009
rotimy:

My love 4 U still tanda like Olumo rock,
And playa Olulu I go soon give a knock!
I dey wonda how e like always to make trouble,
But we go soon join hands to pay him back double.
Him own na e-jealousy on 2 hearts that beat as one,
But even sef e take head waka, You be my only one!

na these kain lines wey make me first fall cheesy
i too dey feel ur romantic call
but this ur sweetmouth fit turn head
or make i keep to myself instead?
becos dem say quick in, quick out,
if u break my heart i no fit shout  cheesy

i know say na so u dey tell all d gals
so i go wan make we just stay pals
i no wan rush, d speed dey too mush cheesy
dis tripping for NL don turn to crush
i still maintain, ur mind no get stain
i happy say we don link like chain

any which way, make we still dey look
just want u to know u dey my good book
unlike those yeye guys wey dey dis thread
u & me flow like butter n bread! kiss
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:33pm On Feb 21, 2009
maedan:

na these kain lines wey make me first fall cheesy
i too dey feel ur romantic call
but this ur sweetmouth fit turn head
or make i keep to myself instead?
becos dem say quick in, quick out,
if u break my heart i no fit shout cheesy

i know say na so u dey tell all d gals
so i go wan make we just stay pals
i no wan rush, d speed dey too mush cheesy
dis tripping for NL don turn to crush
i still maintain, ur mind no get stain
i happy say we don link like chain

any which way, make we still dey look
just want u to know u dey my good book
unlike those yeye guys wey dey dis thread
u & me flow like butter n bread! kiss

E dey good make our Life be upward movement,
And make we dey give our hearts better enjoyment.
We don start our movement as Vals,
Now we don upgrade as correct Pals.
I no dey like things wey dey too much cold,
Africans dey like take soup wey hot with fufu mold.
But I promise you from now I no go rush,
Because from my heart I go give you much.
As we don become Agege bread and Auchi butter,
Make you relax your mind for with me, things go better.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Moyola(f): 5:38pm On Feb 21, 2009
Oya write me a poem jo! cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:28pm On Feb 21, 2009
Moyola:

Oya write me a poem jo! cool


hmmn rotimy my man
i see u don get another fan
make u no fear say i go dey jealous cheesy
i hapi say u don become famous
so come one, come all
i no go vex at all at all grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:13pm On Feb 25, 2009
Moyola:

Oya write me a poem jo! cool

Some dem-too-sabi people dey see only doom,
Others wey say dem be money experts de halla gloom.
Dem de talk say the world economi dey meltdown,
Dat we no go see moni again to jolly for town.
But our bones dey strong and walai, we no go shake.
because de God Naijas dey serve no dey make mistake.
Me I know say De sun go shine again,
Wheather after de storm or de rain!!!
So make you no worry oh Mayola,
Things go get better from Lagos to Yola!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:28pm On Feb 25, 2009
maedan:


hmmn rotimy my man
i see u don get another fan
make u no fear say i go dey jealous cheesy
i hapi say u don become famous
so come one, come all
i no go vex at all at all grin

If na only me & you dey for dis wetinbesite Nairaland,
We go take our love rhymes turn am to fantasyland.
If na only me & you Baba come put for dat garden wey dey for Eden,
We go kneel down beg am make E no create Okoro, Olulu and Edem!!
If na only me & you come dey for one corner dem call love zone,
I no mind tell you say you be my torso flesh & my missing bone.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:35pm On Feb 25, 2009
i don fear say u abandon d project grin
come make me feel like one reject
thank God u remembr us today
u for see me for dream both night n day! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:01pm On Feb 28, 2009
maedan:

i don fear say u abandon d project grin
come make me feel like one reject
thank God u remembr us today
u for see me for dream both night n day! wink
How I go atart and abandon a project way be a fine thing?
How I no go finish with joy a jolly wey start for Valen-thing?
You dey for my mind day and night,
And I go make sure say u dey alright!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:27am On Mar 02, 2009
rotimy:

How I go atart and abandon a project way be a fine thing?
How I no go finish with joy a jolly wey start for Valen-thing?
You dey for my mind day and night,
And I go make sure say u dey alright!


me, dey for ur mind?
u think say na lie i dey find? cheesy
u dey deceive me like all those ur many girls
i catch u as u dey buy dem flowers & pearls

which one u buy 4 me? nothing!
na to use mouth dey treat me like common fling grin
ok, if u dey sincere, one thing u fit bring:
next time u post 4 hia, make u add my engagement ring!!!! shocked cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Jollof(m): 9:55am On Mar 02, 2009
ok, if u dey sincere, one thing u fit bring:
next time u post 4 hia, make u add my engagement ring!!!!

^^ nice one. Let me see, hmm

Honi, wetin you want? Na Gucci or Prada?
I be correct boy so money no be wahala
Na ma ride you suppose be, not Okada
We go chop die you go tink say na Salah
My luff tall pass - na you go need Ladder
Notin dey happen baby, make i com hala!
I wan marry so make we go see yor fada, grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:16am On Mar 02, 2009
@ jollof

no be say i too lyk money
but i wan make e spend from 'im honey

no b say my love na for sale
i jus wan make e act like male! wink

anyway, ur poem dey v. fantacious
but takia make rotimy my sweety no catch us!!! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:06pm On Mar 02, 2009
maedan:

me, dey for ur mind?
u think say na lie i dey find? cheesy
u dey deceive me like all those ur many girls
i catch u as u dey buy dem flowers & pearls

which one u buy 4 me? nothing!
na to use mouth dey treat me like common fling grin
ok, if u dey sincere, one thing u fit bring:
next time u post 4 hia, make u add my engagement ring!!!! shocked cheesy

I no dey lie lie to you my sugar cane & sweet heart,
Only say things dey hard for me and I dey sleep for mat.
So you too come believe say no romance without finance?
Well, because I love you pass suya I go control my annoyance.
For fine things I go buy for you I dey save plenti money,
So dat our love go sweet and flow like milk and honey.
I know wan send a ring wey go be bring suffer-ring,
Rotimy na your action man who go soon be a king!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 2:11pm On Mar 02, 2009
maedan:



@ jollof

no be say i too lyk money
but i wan make e spend from 'im honey

no b say my love na for sale
i jus wan make e act like male! wink

anyway, ur poem dey v. fantacious
but takia make rotimy my sweety no catch us!!! cheesy

Na jollof rice,ofada,coconut abi na fried rice?
If you dey eat him poem make you dey wise!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:44am On Mar 03, 2009
rotimy:

I no dey lie lie to you my sugar cane & sweet heart,
Only say things dey hard for me and I dey sleep for mat.
So you too come believe say no romance without finance?
Well, because I love you pass suya I go control my annoyance.
For fine things I go buy for you I dey save plenti money,
So dat our love go sweet and flow like milk and honey.
I know wan send a ring wey go be bring suffer-ring,
Rotimy na your action man who go soon be a king!

with sweet lv poem u no fit fail!
i cry so tey my tears fill pail!! cheesy
good things no matter,
true love dey better,
i just dey test u to know ur mind
but i now no say, u too dey kind

u no need to save,
i fit live wit u 4 cave cheesy
dat mat na we go share am
thru thick n thin, dis lv go stay bam! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by meexteriox(m): 9:01am On Mar 03, 2009
Maedan, you don wound my heart
How u go shoot me dis kin dart?

Aaaaah, wetin i do u?
So u wan turn me to jew?

Me i no go gree lai lai
Rotimy n Jollof yarn na so so lie.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 6:55pm On Mar 03, 2009
@ Maedan

Nne, na true talk say true love go find a way,
As things dey now, na for your love I go stay.
I no say other girls go try make I from you stray.
But I go shout am for nairaland say my love na for Maedan,
For cave or mansion,mat or gold waterbed, you be my Madam.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:03pm On Mar 03, 2009
meexteriox:

Maedan, you don wound my heart
How u go shoot me dis kin dart?

Aaaaah, wetin i do u?
So u wan turn me to jew?

Me i no go gree lai lai
Rotimy n Jollof yarn na so so lie.


No be by force dem de use open flower petal,
Men like you think say words go hard like metal.
But my peak milk Maedan dey soft because she be mortal,
Pls take easy dey yab me if you no wan see kolomental.




Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 7:08pm On Mar 03, 2009
for MEEXTERIOX

No be by force dem de use open flower petal,
Men like you think say words go hard like metal.
But my peak milk Maedan dey soft because she be mortal,
Pls take easy dey yab me if you no wan see kolomental.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 3:47am On Mar 04, 2009
una no go put me for trouble
make my oga no pack me out on d double
when e see dis thread
im two eye come red

now wetin i go say?
no be play we dey play? smiley
every1 get 'im portion
but dis don turn to forum of commotion  cheesy

abeg i no wan choose
who i go fit refuse?
but i no dey loose
n i no shack booze

but my head don dey turn
even my heart come dey burn
becos roty na my sweety
n meex na ma cutie

anyway na run i dey so
before alam go come blowww shocked grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 4:21am On Mar 04, 2009
rotimy:

@ Maedan

Nne, na true talk say true love go find a way,
As things dey now, na for your love I go stay.
I no say other girls go try make I from you stray.
But I go shout am for nairaland say my love na for Maedan,
For cave or mansion,mat or gold waterbed, you be my Madam.

roti, my papi
u don make me hapi
even tho' all na joke
i know say u be good bloke cheesy
wey fit make woman smile
n stick by am come rain or shine
but i hope say all d competition
no go make u run b4 completion
of dis post-valentyne weather
hope u know say, na 4 beta, 4 eva!!! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by meexteriox(m): 8:11am On Mar 04, 2009
@Rotimy
My broda no vex
I been just say make i flex
Na jealousy overtake me
But wait ooo, na so luv be?
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:38pm On Mar 05, 2009
meexteriox:

@Rotimy
My broda no vex
I been just say make i flex
Na jealousy overtake me
But wait ooo, na so luv be?

Dem say love go make you mad,
Even sef it fit make very very sad.
But we no be women we be correct men,
And we no go fight at all because of women.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 5:45pm On Mar 05, 2009
maedan:

roti, my papi
u don make me hapi
even tho' all na joke
i know say u be good bloke cheesy
wey fit make woman smile
n stick by am come rain or shine
but i hope say all d competition
no go make u run b4 completion
of dis post-valentyne weather
hope u know say, na 4 beta, 4 eva!!! cheesy

How you go come take say love na joke?
When my heart and liver for you dey choke?
Love wey dey true dey shak like orobo coke,
Which go make you have a smile for your look
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nobody: 5:48pm On Mar 05, 2009
Lol, beautiful concept. I'm liking it.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Moyola(f): 8:11pm On Mar 05, 2009
Some dem-too-sabi people dey see only doom,
Others wey say dem be money experts de halla gloom.
Dem de talk say the world economi dey meltdown,
Dat we no go see moni again to jolly for town.
But our bones dey strong and walai, we no go shake.
because de God Naijas dey serve no dey make mistake.
Me I know say De sun go shine again,
Wheather after de storm or de rain!!!
So make you no worry oh Mayola,
Things go get better from Lagos to Yola!

AwWwWWw!! kiss

M likin it wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 12:46am On Mar 06, 2009
rotimy:


How you go come take say love na joke?
When my heart and liver for you dey choke?
Love wey dey true dey shak like orobo coke,
Which go make you have a smile for your look


smile na my second name smiley
ever since we start dis game
yes i sabi say na play
n my heart fit break like clay
but i go try to dey stay
i promise i no go run away

make ur liver no choke o
or ur chest make i come stroke?
abeg o, i dey joke! cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:48pm On Mar 06, 2009
maedan:


smile na my second name smiley
ever since we start dis game
yes i sabi say na play
n my heart fit break like clay
but i go try to dey stay
i promise i no go run away

make ur liver no choke o
or ur chest make i come stroke?
abeg o, i dey joke! cheesy

Na like play play butterfly dey take enter bush,
We go turn play to fight if we give our love a push.
De day stroke go come bi de day you love me again,
Na dat I go shout say I no go love any Eve again!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:54pm On Mar 06, 2009
Moyola:

AwWwWWw!! kiss

M likin it wink

Just dey wait for like go soon turn to love!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 4:58pm On Mar 06, 2009
stillwater:

Lol, beautiful concept. I'm liking it.

Thanks o jare. We wan make stillwater of love run deep
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:41pm On Mar 06, 2009
rotimy:

Na like play play butterfly dey take enter bush,
We go turn play to fight if we give our love a push.
De day stroke go come bi de day you love me again,
Na dat I go shout say I no go love any Eve again!

how u go love any Eve, u be Adam?
no try anytin funny or our two head go jam!
jus keep ursef, our time go come cheesy
for we to tango one on one!




playin' as usual oooo

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)

The Sugar Mum (the Steamy Version) / Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 55
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.