Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,794 members, 7,806,198 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 12:54 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (40) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61040 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (37) (38) (39) (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 11:22am On Jul 25, 2011
like tinubu omo saka,
my people na so i take waka,
kuru' kere join fiki' faka,
i no follow anybody taa'ka,
even sef bone shenkes with dem heavy baa'ka,
ontop the hassle matter na im i dey kpai'ka!

grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:11am On Aug 03, 2011
chei, baby [size=14pt]hottie tima[/size],
very sweet lepacious mamma,
sey im other name na fatima,
but me can jus dey call am halima,
the matter wen she involve me no be small drama,
see how she been dey blow heavy grammer,
no do, no do i don begin to dey stammer,
yarn me say she be born again redeemer,
e no quick enter sey the baby be confirm scammer,
like beenie i begin to dey sing seem'a,
highness hook me onto say i don sign for parma,
forming skippo like mathias sammer,
i don see my own star to call ronaldo de lima,
pesin wey can fit fire down like karim benzema,
not knowing with scope she don obtain my beem'a
fall me mugu change my name to sheema,
small thing na im remain make she for nack my head hammer,
all the way from V.I lef' me with kpa'kain for wilmer,
as i siddon so, i don dodo like joseph the dreamer!


grin grin grin grin grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by HotieTima(f): 11:23am On Aug 04, 2011
wink wink wink wink wink wink wink grin grin grin grin grin smiley smiley smiley smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 9:49pm On Aug 18, 2011
RuuDie:

chei, baby [size=14pt]hottie tima[/size],
very sweet lepacious mamma,
sey im other name na fatima,
but me can jus dey call am halima,
the matter wen she involve me no be small drama,
see how she been dey blow heavy grammer,
no do, no do i don begin to dey stammer,
yarn me say she be born again redeemer,
e no quick enter sey the baby be confirm scammer,
like beenie i begin to dey sing seem'a,
highness hook me onto say i don sign for parma,
forming skippo like mathias sammer,
i don see my own star to call ronaldo de lima,
pesin wey can fit fire down like karim benzema,
not knowing with scope she don obtain my beem'a
fall me mugu change my name to sheema,
small thing na im remain make she for nack my head hammer,
all the way from V.I lef' me with kpa'kain for wilmer,
as i siddon so, i don dodo like joseph the dreamer!


grin grin grin grin grin
2 guud,
2 huud,
2 ruud,
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 12:01am On Aug 19, 2011
Oreoluwa

She was only seven. . .
Starry eyes bright
Like the tinted heavens

Four digits shoved I remember
Into that bitty mouth
She stared at me with wonder
Whilst I gently tugged
Her fingers out

All that energy
Whilst greeting me
For such a small being
Almost knocked my 5"10 frame over
Right down to my knees

Like Armaggedon she glomps
With signature finger chomps
And demarara sugar eyes
With childish gummy smiles
Oh does she
Reminds me

Of me. . .

Oremi
My baby

You will be in my heart
Sleep my baby
Till when we'll ne'er depart

I hope I see these Last Days through
And I know how your parents love and miss you

I now gaze to heaven
Oreoluwa,
You were only seven.
cry cry cry cry cry cry cry cry cry

cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry
cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry cry
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:00pm On Aug 19, 2011
When i read what firestar wrote
i knew OreOLUWA had gone out of d note,

evnthough i dnt knw u,
we ar al human beings nt ewe,
OreOluwa u av gone too soon,
i wonda wu mummy wuld tel story wen she sées d moon,
ha! Ha! Ha! What a doom,
at 7 she just go lyke zoom,
e pain me wella 2 dey c smal pikin die witout a clue,

mummy Oreoluwa abeg no think am,
just pray 2 God and stay calm,
ore,anytin wey dem dey chop 4 heaven na e make u chop even if na yam,
death wetin u du no gud,abeg go 2 dam!

R I P! OreOLUWA

1 Like

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 9:39am On Sep 08, 2011
dis thing e ben-ben as to head of spoon,
& some kain time e fit make man pikin belle burst like balloon
na una matter make i dey halla for here like baboon,
sake to say i no gree get the kain voice wey oyinbo dey call croon,
so e no get how i go fit sing like loon,
abegi no laff cuz dis no be tom & jerry cartoon. . . . .
all those wen don kpeme too soon,
na for baba God right hand una go tanda dey shine like moon!

***Dedicated to all those who are gone too soon - RIP from RuuD to U!***

sad
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 1:36pm On Nov 12, 2011
[size=17pt]Make I hear word jare
sad
The guy get mouth
shocked
The babe get flow
cool
God sef bless dem with Gbedu
wink
Una get beef and seafood. . .?
tongue
Wo~
angry
For ma side yawa no go gas
And lagbara Olorun,
Alarm no go blow!

*********************
Happy Married Life to Ma Fersona Feefle.
OooooooooooooooooooShe! wink
[/size]
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 10:35am On Dec 12, 2011
remain small to nearly near,
e don almost reach,
dat time wey we dey mark ontop the year,
when as d bible been preach,
say papa God luv us die sotey e call all we "my dear",
send 'im only pikin with ogbo'nge lesson to teach,
as we go fit take do so dat Him and Us, we go near
and we matter no go come wide like post for football pitch,
to open we eye and ear make we no fear,
sotey wash all our bad-belle comot like parazone bleach,
comot all those nyama'nyama wey deve mount so we road no clear,
being sey as na only Him get beginning and end, plus poor, plus rich,
'im follow come tell us make we no cry not even 1 single tear,
and all those wey dey turbo go hell-fire before go mash brake screech,
fit sharply enter reverse begin fire down to the only 1-is-1 Baba wey care.

grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 12:52pm On Dec 12, 2011
baby if u no love me dis christmas alarm go blow,
d matter now ehn, e don pass sey I no know,
January to November I dey drop the flow,
Morning to nite I dey tender d doe,
now e don reash to reap wetin i been don dey sow,
see as u dey sharp eye find where to dump me throw.
blind man gan sef sabi sey white na color of snow
and cashew not ontop of palm tree e dey grow,
I dey look u since I no wan show,
sem'pe dey watch as u dey form pa'row,
u think sey maga go pay finish cock no go come crow,
yawa go soon gas so ya brain betta grow,
before ya case become dat of motor wey LASTMA tow.

grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 2:38am On Dec 16, 2011
Hmmm,kere kere xmas don near,
nxt week make we put mouth down dy chop chicken we rear,
if u lyke make u dy du horse play,
just knw say we don dey -emba so make u knw ur way
if u dy drive abeg no drink,
nd if u wan die abeg no shrink,
4 diz xmas no torey
na njoyment galore 4rm grax 2 glory,
nobdy fit stop me 2 no celeb78,
even u no fit coz u go just peme str8t!
Abeg make i wish gud pple gud tin
Merry Xmas nd Happy New year,just dont touch dat tin! :d
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by RuuDie(m): 5:46pm On Dec 16, 2011
Adebayo Baba u too much,
I swear u correct pass BB torch,
na only wise man like u fit reason such,
xmas like dis some dey forget to enter church,
wen dem don use enuf shayo wash d lunch,
na to dey fire acelerator no look brake or clutch,
some sef no dey even open eye to watch,
b4 dem soji sey ya'wa do gas na 4 inside crutch.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 5:32pm On Dec 25, 2011
Many b landlords 4 cementery,
many b tenants 4 inside montuary,
even 4 igbobi we get candidates 4 obituary,
but 4 we 4 nairaland,stil worshipin God in His sanctuary,
He done dy watch us since January,
His guddu guddu news don pile up 4 we diary, we even dy drink cow milk witout goin 2 factory,
Baba God no even colect kobo let alone salary,
4 diz christmas nd as new year dy approach,abeg praise am daily.
Walahi u get mouth Baba God!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:20pm On Jul 27, 2012
jejeli i enta here lyk Jelili
i search 4 all dem my padi
Ruudie? Firestar? an odas where una dey?
make una no let dz thread go lyk John Dede.
Rotimy no which am luk diz
make we come back do am lyk say na biscuit.
evnthough i knw say me self dey affected
bt no mata d yawa we ni 2 dey corrected!
shet una dey get me lyk dez?
hope say i no dey yarn luk lizzi?
time no dey my side.
c u on dat side
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by Nebulae: 7:40am On Nov 11, 2012
Na tru u talk
E don tey
E be like say
Di katakata wey grip
No be just today
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 12:28pm On Dec 10, 2012
Nebulae: Na tru u talk
E don tey
E be like say
Di katakata wey grip
No be just today


. . .
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by firestar(f): 7:01pm On Dec 10, 2012
... sad
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 9:55pm On Jan 03, 2013
hmmmm.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 1:34pm On Jul 08, 2014
grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by SHAKABOOM: 8:57am On May 31, 2017
Joecoollorenzo:
@vavavoom

na wa o, to dis ur name vavavoom

na u b d twin of shakaboom?

E b like sey u over like futuball

e gud as u dey relate to we all

u bin dey play wit my name
i believ sey dat name go bring me tikini fame

wel make i put waka 4leg
i no wan wake up wit eye like egg

gudnyt 2u vavavoom
as i zoom into d room
Hahaha! Am called Shaka boom cos of my luv for pump action. grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by adebayo201: 7:07pm On May 31, 2017
this thread??
grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by literatus67(m): 2:13am On Jul 07, 2019
yonder is asunder, as a piece of writing discuss in a great length our millions of thoughts towards our responsibilities, ambition and patriotism to our country, which are epileptic and so unable to see any light of reality, because, we believe someone from somewhere will rise and do them,
also, the poem serves as call of duty to our dead mind, calling us to stand and do that thing that is needed to be done.

(1) (2) (3) ... (37) (38) (39) (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.