Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,852 members, 7,806,410 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 04:00 PM

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Some Funny Warri Parables - By Rapmoney (3149 Views)

Some Funny African Proverbs That You Don't Know (must Read) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(m): 9:25pm On May 31, 2015
Here are some funny Warri parables to spice you up cheesy Warri nor dey carry last, if e too mush...abeg, make we leave story for Crown Fm grin grin

1. No matter how nyash make yanga reach, leg go still first am enter house grin

2. Pikin wey dey look for cry, deh nor dey push e head (deh go say na u beat am) grin

3. Goat know say the waka waka wey dey dis life plenty well well, na e make am wear shoes come life cheesy

4. Tortoise know say house rent cost too much, na e make am carry e own house come life grin

5. Snake wey say na tortoise back e wan bite, na toothache go kill am.

6. Difference dey between bathroom and baffroom. If ur soap fall for baffroom, u nor dey pick am again grin

7. Deh dey call names of sickness, craw-craw still dey smart dey raise hand up grin

8. Madam bring Rothmans, madam bring Rothmans, na e Papa Obakpororo mouth take turn exhaust pipe.

9. Na legbere (weak man) na e dey run go house go pull shirt if deh find e trouble for outside.

10. When guy man dor fvck-up, e go use shame talk say na e style be dat

11. Small pikin wey say na e papa e wan carry for shoulder (akoko), na big blokos go surffocate am grin

12. Oga, na im first slap me, na im first slap me...na because police never enter the matter cheesy

I will post more as they come to mind...

U can add urs cheesy
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Yawgawlfriend(f): 9:32pm On May 31, 2015
Observing..
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(m): 9:33pm On May 31, 2015
Yawgawlfriend:
Observing..
Observe very well o! grin
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Yawgawlfriend(f): 9:38pm On May 31, 2015
Rapmoney:
Observe very well o! grin
alright.
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Vikta10(m): 10:03pm On May 31, 2015
8. Madam bring Rothmans, madam bring Rothmans, na e Papa Obakpororo mouth take turn exhaust pipe.
11. Small pikin wey say na e papa e wan carry for shoulder (akoko), na big blokos go surffocate am
LOL! gat me cracking

1 Like

Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(m): 10:18pm On May 31, 2015
Vikta10:
8. Madam bring Rothmans, madam bring Rothmans, na e Papa Obakpororo mouth take turn exhaust pipe.
11. Small pikin wey say na e papa e wan carry for shoulder (akoko), na big blokos go surffocate am
LOL! gat me cracking
Yeah, how we roll in warfi cheesy
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(m): 10:34pm On May 31, 2015
Na wa o! 49 views, 6 comments only? grin E be like say pipo for culture section nor get joy again o! grin Abeg, bigfrancis21, Fulaman198, odumchi, make una move am go front page or Jokes section kpa kpa! grin
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by hpk(m): 9:06am On Jun 01, 2015
pikin when rush get bald head, na headache go kill am.
na where ground no dey na hin two people dey drag who run pass.

1 Like

Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(m): 10:13am On Jun 01, 2015
hpk:
pikin when rush get bald head, na headache go kill am.

na where ground no dey na hin two people dey drag who run pass.
Kai! Ur head dey there I swear grin
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Begonia(m): 12:27pm On Jun 01, 2015
grin grin
They're funny but I don't understand these two.
7. Deh dey call names of sickness, craw-craw still dey smart dey raise hand up.

8. Madam bring Rothmans, madam bring Rothmans, na e Papa Obakpororo mouth take turn exhaust pipe.
Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by pinkycute(f): 12:40pm On Jun 01, 2015
grin grin grin
grin grin grin

1 Like

Re: Some Funny Warri Parables - By Rapmoney by Rapmoney(m): 12:44pm On Jun 01, 2015

(1) (Reply)

Wainaabe Fulbe Hirnaange Africa Mi Noddi On Hande / Who Really Is ODUDUWA? / If A Child Fall From Her Mother's Back Is It A Bad Omen?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.