Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,303 members, 7,808,030 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 04:32 AM

Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! - Culture - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Culture / Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! (612 Views)

Owe Ile Yoruba -some Lovely Yoruba Proverbs And Their Meanings. / 30 Nigerian Pidgin Proverbs / Some "Super-lovely" And Hilarious Yoruba Proverbs You Would Love To Know (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by chychyobbi(f): 6:17pm On Sep 27, 2015
So, since today is Sunday, I think we should take a good 'ole time to enjoy some African proverbs in pidgin english. Below, are the few compiled so enjoy and add yours after reading!

1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.

2. Woman wey never see problem...na im dey still hold breast run.


3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later é go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay boiled egg.

7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

8. Pikin wey him mama back cross water, wey say him match fish, wetin him mama go match?

9. Small pikin wey dem carry for back no know say the journey far.

10. Person wey don faint before no be stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye enjoy
sex she dey enjoy labor pains. 13. Yansh no get teeth but e dey cut shit.

14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody hail am!! é go hail himself

15. Toto water small, but é reach prick take baff.

16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.

17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

18. Na cricket tell him children say, No matter how ground strong, Them no go sleep outside.

19. Pikin wey say him mama no fine they use style call him papa blind man.

20. No be eye wey dem take chop eba dem take dey share meat.

21. Person wey use Elephant set trap, na him know wetin he wan Catch.

22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.

24. Dem no dey tell tortoise say race don start.

25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for food.

26. Before you see monkey, monkey don see you.

27. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.

28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell am say him sabi bury. 29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.

30. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.

31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am. 32. My thing and our thing no be the same oh.

33. Na happiness dey make prick stand.

34. Na as goat stand for market dem dey price am.

35. Craze no hard to form, na the trekking be wahala.

36. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

37. No matter how hot your temper be, e no fit boil beans. 38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still end up inside pot of soup.

39. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrapper.

40. Akara and moin moin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.

41. Nama wey run go overseas go come back as corned beef

I can't stop laughing, Oya add your own!

http://www.chichinwaafrica.com/2015/09/sunday-reasoning-time-for-some-mega.html

Re: Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by maryam6(f): 6:26pm On Sep 27, 2015
grin grin grin
Laugh wan tear my bele o.
Re: Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by Mutuwa(m): 6:29pm On Sep 27, 2015
maryam6:
grin grin grin

Laugh wan tear my bele o.

Talk tru..
Re: Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by maryam6(f): 6:37pm On Sep 27, 2015
Mutuwa:

Talk tru..
yes na, bt this ur moniker get as he be o.
Re: Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by Nobody: 6:52pm On Sep 27, 2015
Collection of senseless words
Re: Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by ChiSun27(m): 6:52pm On Sep 27, 2015
That no. 30 tho.... grin
Re: Sunday Reasoning: Time For Some Mega Pidgin Proverbs! ENJOY! by Mutuwa(m): 8:39pm On Sep 27, 2015
maryam6:
yes na, bt this ur moniker get as he be o.

No fear..u would have to face my moniker anytime in.I wish you long life tho..
But always think of me.. grin

(1) (Reply)

Mentalities About Big Girls / YBNL UK Concert! Over 5000 People Singing Yoruba Songs For Hours! / Gedmatch Puntdnal African Only - PLEASE Help. Who AM I??

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.