Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,866 members, 7,802,797 topics. Date: Friday, 19 April 2024 at 09:43 PM

Hilarious Pidgin Proverbs: - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Hilarious Pidgin Proverbs: (2845 Views)

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / Hilarious Pidgin English Proverbs And Their Meanings / See This 29 Hilarious Pidgin Proverbs(funny) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Hilarious Pidgin Proverbs: by izuch(m): 11:07am On Apr 30, 2016
1. Na for old age ashawo dey know the value of pikin.

2. Na Woman wey never see problem dey still hold breast before she run.

3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant
sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go
hear am.

5. Na for afternoon dem dey find black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay
boiled egg.

7. Small pikin wey dem carry for back no know
say the journey far.

8. Person wey don faint before no be stranger to death.

9. Person wey chop belle full, no know wetin hungry man dey see.

10. No be as woman dey close eye enjoy sex she dey enjoy labour pains.

11. Yansh no get teeth but e dey cut shit.

12. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.

13. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.

14. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.

15. Pikin wey say him mama no fine they use
style call him papa blind man.

16. No be eye wey dem take chop eba dem dey
take dey share meat.

17. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.

18. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS, BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.

19. Before you see monkey, monkey don see you.

20. Thief wey jump fence enter house where owner dey wait for am, no go jump again.

21. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im dey kill am.

22. If e be like say everybody dey craze" na you dey craze.

23. Meat wey you dey forbid, no use your teeth cut am.

24. My thing & our thing no be the same oh.

25. Na happiness dey make prick stand.

26. Na as goat stand for market dem dey price am.

27. Craze no hard to form, na the trekking be
wahala.

28. Its a small world!! No mean say you fit trek from Naija go London.

29. Akara and moin moin get the same parent, na wetin dem pass through make dem different.

Copied.

Feel free to add yours.

3 Likes 1 Share

Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by LouisBERG: 11:08am On Apr 30, 2016
This is damn hilarious.. Lwkmd

Ok let see if i can add also

30) pikin wea say em mama no go sleep em too no go sleep

31) person wea dey cry they see road

32) monkey no fine but em mama like am

#caLLmeBERG

1 Like 1 Share

Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by ExplicitContent: 2:47pm On Apr 30, 2016
Person wey naked no fit put hand for pocket
Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by ExAngel007(f): 2:58pm On Apr 30, 2016
funny
Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by skinz(m): 8:19pm On May 08, 2016
No wen mosquito land for your balls na dat time you go know sey violence no be everything

1 Like

Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by Akinsame: 10:46pm On Apr 12, 2022
grin shocked cool The mouth wey dog take dey play, na hin e go take bark grin cool The mouth wey dog take dey play, na hin e go take bark
Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by izuch(m): 3:16pm On Apr 14, 2022
Following
Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by nnanna69(m): 4:36pm On Apr 14, 2022
NairaLand Get Like and Share no mean say Na Facebook.
Re: Hilarious Pidgin Proverbs: by eedhrisademola(m): 12:22am On Apr 20, 2022
nnanna69:
NairaLand Get Like and Share no mean say Na Facebook.
GBAGAUN!!!

(1) (Reply)

American Tv Remote Vs Nigerian Tv Remote / Which Is Preferable / Bros Leave My Something Na!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 15
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.