Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,317 members, 7,808,069 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 06:35 AM

Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! (3402 Views)

Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. / Nigeria Pidgin Proverbs / Some Common Nigerian Pidgin Proverbs (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by Tolulopefinest(m): 10:04pm On Feb 19, 2017
Man wey Unclad no dey put hand for pocket

loose translation:You can't do somethings if there are no certain conditions.


Chicken wey run way from borno go Ibadan go still end up inside pot of soup

loose translation:You Can't Run Away From Your Destiny


Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap

loose translation:Keep calm! Nothing last forever


Cow wey dey in a hurry to go America go come back as corn beef

loose translation:Just be patient. Let the game come to you. Don't rush!


Akara and moin moin get the same parent na wetin dey pass tru make dem diffrent

loose translation:How you start doesn't matter,what matters is how you finish.


Wetin consign agbero with twitter handle,or malu/cow with face cap?

loose translation:Mind your business.



If life dey show you pepper,my guy make pepper soup from am

loose translation:Make something good out of a bad experience



I get am before No be property

loose translation: stop living in the past and start living in the present.



If person too tey for party e go follow dem wash plate

loose translation:Don't outstay your welcome



Rolling stone,ofcourse na person push am now!

loose translation:There is always a reason for something



Craze no hard to form,na the trekking be wahala

loose translation:Easier said than done



No matter how hot your tempa be,e no fit boil beans.

loose translation:Calm down,your temper won't solve the problem



Every mallam with em own kettle,every aboki with em own radio.

loose translation:Every man for himself



You no need cutlery to chop slap

loose translation:You don't need my translation to understand this,lol



Opolo eye no be open eye

loose translation: Having Big eyes doesn't make you civilised,lol



Leave matter for Mathias and Sabi for Sabinus.

loose translation:Give everyone what they deserve.



Bring suya, bring suya,.......na cow body dey suffer am.

loose translation:Every action has a consequence



E go better e go better,na im make ibo man still dey Kano

loose translation:When there is hope,there is Life.

The different between kpekere and plantain chips na packaging
loose translation:Don't judge based on appearance alone

Escort me, Escort me, naim slave trade take start.

loose translation:Serious things sometimes start like joke



[b]Na from play play dem dey form PLAYER

loose translation:Serious things sometimes start like joke


Pikin wen use agbada take stat guy go talk wetin e go wear wen e old.

loose translation:Slow and steady wins the race



The water wey dem use take make eba can never be recovered back.

loose translation:Don't cry over spilt milk
Which is your favourite?

1 Like

Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by Justycxx(m): 10:14pm On Feb 19, 2017
Monkey sabi jump na tree near tree

nothing spoil for mad man body, na only im head

1 Like

Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by harlems02: 10:27pm On Feb 19, 2017
Nor be eye wey dem take chop eba dem dey take dey share meat.

1 Like

Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by Tolulopefinest(m): 10:36pm On Feb 19, 2017
harlems02:
Nor be eye wey dem take chop eba dem dey take dey share meat.


Lol

Wetin be the meaning of this o?
Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by Tolulopefinest(m): 10:37pm On Feb 19, 2017
Justycxx:
Monkey sabi jump na tree near tree

nothing spoil for mad man body, na only im head

HmmHmm wink
Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by princefunmmy(m): 11:08pm On Feb 19, 2017
Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by rymesgentility(m): 11:23pm On Feb 19, 2017
No good tin wey u do to a bicycle man , make he no show u yash before he go,

No mata wetin u do to a bad person he go still no show appreciation



Dem no dey tell old woman mk she close her leg coz u no knw were she from dey collect air.
Re: Funny Nigeria Pidgin Proverbs And Their Translations..... Add Yours!! by Tolulopefinest(m): 10:31pm On Feb 20, 2017
rymesgentility:
No good tin wey u do to a bicycle man , make he no show u yash before he go,

No mata wetin u do to a bad person he go still no show appreciation



Dem no dey tell old woman mk she close her leg coz u no knw were she from dey collect air.



kiss cheesy

(1) (Reply)

Burantashi De Work Oh! / She And I / 29 Beautiful Girls Trying To Be Ugly (hilarious Photos)

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.