Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,632 members, 7,801,822 topics. Date: Friday, 19 April 2024 at 12:41 AM

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs - Jokes Etc (2) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Some Common Nigerian Pidgin Proverbs (92079 Views)

Pidgin English Proverbs. Add Yours... Don't Spoil The Fun. / Some Nigerian Pidgin Proverbs / 8 Nigerian Pidgin Words That You Probably Did Not Know Are Proper English Words (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (Reply) (Go Down)

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by toseen7: 1:35pm On May 05, 2017
Na for night dem dey find white goat.. grin

1 Like

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Philadelphia: 1:42pm On May 05, 2017
I no fit climb, na for ground dem dey talk am.
Monkey smart monkey smart a because say tree near tree.
E go better E go better na wetin make igbo man still dey Lagos.
Na for clap dem dey take enter dance.
Na say mouth dey smell dey make person dey talk small small.
Person we wear shoe Na him know where stone dey.
No be today yansh dey back.
Dem no dey beg poo to smell.
I no play again Na wen cry don start.


I'm gonna give more after close of work today.

5 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by okpukpu(m): 1:45pm On May 05, 2017
Dem no dey use big prick intimidate ashawo.

Toto water no deep but e reach make prick take bath.

2 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Guyman02: 1:49pm On May 05, 2017
Many of them were adapted from Igbo and Yoruba proverbs.

2 Likes 1 Share

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 1:50pm On May 05, 2017
Abeg no use oil take rub my mouth for yam wey i no chop..


Dem no they use old age they learn left hand.

3 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by jonero4(m): 1:50pm On May 05, 2017
No be today yansh begin dey for back

Y u go fvck ashawo pay am, na because of tomorrow

Na from mess you go take know how the sheet go sweet

Old woman say, no be wetin pri*ck dey fvck am dey vex am,, na wetin d ballz dey nack am.

Fowl say, no be how hen dey fvck am outside dey vex am,,, na d mouth wey hold am for head

1 Like

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Rainmaker69(m): 1:52pm On May 05, 2017
Lugubrious! Simply lugubrious!
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by bigsmoke2(m): 1:58pm On May 05, 2017
Woman wey Don born no dey fear pęnis

dem no dey tell mad man say rain dey fall

Pesin wey dey find wetin no loss go find wetin e no dey look for
body go tell you
fish wey never enter pot of soup no dey believe say warta fit betray am
you go hear am you go testify

If you wan follow devil chop your spoon must long we we

If life show u pepper u go make pepper soup

4 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Ekpekus(m): 1:59pm On May 05, 2017
Nor be who first go police station dey win case
Gidigidi dey tear trouser
To get big teeth nor be problem but get big lips to cover am.
Know your way nor be curse
Dem nor dey open eye dey cut shakri for pepper soup
Dem nor dey fear malu, dey fear e sh*t O
Rain nor dey fall for only one person dormot
Dem nor dey tell craze man say war don start
Fowl wey dey lay egg, yansh dey pain am too
Headmaster was once a school boy (my papa favorite, especially when you wan scam am grin)

7 Likes 1 Share

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by imurboss: 2:00pm On May 05, 2017
When e reach for shit to come out, yansh go open

2 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by tutudesz: 2:09pm On May 05, 2017
Pikin no they measure prick with him papa

3 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by KingOfThePay(m): 2:12pm On May 05, 2017
'' Instead of say make Actor die for film Nepa go take light. '' grin


Listen to Erigga songs and entertain yourself with good pidgin proverbs, metaphors and punchlines.

5 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Jonbold(m): 2:15pm On May 05, 2017
MykOnyxo:
Omo ti o ni iya ki n dobo eyin...
Pikin wey no get mama no dey doggilitate
Receive sense in Jesus name
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Rheality: 2:17pm On May 05, 2017
Monkey too smart na because tree near tree.

dis one na my own, dat one na my own naim make crase man get plenty property.

dem no dey carry ordinary eye join white garment church.

3 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nwanieke(m): 2:23pm On May 05, 2017
Pikin wey say him mama no go sleep, him sef no go sleep
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by timmydahpeace(f): 2:42pm On May 05, 2017
xtera27:
Owk ooo
.....na only Calabar weed dey kill person like this...that calabar weed badt ehn?

1 Like

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by R3m0t3C0ntr01(m): 3:03pm On May 05, 2017
Na better sense dem dey take kill mosquito wey land for person Blockos

3 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by khadaffi(m): 3:04pm On May 05, 2017
@NLban add this one to am.
Ogogoro and water get the same colour but no be the same taste

2 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Asiwaju9ja(m): 3:09pm On May 05, 2017
Water when touch prick don touch Brokos
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Cloetrish(f): 3:17pm On May 05, 2017
Na frm escort me escort me na e slave trade take start

2 Likes

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Trexnemesis(m): 3:19pm On May 05, 2017
Di pesin wey go, na im dey come back.
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Trexnemesis(m): 3:27pm On May 05, 2017
To tolotolo wey dey chop onion, im dey prepare imself for cooking pot

1 Like

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by darlenese(f): 3:37pm On May 05, 2017
Nor be today Yansh dey back!


Okporlor Eye nor be open eye,
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nobody: 3:40pm On May 05, 2017
Jonbold:
Receive sense in Jesus name
Apoda
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Nowenuse: 3:43pm On May 05, 2017
Dem nor dey fucck ashawo two times say you nor pay money
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by ncoolsome(m): 3:55pm On May 05, 2017
Na small shit dey make yansh smell..
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by heenriiy19(m): 4:02pm On May 05, 2017
Pikin Wey talk sey him mama no go rest him too no go rest
Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by benjamin007: 4:05pm On May 05, 2017
Who dey sell pepper now dey carry scratch Gbola

1 Like

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by kadree(m): 4:23pm On May 05, 2017
Even inside darkness, person nor dey mistakenly put eba for nose.

2 Likes 1 Share

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by Prefola: 4:44pm On May 05, 2017
The fact wey b sey person chop banana no make am monkey...

1 Like

Re: Some Common Nigerian Pidgin Proverbs by maxilly(m): 5:22pm On May 05, 2017
Jaguda get oga

3 Likes 1 Share

(1) (2) (3) (Reply)

After Kissing My Girl On Valentine's Day This Is What I Got This Morning .pic / See What Happens When You Mistakenly Shout Sai Baba In A Fuel Queue(pic) / The Face Your Mum Makes When The Pastor Calls Out All Virgins In Church.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 17
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.