Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,143,247 members, 7,780,497 topics. Date: Thursday, 28 March 2024 at 03:35 PM

Dem Don Discover New Kidnappers, Ritualists Den Beside Ondo State House Of Assem - Crime - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Crime / Dem Don Discover New Kidnappers, Ritualists Den Beside Ondo State House Of Assem (349 Views)

Ritualists' Den Uncovered In Celle Nica, Lagos. 'Mad' Woman's Phone Call.... / ”How My Ringing Tone Saved Me From Ritualists' Den In Lagos” – Man Reveals / Ritualists Den Uncovered In Afon, Kwara State (Photos) (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Dem Don Discover New Kidnappers, Ritualists Den Beside Ondo State House Of Assem by Joyakosa(f): 11:57am On Jun 27, 2017
Dem don discover one uncompleted two-storey building wey people dey suspect sey e fit be hideout for kidnappers and ritualists on Monday for Alagbaka area of Akure, Ondo State capital.

The building no too far from Ondo State House of Assembly and e dey behind the popular government-owned events centre, Gani Fawehinmi Arcade, wey be sey na one retired civil servant for the state, na em get am.

Na people for the area na dem discover the building sey dem dey always see sey some men dey always enter their every time dey do one kain thing wey people no know.

One person for the area, yarn Punch say dem don abandon the building for a very long time and nobody know the owner.

He explain say one security operative wey dem wey dey secure one of the building for the area shoot one bird wey dey ontop one tree beside the building wey ritualist dey use.



As dem hear the gunshot, some hoodlums wey dey inside the building just rush come out kon run as dem think say na police.

One source wey yarn ontop the matter talk say,

“The suspects thought the gunshot was from the policemen who came for them. They quickly rushed out, but some commercial motorcycle riders in the area helped us to chase and arrest four of them, whom we later handed over to the police.”

The source talk say na policemen save the suspects as people almost beat them.

For inside one room of the building so, na different items of clothes, women underwear, sandals, slippers and cooking utensils na em scatter for there.

Also, one long rope also dey inside one of the rooms wey dey the building. Dem tie the rope to the ceiling of the building as dem kon tie the other end with different planks under the rope.

People dey suspect sey dem dey use the rope dey hang their victims.

The Ondo State Police Public Relations Officer, Mr. Femi Joseph, wey confirm the matter yarn say

He say,

“We have arrested quite a number of them and we are currently interrogating them. It is after the interrogation and investigation that we can conclude whether they are ritualists or not.”

He no yarn the number of people wey dem arrest but he sey dem go charge dem to court very soon.
source:http://www.joyakosacorner.com/dem-don-discover-new-kidnappers-ritualists-den-beside-ondo-state-house-of-assembly

(1) (Reply)

UK Declare Nigerian Most Dangerous Prisoner / Discovered The House Of A Scammer Who Scammed Me, Whats Best To Do? / PHOTOS: RRS Nabs Two Cable Thieves, Including A Grandfather-of-three

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 12
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.