Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,752 members, 7,806,065 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 10:54 AM

BBC Pidgin: President Buhari Go Visit Igboland For Di First Time Since 2015 - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / BBC Pidgin: President Buhari Go Visit Igboland For Di First Time Since 2015 (480 Views)

Many Nigerians Actually Don't Know that Nelson mandela Hid In Igboland For years / Ganduje: BBC Pidgin Makes Jest Of EFCC, Nigeria's Anti Corruption Agency / Nigerians Hold Vigil In Front Of Abuja House, London, Chant "Buhari Go Home" (2) (3) (4)

(1) (Reply)

BBC Pidgin: President Buhari Go Visit Igboland For Di First Time Since 2015 by sinkhole: 6:43pm On Nov 14, 2017
Nigeria President Muhammadu Buhari dey visit di south east region of Nigeria for di first since 2015 when im siddon inside office as president.

Ebonyi state na di first bus-stop for di presidential team, before dem go enter other states wey include Anambra for dis two-day visit.

All dis one dey happen even after di Indigenous People of Biafra (IPOB) warn di special visitors say dem go scatter dia plans.

IPOB na group wey dey push for separation of south east region from Nigeria: dem wan use all dis one take start new country dem dey call 'Biafra.'

Nigeria military don declare say na terrorists dem be and dem go fight dem fire for fire.

President Buhari no too popular for south east region; na for here im collect di smallest number of votes during di 2015 presidential elections.

President Muhammadu Buhari go do meeting with politicians and traditional leaders for di region to discuss di way forward.

Government talk-talk person, Mr Garba Shehu, say President Buhari go show for di ruling All Progressive Congress (APC) party campaign rally for di Anambra state governor election.

Di election go happen on 18 November 2017, according to di timetable from di Independent National Electoral Commission (INEC).

BBC tori person Ishaq Khalid dey report say security dey very tight, and extra police full ground because of dis visit.

Dis na because of di tension wey don dey for months now because of di breakaway movement from groups like IPOB, and di different things wey dem dey do.

Meanwhile, Nnamdi Kanu, di leader of IPOB, don vanish since di Nigeria military raid im house for September.

But di military don say dem no see Mr Kanu arrest.

more tori dey: https://www.bbc.com/pidgin/tori-41980050
Re: BBC Pidgin: President Buhari Go Visit Igboland For Di First Time Since 2015 by hisgrace090: 6:54pm On Nov 14, 2017
I know it takes too much courage for pmb to step his toe on igbo land because the stench of haterade oozing out of here is alarming.

I wish him a happy welcome to my land.

(1) (Reply)

Anambra: Obiano’s Security Aide Restored As Buhari Campaigns For APC / 2018 Budget: President Buhari To Spend N4.8bn On Villa Cleaning & Maintenance / Inflation Drops To 15.91% – Nbs

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 10
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.