Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,136 members, 7,807,453 topics. Date: Wednesday, 24 April 2024 at 01:43 PM

Moomsi Mi - Family - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Family / Moomsi Mi (312 Views)

Help Mi Vote Baby Jessford / Help Mi Pay My Sch Fee By Ordering For Ma Product.... (2) (3) (4)

(1) (Reply)

Moomsi Mi by lalaponcus(m): 1:54pm On May 13, 2018
MOOMSI MI by Bashorun

Wey sabi me wey love me well
Wey buy me two pako teddy bear
Come tell me say 'omo nor fear'
Moomsii mi

Make I no lie nnè m too try
Saturday morning akara dey fry.
She dey pet me when I dey cry
Moomsii mi.

Miile I salute ur govment.
Ko Iye I love your antecedent
Mama mi your sweet pass condiment.
Moomsii mi.

I no go lie say I no chop slap.
Better one wey sound like thunderclap
All of dem save me from future trap
Moomsii mi.

E be like say Range go too small
To buy mama for wetin I dey recall.
After all, who fit forget all those Health 4 ball?
Moomsii mi.

Who get ear make im hear my voice.
Make ya life beta with godly choice
Your mama suppose dey make you rejoice.
Moomsii mi

Make I no forget paale wey sure
Dat man get eye marry woman wey pure.
I dey pray make my woman be cure.
Like Moomsii mii

Dedicated to all mothers especially Iya Bashorun.

(1) (Reply)

Being Real To Your Spouse / Busy Mum Hacks For Fast Healthy Children’s Meals / The Power Of *i Am Sorry*

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 5
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.