Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,148,895 members, 7,802,878 topics. Date: Saturday, 20 April 2024 at 01:06 AM

Are U A House Husband? - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / Are U A House Husband? (964 Views)

See What Some Boys Are Doing To A Lady Inside A House Party (photo) / Any Guy Who Doesn't Have A House And A Car Should Not Get Married Or Even Date! / Should A Man Live In A House Built By His In-law? (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Are U A House Husband? by Nobody: 12:01am On Oct 21, 2011
For those of una wey no know wetin house husband mean e mean say a married bobo or boyfriend wey go dey house 24/7 while im wife or girlfriend dey outside dey work.Na these type of bobos go dey house wash plates,clean the kitchen,bath the pickin while im wife dey hustle for outside.Na also this type of bobo im wife go send on domestic errand go market and the bobo go bring wetin im buy for market to prepare am for house while im wife go dey sitting room dey watch home video and dey drink small stout.Na also this type of bobo wey dem dey refer to as house husband na im wife go slap in the presence of her friends if im no prepare the food well.Some of these bobos wen u ask them why dem dey act like tht na dem go tell u say na so modern couples suppose to behave.Dem go let u know say oyibo man na im dey cook and clean the house for im wife so there4 they themselves must act like the oyibo man because na the civilised way of life be that.I remember this guy wey i visit and as we come dey discuss for kitchen na im one of the plates wey the bobo dey clean come break into pieces wey fall frm im hand by mistake.Omo come see as im wife rush into the kitchen from the sitting room like express train come wuzz the bobo three dirty slaps across the face gbosa! gbosa!! gbosa!!! grin grin grin grin.Me sef i just open mouth dey watch the drama as e dey unfold and the funny thing of it all is tht the bobo no say anything after the wife don chop am the slap.The wife come tell me say make i comot from her house and the bobo no dare say anything.I just shake my head waka comot from their house dey ponder on the issue at hand.Wetin i come see for this matter be say most of these bobos wey be house husband get no say for the house because na the woman dey make the money and if dem dare say anything the woman fit hook her foot inside their yansh throway dem from the house grin.Some my guys any of una wey dey here be proud house husband?.If u be house husband abeg raise up ur hand grin grin grin grin grin grin
Re: Are U A House Husband? by pwiz(m): 12:27am On Oct 21, 2011
Can u summarise cos i can't comprehend the bullshiit u wrote up dia.
Re: Are U A House Husband? by freecocoa(f): 12:29am On Oct 21, 2011
Person wey do you this thing wey dey worry you don die,that's the problem(we for go beg am to undo am)
 With the way you are going eh it'll be a miracle if you can get any girl to manage you as house boy sef let alone husby.
Re: Are U A House Husband? by slimyem: 12:41am On Oct 21, 2011
ugh!this little boy is back with the usual shite.
Re: Are U A House Husband? by ismaeel86(m): 12:52am On Oct 21, 2011
lefulefu's tale by moolight grin grin
Re: Are U A House Husband? by MrsChima1(f): 1:17am On Oct 21, 2011
lefulefu:

For those of una wey no know wetin house husband mean e mean say a married bobo or boyfriend wey go dey house 24/7 while im wife or girlfriend dey outside dey work.Na these type of bobos go dey house wash plates,clean the kitchen,bath the pickin while im wife dey hustle for outside.Na also this type of bobo im wife go send on domestic errand go market and the bobo go bring wetin im buy for market to prepare am for house while im wife go dey sitting room dey watch home video and dey drink small stout.Na also this type of bobo wey dem dey refer to as house husband na im wife go slap in the presence of her friends if im no prepare the food well.Some of these bobos wen u ask them why dem dey act like tht na dem go tell u say na so modern couples suppose to behave.Dem go let u know say oyibo man na im dey cook and clean the house for im wife so there4 they themselves must act like the oyibo man because na the civilised way of life be that.I remember this guy wey i visit and as we come dey discuss for kitchen na im one of the plates wey the bobo dey clean come break into pieces wey fall frm im hand by mistake.Omo come see as im wife rush into the kitchen from the sitting room like express train come wuzz the bobo three dirty slaps across the face gbosa! gbosa!! gbosa!!! grin grin grin grin.Me sef i just open mouth dey watch the drama as e dey unfold and the funny thing of it all is tht the bobo no say anything after the wife don chop am the slap.The wife come tell me say make i comot from her house and the bobo no dare say anything.I just shake my head waka comot from their house dey ponder on the issue at hand.Wetin i come see for this matter be say most of these bobos wey be house husband get no say for the house because na the woman dey make the money and if dem dare say anything the woman fit hook her foot inside their yansh throway dem from the house grin.Some my guys any of una wey dey here be proud house husband?.If u be house husband abeg raise up your hand grin grin grin grin grin grin

Aww. Your mistress have you cooking her dinners and babysitting her ex's children huh?
Re: Are U A House Husband? by lindabon: 1:40am On Oct 21, 2011
freecocoa:

Person wey do you this thing wey dey worry you don die,that's the problem(we for go beg am to undo am)




I dey try undo am! Make other NL people join me abeg?!!  undecided undecided undecided
Re: Are U A House Husband? by ismaeel86(m): 1:44am On Oct 21, 2011
^^ this babe is bweeriful walahi. cool
Re: Are U A House Husband? by Cuddlemii: 4:01am On Oct 21, 2011
ismaeel86:

^^ this babe is bweeriful walahi. cool

U never fill roster finish. na u dey know who be who for chicks but she makes sense sha, u know I got ur back wink wink wink
Re: Are U A House Husband? by Nobody: 1:29pm On Oct 21, 2011
Mrs, Chima:

Aww.  Your mistress have you cooking her dinners and babysitting her ex's children huh?

pretty much! LefuLefu is always snitching on himself. grin
he know it was him who wore the apron, who dropped the dish
and got clogged upside the head three times! grin thats why he is
always talking about Oyinbo women because his Niaja girl
is like probation officer meets man beater!! grin Now I know why
he fantasizes about pissing off Naija babes so much. Because as
soon as he logs off he gotta get the pot boiling or else!! grin grin grin grin grin grin
Re: Are U A House Husband? by MrsChima1(f): 2:00pm On Oct 21, 2011
Is that why Dsense be whistling and cleaning? shocked shocked shocked lipsrsealed
Re: Are U A House Husband? by Princek12(m): 4:11pm On Oct 21, 2011
The poster has some valid points. The truth is that there are men who are house husbands. It is a fact. I have seen some.
Re: Are U A House Husband? by Blazing88(f): 4:20pm On Oct 21, 2011
theres nothing wrong with a house husband.
If his wives like him like dat?
Its cool.
Re: Are U A House Husband? by Nobody: 5:22pm On Oct 21, 2011
p.wiz:

Can u summarise cos i can't comprehend the bullshiit u wrote up dia.
U see yasef tongue.No wonder u fail english ten times for WAEC grin
Re: Are U A House Husband? by ismaeel86(m): 6:27pm On Oct 21, 2011
Cuddlemii:

U never fill roster finish. na u dey know who be who for chicks but she makes sense sha, u know I got your back wink wink wink

grin grin grin grin

Babe, when are u releasing the season 2 of your poems?
Re: Are U A House Husband? by Princek12(m): 6:29pm On Oct 21, 2011
Blazing88:

theres nothing wrong with a house husband.
If his wives like him like dat?
Its cool.



abi ooo. why are some women here acting like house husbands don't exist, or acting like they don't have house husbands at home.
Re: Are U A House Husband? by ronkebp(f): 7:07pm On Oct 21, 2011
So?? there are house husband!!!!!!!!! what should we do now Mr Poster,
Re: Are U A House Husband? by Cuddlemii: 7:48pm On Oct 21, 2011
ismaeel86:

grin grin grin grin

Babe, when are u releasing the season 2 of your poems?

Omo love never shark my head yet. That time I was inloaf. I tried writing one without love but it didn't work out, I was battling with words and I wasn't flowing. Once I fall deeply in love again or find a muse, I will knock you down with some fresh .
Re: Are U A House Husband? by CuteTj(m): 12:21pm On Oct 22, 2011
Lefulefu, u sure say no be wetin dey happen to u for the so called uk u claim to live in u dey tell us on top nairaland? Say the truth and let d devil be ashamed so we can start making plans on how to rescue u.
Re: Are U A House Husband? by Nobody: 5:38pm On Oct 23, 2011
CuteTj:

Lefulefu, u sure say no be wetin dey happen to u for the so called uk u claim to live in u dey tell us on top nairaland? Say the truth and let d devil be ashamed so we can start making plans on how to rescue u.
Me house husband ke? angry.My oyibo kele respect me die and she dey treat me like the african king that i am grin
Re: Are U A House Husband? by Nobody: 5:40pm On Oct 23, 2011
ronkebp:

So?? there are house husband!!!!!!!!! what should we do now Mr Poster,
How many times in a week u dey make ur husband chop slap? grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin grin

(1) (Reply)

Can Somone Ans Me? Why Boys & Girls Started Frndship With Love & Ended With Tear / What Do You Do When You In A Love Triangle? / Romance Section Becoming An Idole Members Worship

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 39
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.