Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,306 members, 7,808,038 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 05:11 AM

My Pally Don Break Im Babe Heart because Of Fuel Subsidy Ooooo - Romance - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Romance / My Pally Don Break Im Babe Heart because Of Fuel Subsidy Ooooo (859 Views)

All Relationship Will Go Complicated Dis September because Of This (photo). / She Broke All His Breakables And Parted Away With 50 Liters Of Fuel (pics) / My Pally Wan Dump Im Babe because She Too Dey Lepa(skinny) (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

My Pally Don Break Im Babe Heart because Of Fuel Subsidy Ooooo by Nobody: 7:38pm On Jan 05, 2012
nawah for the problem wey oga presido jonathan don cause ooo.my close pally wey we write GCE together wan break up with im fiance because federal govt don remove subsidy for fuel.the guy be plan to marry im fiance dis coming Feb and me sef be don dey plan big for the weddin as the best man so the thin come shock me as he telephone me yesterday afternoon dey tell me say e no wan do the wedding again.i come ask am why nah and e come tell me say na because jonathan remove subsidy from fuel.he say he no sure if he go fit withstand the wahala wey go come dey the marriage if the cost of livin come too increase because of the removal of fuel subsidy.he say how he go fit put im woman for house plus pickin wey go come by the way and all of them go come dey depend on im slim salary wey he dey earn as a bank clerk for one of the community banks abi na micro finance bank.im babe don already come my house dey beg me make i convince my pally to marry her this Febuary and i don try convince am but the thing no work ooo.he say na abroad he wan travel and as i be im pally make i assist am come uk make he come hustle and marry one fine oyibo girl.i ask am what about im fiance and he already don tell me say dat one na past tense as far as he is concerned.i don tell im fiance make she forget the bobo and start to dey look for another guy to marry her but she say as she don near almost thirty yrs dat one go come hard.Omo nairlanders na wetin una think for this matter?
Re: My Pally Don Break Im Babe Heart because Of Fuel Subsidy Ooooo by UyiIredia(m): 7:50pm On Jan 05, 2012
This is highly plausible and exactly the kind of effects one would expect. Wetin I think ? Wetin the guy go do ? Im gatz survive na !
Re: My Pally Don Break Im Babe Heart because Of Fuel Subsidy Ooooo by born2boink(m): 7:52pm On Jan 05, 2012
Even my babe wey travel dey give me concern now because im travel and she bi dey borrow money come now, as in tell me, the tin dey my neck
Re: My Pally Don Break Im Babe Heart because Of Fuel Subsidy Ooooo by Mynd44: 8:25am On Jan 06, 2012
As P Square said, Wahala dey

(1) (Reply)

My Nice Guy Is Begining To Get The Girls Bored. / Christian Dating Advice For Christian Singles / Are Nigerian Guyz Truly Wicked Or Girls Choose Wrongly?

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 14
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.