People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills

A Member? Please Login  
type your username and password to login
Date: July 20, 2008, 10:03 PM
221812 members and 125617 Topics
Latest Member: eva_tee
Nairaland [Nigerian Forum] Home Help Search Who is currently online? Login Register
Nairaland Forum  |  General Discussion  |  Culture  |  People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
Pages: (1) (2) (3) (4) (5) Go Down Send this topic Notify of replies
Author Topic: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills  (Read 1340 views)
smile4kenn (m)
People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« on: February 02, 2008, 12:24 PM »

eventhough pigin no be our offcial langauage, at least na our hood language,  make we speak am here,  talk your pigin proverbs, yarns,  as for me i do yarn
Dr Ferlie (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #1 on: February 02, 2008, 06:41 PM »

ma brother, so many things dey happen. ao yonda. ground no level here. de babe wey i  stanby gidigba dey wait for no surface. agro dey hit your guy.
amsky (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #2 on: February 02, 2008, 08:15 PM »

Area!!!!!!!! I hail o.

i never see the pigin wey i wan see for here o.Na d warri pigin na im i dey wait.if una fit make you rap am.i dey wait you. Cheesy

I miss Nigeria Sad
doncaster (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #3 on: February 02, 2008, 08:36 PM »

ma people kilo-hapen 4 this thread as no body wan yan pigin again, aby dey don bann pigin for this our land? i fear!!! Shocked Shocked Shocked
toshmann (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #4 on: February 02, 2008, 09:55 PM »

who say we no go yarn pidgin for here? anyway i jus arrange some kind stew now. the stew try sha but e no get better facilities inside am but i manage am sha. man no kpeme man no rotten. no matter no matter, naija man go thrive. Cool
doncaster (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #5 on: February 02, 2008, 10:05 PM »

You try ma brother at all at all na e m worse pass. Wack your stew dey go no shaking.
RichyBlacK (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #6 on: February 03, 2008, 10:25 AM »

Shuo! Tank God say pipo wey still like pijin still full ground. No wan, all level dey comform. O bros, the pesin wey start this tred do beta tin.

@amsky, my sista, so you like waffy yarns. You marry waffy guy? Grin. Any way sha. How bodi for yonda?

All man, I dey throway salute!
amsky (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #7 on: February 03, 2008, 11:01 AM »

richyblack no be wafy man i marry but me sabi the wafy yarns small. how d sunday for your side na? pepper rest small na im go buy tins for d haus.
abeg i never see the tick pigin wey i dey wait o!!! wetin de hapen na? I dey wait.this one no be d correct one.e get the type wey i wan hear.

I troway salut ma pipo Grin.
almondjoy (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #8 on: February 03, 2008, 11:08 AM »

We don dey boku boku!  Leti we pipo begin jhion to dey patro for inside year wellu wellu abeg!  Especially we when be leducated ladies!

I troway salote oooooooooooooooooh! Kiss
Zandra1 (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #9 on: February 05, 2008, 05:21 AM »

Me I know sabi speak pidgin  Cheesy. The small wey I speak na the basics wey I learn from nairaland and some friends but I still dey learn sha. I love seeing people wey dey speak pidgin or when they write with am esp. on nairaland. I go come back when I sabi speak more. I troway salute and hail una.
Ijiji1 (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #10 on: February 05, 2008, 05:27 AM »

Zandra i fit be your teacher, i go only charge you $20.00 per lesson
Zandra1 (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #11 on: February 05, 2008, 02:12 PM »

@ ijiji1, $20 dey too much now haba  Cheesy. I no fit pay that amount just to sabi speak pidgin. Abeg we need to bargain oo.
doncaster (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #12 on: February 05, 2008, 04:51 PM »

zandi abeg no mind ijiji(fly) i go arrange the pigin 4 handout for u free, if i come charge u y den u be friend. How u wan make we start as i ever dey ready to credit d pigin for your medula.
youngies (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #13 on: February 05, 2008, 05:57 PM »

Abeg abeg abeg make una put me down i no wear pant abeg! My pipo i djust dey cofirm say Vogts say we no fit sack am. Sad

Which kind opata be that? Somebodi wake am up oo, I no fit shout abeg.
Ijiji1 (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #14 on: February 06, 2008, 02:12 AM »

Quote from: doncaster on February 05, 2008, 04:51 PM
zandi abeg no mind ijiji(fly) i go arrange the pigin 4 handout for u free, if i come charge u y den u be friend. How u wan make we start as i ever dey ready to credit d pigin for your medula.

Oboy see as you just the pour san san inside my garri which one you dey sef, na wa for you o!! Grin

My dear zandi no mind that yeye boy, I fit do am for $10.00 because me and your small brother go school together for yonder.
kenypumpin
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #15 on: February 06, 2008, 12:20 PM »

ma pipo me dey  feel una wel wel lo.how far naija na,she pepper stil never rest  na wa o.i enjhoy una pidgin o.abeg i hail  o.
smile4kenn (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #16 on: February 06, 2008, 01:11 PM »

ma people, eget some kin pigin wey i dey heear from one guy sha,  but na pigin proverbs, make i share am,

Fear get levels, fear pass fear.

I no fit Shout, instead make i shout i go peme.

I never hear any Nna pigin here,  Where all the Nna mehn dey for here,  na igbo boys pigin i mean ma brodas
doncaster (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #17 on: February 06, 2008, 08:00 PM »

Quote from: Ijiji1 on February 06, 2008, 02:12 AM
Oboy see as you just the pour san san inside my garri which one you dey sef, na wa for you o!! Grin
My dear zandi no mind that yeye boy, I fit do am for $10.00 because me and your small brother go school together for yonder.
ma men wetin kome be your own now, i tell am say i go download the pigin free 4 zandi u dey here still dee talk in $.
Take am easy abeg, zandi no get benjamin to spend.
iceblue (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #18 on: February 06, 2008, 09:51 PM »

LOL

zandra no mine them. $10 dollars ko, 50 cents ni! just make sure say u dey jack evri fo this tred. nottin do you.

Area!!!!
Zandra1 (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #19 on: February 11, 2008, 05:18 AM »

@ doncaster and ijiji, una thank u oo. Like doncaster talk, I be student so for now I no get money to spend make ijiji teach me pidgin. Doncaster am waiting make u teach me since u go teach me for free. I hope I no go pay u later oo  Cheesy.

@ iceblue, me think say they like money too much Cheesy.
mohawkchic (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #20 on: February 11, 2008, 05:51 AM »

~No b say ar no sabi una pigin ooh,e b say me yon pigin diferent!! Grin
speciexl (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #21 on: February 11, 2008, 09:11 AM »

bros yies, i hailz o!!!! whish onez na, noe be say i wan show myself, but ehn as una dey ginger me ginger me wit all una washin for yonder ehn, make una come gorund yansh for area make una undastand say nuttin dey wier, !!!
too mush jo,  Cool Cool Cool
smile4kenn (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #22 on: February 13, 2008, 02:16 PM »

wetin dey happen, nobody sabi speak again?
Blackcat (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #23 on: February 14, 2008, 03:20 PM »

Quote from: smile4kenn on February 13, 2008, 02:16 PM
wetin dey happen, nobody sabi speak again?

People wey sabi speak pidgin berekete, de wahala bi say them no fit write tam. No bi everybody wey sabi speak pidgin de sabi write oh Grin
romade (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #24 on: March 21, 2008, 09:58 AM »

sho! hot wata cari plenty work. Ma papa take him own make akamu but them oyinbo na 4 tea.
brownbonno (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #25 on: March 21, 2008, 09:45 PM »

I just dey laugh here Smiley
Waffy pigin no dey 4 dictionary,so u no wo fit enjoy am by writing.
Any way u no need visa to visit sha,na there u wo fit get ther real effects of wafy yans.
Gamine (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #26 on: March 21, 2008, 09:51 PM »

Wetin you people dey yan for inside here

Every pesin talk just dey go boju boju

Abeg may we organize smthing wey dey tangible, may we yan
top_kin (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #27 on: March 21, 2008, 09:56 PM »

Sho pipo wich one una nor dey now? We nor get wafi guys for here? Una never langua d corect wafi pidgin 4 this arena o! I stil dey wait o!

morenike09 (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #28 on: March 21, 2008, 11:07 PM »

am still learning sha. but let me give you guys a sentence:

hmmmmno be your fault  Cheesy Cheesy Grin Grin
Gamine (f)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #29 on: March 21, 2008, 11:47 PM »

People go just dey form
they go dey papas n mamas
nawa

i no fitting to speak pidgin. yakitiya Lips sealed
Warfy Boy (m)
Re: People Wey Sabi Writ Pigin: Make Una Show Una Skills
« #30 on: March 27, 2008, 11:05 PM »

shoooooooooooo, c levos sha, me no even kno say this kain tin dey run down 4 this area sef

area which levolo now, i lazy 4 una ohhh, na im una kom dey let me dey waste my salava dey spik grammer 4 d  oda threads

mem tins b as e get ohhh

wetin make me lazy 4 house now b say ehnnn, i b  get  1 shenkes [babe] wey say she go kom braket me 4 my kaban [house] make we browse before ohh, me don package every every dey wait, i go even arange 5 alive make we take jolificate. bt i dn wait 4 d shenkess ehnn she no gri sho, like this like this ehnnnn i dey provoke, bt @ a time ehnn, i go seal up [bone] shall, because d shenkess go evaly sho 4 my kaban [house] n  i go browse every site 4 ha webbbb

last last now, i hail warfy

no mata d weight of an elephant e no fit cause earthquake
geesmiley (m)
Ma pipo wetin dey?
« #31 on: April 02, 2008, 10:54 AM »

Na wao. i no know se this kin tread dey here o. Wetin dey happen for yonda na? Where all de Seke go now. A beg how we go decribe sometin wey get everi tin for pidgin? I wan now abeg una
 Which Culture Is The Best  Interacial Relasionships Are You For, Against, Or Indifferent:   A Woman Combining Her Maiden With Her Husbands Name  Page 2
Pages: (1) (2) (3) (4) (5) Go Up Send Topic to Friend by E-mail Reply 
Google
 
Web www.nairaland.com
Sections: TV/Movies (2) Music/Radio (2) Celebrities Jobs (2) Career Romance Books Politics Sports Fashion Travel
Health Schooling Religion General(2) Business Webmaster Programming Computers Phones Cars & Trucks

Links: Page1 Page2 Page3 Page4 Page5 Page6 Page7 Page8 Page9 Page10

Nairaland is owned by Oluwaseun Osewa
Nairaland Forum | Powered by SMF 1.0.12.
© 2001-2005, Lewis Media. All Rights Reserved.