|
Negro_Ntns (m)
|
I know say urhobo women fine well well. Back in de days I been go FSAS with some urhobo girls, omo i no lie, na so diem slender, dark and get sharp tongue for mouth. efrybody dey pursue diem, me mahself e be like urhobo dey mah blood small. ehn, make u shoot de pishure make man pikin eyeball u nah.  I no lie oo, omo i sense somthing in ya 
|
|
|
|
|
|
omoovie (f)
|
I know say urhobo women fine well well. Back in de days I been go FSAS with some urhobo girls, omo i no lie, na so diem slender, dark and get sharp tongue for mouth. efrybody dey pursue diem, me mahself e be like urhobo dey mah blood small. ehn, make u shoot de pishure make man pikin eyeball u nah.  I no lie oo, omo i sense somthing in ya  Ok, I go flash am in 1, 2, 3! FLASH! Sorry! Here today gone tomorrow!
|
|
|
|
|
|
Negro_Ntns (m)
|
Omo,
Abeg take am comot make anoder eye no see wetin i see. Wait ehemm, hold on make i think, oh chei mah head don scatter now for wetin i wan say. Omo, make u write me, u get mah email for there. U go dey surprise well well.
|
|
|
|
|
|
omoovie (f)
|
Omo,
Abeg take am comot make anoder eye no see wetin i see. Wait ehemm, hold on make i think, oh chei mah head don scatter now for wetin i wan say. Omo, make u write me, u get mah email for there. You go dey surprise well well.
Hahhahahahahahahahahaah! Razzz! 
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
una two dey MARGINALIZE THIS THREAD O! CHAT ROOM DEY ROMANCE SECTION DEY OFFTOPIC DEY YIM DEY MAKE UNA CARRY UNA OPAKS GIST GO DERE! 
|
|
|
|
|
|
omoovie (f)
|
una two dey MARGINALIZE THIS THREAD O! CHAT ROOM DEY ROMANCE SECTION DEY OFFTOPIC DEY YIM DEY MAKE UNA CARRY UNA OPAKS GIST GO DERE!  D romance don end y'hear abeg relax jo! Negro and I know say na just OP toasting we dey conduct 2 mins no pass before e begin toast TOH 4 another thread! D boy na woman wrappa! So mustay---relax ya own. No worry babe with wandering eye dey wey jus dey crush u laik maddddddd! 
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
ehn ehn
That one na good yarns o!
|
|
|
|
|
|
Negro_Ntns (m)
|
Omo, I don die oo! Nah so u go just tro'wey me like nothing? No listen to Mustay, hin be mah rival nah :-) I don kuku say make u whisper me for email for sake eyes boku for here. Nah you no gree me o, no be TOH cause am. I no be woman wrappa, I be omoovie wrappa :-) make you do quick quick take put action for ground.
Mustay, omo eyes no dey for de ones wey dey check you out. Her oil lamp dey only shine come mah direction.
|
|
|
|
|
|
Tetchiness (f)
|
well, I sabi pidgin small small sha.  Negro et Caucasian, wetin you dey yarn na? where una wife? I don see her online this morning. Think she dey try to escape you. . . .again!  I tried 
|
|
|
|
|
|
drrionelli (m)
|
<drrionelli is quietly taking copious notes in the Pidgin thread, preparing to ask questions> 
|
|
|
|
|
|
ikamefa (f)
|
haaaaaaaaaaa this thread don gooooooo ohhhhhh see levels? 
|
|
|
|
|
|
omoovie (f)
|
haaaaaaaaaaa this thread don gooooooo ohhhhhh see levels?  Sebi? My girl wey u bin dey? Foh whosai of Jaipur them carry u enter? well, I sabi pidgin small small sha.  Negro et Caucasian, wetin you dey yarn na? where una wife? I don see her online this morning. Think she dey try to escape you. . . .again!  I tried  I don los na hu b caucasian 4 this sai? Omo, I don die oo! Nah so u go just tro'wey me like nothing? No listen to Mustay, hin be mah rival nah :-) I don kuku say make u whisper me for email for sake eyes boku for here. Nah you no gree me o, no be TOH cause am. I no be woman wrappa, I be omoovie wrappa :-) make you do quick quick take put action for ground.
Mustay, omo eyes no dey for de ones wey dey check you out. Her oil lamp dey only shine come mah direction.
I go tro'wey u na. U sef no b loyal omoovie wrappa so I gats to form small! *wink**wink* Y I go whisper u 4 email? U no hear me say na Asians & Latinos them naim dey trip me nao? Ur toasting nova done before u begin another 1. As u b laik octopus dey spread ur tentacles into difren difren girls them me too gats to spread my own tentacles. Which kain action I wan put 4 ground? As 4 Mustay, truly truly, I no dey d list of babes wey dey eye u sorry. And Negro u dey delusional. 
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
Who this one dey do yanga for?  shio Na so all these babes dey do Them go wan make man dey go interview test like say I be apprentice 
|
|
|
|
|
|
ikamefa (f)
|
Sebi? My girl wey u bin dey? Foh whosai of Jaipur them carry u enter?
na Ashok nagar  na when u go land? 
|
|
|
|
|
|
omoovie (f)
|
Who this one dey do yanga for?  shio Na so all these babes dey do Them go wan make man dey go interview test like say I be apprentice  You b apprentice o no b only novice! You nova jam! Na correct babe of d highest order naim u wan use back door take toast! Bros, no try me eh! I dey beg u nao mek I no show my dragon side! na Ashok nagar  na when u go land?  I go land once mai eye dey chuk gamuchi ihn pocket nao! Shuoo! You b gofment? Hajia govamenti, I no bin know!
|
|
|
|
|
|
Negro_Ntns (m)
|
Omo, Look how this urhobo princess don vex finish take mouth yab left and right, up and down and wonder why all this african warriors no fit for am.  Ehn, urhobo wado, omovie wado, ovieya wado, hahahaha  . na so princess dey behafe? Na me get de remedy for ya palava but ya eye dey wey e dey and me mahsef enjoy and like de accompaniment of plenty women but i always get that special one wey be say nah hin i go settle with. I nefer meet am, i still dey look but as i dey pas go, ya light na hin draw mah eye make me put brake for leg turnabout and put foot for this floor.  U dey go look for india and asian and latin, ehn oya, take ya oil lamp go dere nah. Efrytime u miss home whisper me for letter, man pikin dey here. We go eyeball again nah  mi ni wado 
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
omo
where ur frends them dey?
|
|
|
|
|
|
romeo (m)
|
ahh ahh wetin de shele for this side!! I bin dey blow my igbo for that side since and i no come know say better dey here oooh
I hail una!!
|
|
|
|
|
|
omoovie (f)
|
Omo, Look how this urhobo princess don vex finish take mouth yab left and right, up and down and wonder why all this african warriors no fit for am. Ehn, urhobo wado, omovie wado, ovieya wado, hahahaha . na so princess dey behafe? I'm vexing because u betrayed me nao ehn! Efen @ that u kno u still love me!  I dey c d rov 4 ya eye boku boku! Na me get de remedy for ya palava but ya eye dey wey e dey and me mahsef enjoy and like de accompaniment of plenty women but i always get that special one wey be say nah hin i go settle with. I nefer meet am, i still dey look but as i dey pas go, ya light na hin draw mah eye make me put brake for leg turnabout and put foot for this floor.  Awww, u don tuk d korret tin na, Come here my dahling!  You dey go look for india and asian and latin, ehn oya, take ya oil lamp go dere nah. Efrytime u miss home whisper me for letter, man pikin dey here. We go eyeball again nah  mi ni wado  Which kain backdoor romeo & juliet u wan use me tek do? U dey craze? I b u laik underG jezeebel? I no blame u! I don dey mara naooo!  Shiiiiooooooooooorrr! omo
where your frends them dey?
Which friends them?
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
u no sabi frends.
make person get directory now
|
|
|
|
|
|
Negro_Ntns (m)
|
Omo, I laik as u take proper respect recognise for ma sai so, come tell efribody say i be ya romeo but e get as e be nah. de kin toast i dey giff u so, er'body don sabi say fire dey burn for bitwin negro and omo and me i no deny am o. efrytime i hear ya footstep and see that light shine, even sef say women dey mah left and right side and we dey miliki nah so i dey take style comot from bitwin come follow till i find u. sebi i tell u say i dey search, how rove no go dey mah eye nah? na sake of da rove make me find u  make u come comot de rove put omoovie enter  backdoor no dey this one, efribody know say e get some kin fire wey dey burn bitwin negro and omo. me mahsef don buy kerosene wey i go take dey feed de fire, e no go die and even afta u don become mah juliet, i go kuku go buy oiel to feed de fire. next time i hear say u dey go india or asia na mah special duty finger i go take poke u for ya eye. na me and you, try me nah, yeye 
|
|
|
|
|
|
Mesmerize (f)
|
Omoolove haaa!! my sis tetchiness, no be Caucasian o! for where?  she be Chinese 
|
|
|
|
|
|
Mesmerize (f)
|
@negro omo, you talk too much jare! ah ah na yoruba ni o, na Ingilish nio, na pidgin ni, you still dey write paragraphs! Jesu, egba mi 
|
|
|
|
|
|
luck007
|
:)brother thank you oh!! na pigin na bi d topic, but una don turner to another thing. make una fire pigin na dey ask una. i want thicker pigin, wafi pigin  i nor talk pass there ohhh 
|
|
|
|
|
|
Negro_Ntns (m)
|
lmao mesmerize, no be mah talk too much oo, na u get wetin oyinbo pipl dey call attention deficit disorder, u no dey fit hold ya mind steady for one thing before hin go begin wander go another thing. Four sentences too much for ya mind to handle nah 
|
|
|
|
|
|
Mesmerize (f)
|
lmao mesmerize, no be mah talk too much oo, na u get wetin oyinbo pipl dey call attention deficit disorder, u no dey fit hold ya mind steady for one thing before hin go begin wander go another thing. Four sentences too much for ya mind to handle nah  se na me you dey yab like that abi? see your ponmo head. . hisss na me get ADD? dnt worry o, we're both in it together. oniranu
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
esmy, I dey feel u jo!
Haba, te guy sef wan write novel 4 pidgin
@luck 007
you get problem?
fire first na!
|
|
|
|
|
|
joomiegal (f)
|
when una start did thread, i bin think say una wan add pidgin proverb join am. Oya make we start; if u no know de answer, u fit ask julius agwu or basket mouth make e helep una. make una know say de answer for pidgin no always be the same answer for english. here goes: 1. Birds of de same feather, na de same mama born them!
2. A bird in hand, na to kill and chop!
3. a friend in need, oya make sombody answer na,
|
|
|
|
|
|
|
|
luck007
|
omo boy!na so we go de dey!! like edede when nor dey eat food when peppe dey!!!!  very so una go hear say person don write book wit pigin
|
|
|
|
|
|
Mesmerize (f)
|
omo boy!na so we go de dey!! like edede when nor dey eat food when peppe dey!!!!  very so una go hear say person don write book wit pigin lmao!!
|
|
|
|
|
|
Mustay (m)
|
lmao!!
wetin that one mean?
|
|
|
|
|
|