|
Alexpissu (m)
|
Word up to all Emcees in the House , I was thinking we should try and do something new like droping 16 in Pigeon English. This how it goes just drop a Freestyle besides that here are the rules:
-No Bitting -No Mama and Papa Diss -No Irrelevant Talk-No wack stuff please Lets Go 
|
|
|
|
|
|
Alexpissu (m)
|
Check Dis I fit travel like bugs bunny 2 bonny camp all because of carrot/ Dis days self the way i dey freestyle u go call me parrot/ I dey rap 4 smal-age middle-age and Old-age/ You self go wonder wether i don be hip-hop slave/ when i spit 4 mic u go experience atmosphere of miracle/ I no be Pastor Chris pikin but i know my pinnacle/ Make i tell u small boy i dey bring Drama pass wale adenuga/ You no go fit understand am like listening to Konga/ Dis emcees no fit score me I dey defend them like Taribo West/ I love rap but i no wan be college dropout like kanye west/ Go ask your crew me myself bad pass satan plus lucifer/ when i rap i go make u and your family suffer/ You wan battle me i dey 4-1(Forwarned) u like Manchester United to Enyimba/ Infant like u, u just dey remind me of that animal Simba/ Why be say this fake emcees no fit smile like Arsene wenger/ Dem dey vex cause i dey dribble them like say i be Odenwinge/
|
|
|
|
|
|
chiogo (f)
|
umm, i can't write in pigeon english. 
|
|
|
|
|
|
Alexpissu (m)
|
why not, u won't believe it this is my first Pigeon English 16. Chiogo let me be sincere to u, it was kind of hard 4 me at first just believe u can do it ok. 
|
|
|
|
|
|
chiogo (f)
|
lol, i can't even speak it but it sounds nice, i think. I'll wait 4 others to post and i'll learn.
|
|
|
|
|
|
OldSYNC (m)
|
Vex or no vex monkey don get long tail/ My lyrical ability dey bam, no be today, e don tail/ For obodo oyinbo tongue, or na for my mama tongue/ This pass reason why me go rule long, hail king kong/ Wack the wacks like say them be isi-ewu/ Tack them back like say them be tear-tear wool/ Levez-vous better people, make naija spits spill/ This one na the new show, na the poster's will/ This go kill, if my heavy talk land your head like hammer/ You no go know when you go dey talk Chinese, even them grammar/ Sync no be easy meat, you no go like me with amala (fOOD)/ The infections I cause wowo pass malaria, no even think of Amalar (Drug)/ I dey flow wella, maybe because i come from Fountain of Knowledge/ I beg give me the mic, I go serve wetin go make them (re-)enter college/ Me dey vex, I dey spit am for my anger, like say una no be my brother/ See me, see palaver, wetin concern baruf with origo if no be Alaba (Int'l market)/ I beg call father him name, OldSYNC Baba!
N.b: Baruf (Wack MCs), Origo (Real/Hot MCs)
|
|
|
|
|
|
buzzgonz (m)
|
Turn on my microphone, MC's see my freestyling and tell me wetin dey pa/ All hommies dey call me champion because i too dey sharp like tu baba/ No Stress but try shake that thing wey you get like ruggedy baba/ pkodidipko,pkodidipko na talk am, abi na lie no na talk am loud/ Guy my lyric no fit finish because e not too gel but i no send/ Na BuzZy dey BUzz da Vibe! No Stress! 
|
|
|
|
|
|
OldSYNC (m)
|
N.b: Baruf (Wack MCs), Origo (Real/Hot MCs)
@ Buzz u be baruf, shey u code? check my flowquote
|
|
|
|
|
|
mailmalc (m)
|
mailmalc dey represent the true hiphop dynasty/ ma line pass this- wackos wey dey rhyme nasty(any how)/ i fore warn u - so excuse no go dey when ma flows dey burn you/ even after masturbating you still nor go "Cum" through/ if this na premeirship,most mc's here dey face relegation/ so when i split bars i dey put their wack heads for detention/ i dey lyrically able to cripple my foes to disable them/ most of em nor dey man enough even if they resemble men/ alexpissu know say when i buzz all rappers go sink - ask old sync/ i go give em pills then i go spray 'em wit raid 'cause they stink/ no need for too much english - since PIDGIN na the In-thing/ fcuk maggi seasonin, i dey spice up rap threads for a reason/ listen- i finish this lines within very very few minutes-big grin/  na simply naija style so i get to colour this one wit real-green/. . . . . malc rules
|
|
|
|
|
|
|
|
Wordsmith
|
My mic skill sharp pass razor blade/ Omota were wit a difference, bobos them dey ask are we safe?/ this wack mcs no wan risk am 'cause if them mis yarn/ na wit red eye i dey give them beat down/ i get more yarns pass women for market/ if u show yaself, o' boy, we go shove yaself inside casket/ i open my mouth, lyrics pour like say na rain dey fall/ gbagb' oshi, mcs no wan jasi, na so all man dey dull/
lol
|
|
|
|
|
|
Alexpissu (m)
|
My peops know say i dey burst mic once in blue moon/ All this mcs dey write just one 16 from Jan to June/ I know dey for all those bling bling bubble gum rap/ My flows get overdose thats why this fools dey take nap/ Go ask my chick i don use hammer(money) pass carpenter/ Only time u flow na when Doctor put in 4 your body catheter/ Life na journey i no get good shoe how i wan take walk/ To yarn dey cheap but why edey expensive to do wetin u talk/ My guy meet 2Shot make he show u the way to Alaba/ Small boy rap no be your talent go do conductor 4 Idiaraba/
|
|
|
|
|
|
mailmalc (m)
|
today i get one invitation from my homie a lad in-/ benin them dey audition musical artists for Naomi's Garden/ cyrus da virus, franchise nd one other rapper na d judges/ some dey on time like say them sit for their wrist watches/ one wack female mc talk story of how she take dey beat boy/ i nor blame her sha at least who nor like perform wit p-square/ then this other guy wey dress like say na gangsta from detroit/ after the rap intro e enter bini music d nutty boy switch voice/ i never still know why one fake MJ must come wit jerri coils/ 3 chicks shake yansh and remind me of dbanj 'i love that booty'/ i wish i fit scope them make them know say i get that goodies/ the two best of the day . . chei! i don forget im name/ cute-boy one other guy wey sing dancehall and reggae/ i nor know say rhymzo get clone wey im lyrics dey wicked/ hold 2k5 come as vip entrance nor come beg for free ticket/
P SQUARE, I GO DIE , CYRUS, MALEKE, ALAYE AND MANY OTHERS LIVE IN BENIN CITY ON THE 23rd OF FEB. COURTESY OF EHI-GLAD ENTERTAINMENT. holla @ moi for enquiries.
|
|
|
|
|
|
remmyneece
|
everybody dey burst like say na beans, free to pack some of my lyrics inside the pockets of your jeans, let me know if i'm tight or not, read them,pack them and chop them like groundnut, i gbadun this game b'because i dey speak my mind, because na hiphop dey make me feel shine, he don tay wey i don dey pull this game, so i no shine, i just dey try make my claim. TRUST ME.
|
|
|
|
|
|
Wordsmith
|
Oya now, pass Word d mic na im turn/ make i bust pass machine gun/ i wonda why bad belle must hate/ my lyrical bust rate reach octave/ abinibi plus common sense wey God make/ i no send una message like post man/ if u wan test, give yourself liver make u post am/ Gbabeski, if u think say u b virus, i b antivirus like Karpesky/ make i gve una format: bow down and worship your Majesty!!/
|
|
|
|
|
|
Maverik
|
@Alexpissu & Mailmalc Yall seem to have a hang on this pidgin thingy. I wudnt even risk it.  @Wordsmith Dat line,son :gbabeski & Kapersky? Dude,dnt make me cry! Nice try,anyway! 
|
|
|
|
|
|
Po Deep (m)
|
I be indigene so I must to buss for pidgin. Omo, bone runs I "freestyle" pass di shogun, buss pass gangsta wey dey load gun so when I blow bomb, u go run! Omo u go chop slap if u no 'gree to chop knuckle. If u no gbadun my flow, omo FUCK YOU! Thunda strike ya left yansh! Like say my friend dey marry, they call me da best man. Festac boyz, I hail o! & Festac girlz wey get kaka pass J-lo! P£-@-c£
|
|
|
|
|
|
Wordsmith
|
'Twale! 
|
|
|
|
|
|
Maverik
|
No dulling,my guy! 
|
|
|
|
|
|
OldSYNC (m)
|
Still be me, me wey u go still dey feel/ SYNCman with the rap intention WE DEY KILL/ I go ever remain myself, u too try be yourself/ I dey angry, u know say that your beef make me vex sef/ I be the best, you still be the rest/ The heart dey inside me, I get the mind/ Na true say papa pass pikin, i know u no be my kind/ I be the power house, comot trouble abi u dey find/ Do this my may, no be that your mumu display/ Fighting me no dey pay, just show yourself d Nigeria way/ E be like say na words them wan play, but na childsplay/ Pidgin or oyinbo, shey u no know say na me get ma flow/ BJ, against me, me against Alex, maybe e go be me with flowshow/ I no dey discriminate, abi no be the love for rap we dey show/ I No dey block way, but i go make una move in slow-mo/ My self be me, and I know be coward, , i no dey lay low, lai lai (never!)
Repping Naija to d CoRe!
|
|
|
|
|
|
Alexpissu (m)
|
I get more yarns pass politicains on campaign course Give me the mic and the beat and u go see me floss My style Delicious without the Sauce i go feed that Kid No try me even if your albulm dey EBAY nobody go bid I get skills like brazils freestyle pass olympic swimmers Fool when my alblum drop u go rush am like consumers Dis impotent rappers just dey spit like pregant women Dem don clone their id like that fool dimon No critisize my flow no be u create rap or i slap u Pray before u read my lines cause na thriller e go thrill u
|
|
|
|
|
|
Malthuss
|
Ehen,
oya make una commot for road Malthuss don come again i no be Danfo driver but u go die for nothin if u enter my lane na pidgin i dey yarn, if u no sabi ma guy,abeg make u bounce or u go call your friend tellam say yawa don gas i bad pass lagos police, no be only shandy i dey collect if u no get gulder and star na station u go find yourself
Una know say i no send, wack rappers no come near my fence unless u sabi jump fence, nonsence, if i catch u na capital offence wetin be this, nowadays every bodi wan rap them dey spit jedi jedi like say them eat rice for buka near gutter, i don return like the jedi who wan test malthuss that person no get liver, flows i still dey deliver your babe don born again, now she be my believer. you wan complain, oya make u pull over.
|
|
|
|
|
|
chiogo (f)
|
Lol 
Them say make i rap for pigeon english but i go give them 'pidgin' english Wack rappers dey borrow my lines so i just dey give them for dash Forget wetin i talk before, this chick just dey multi-talented When i finish rappin', u sef go dey confess say i dey gifted That one no be new thin', Chiogo be teen celebrity Come my school see folks dey worship me, o boy, this na reality I no wan talk too much Cuz my swagga dey speak for me Fresh from head to toe when i come around, boys dey run crazy for me When i smile they say my smile fine no be small No be everybody go fit see am unless u dey tall I no dey roll with small pikins so u better be correct This chick too fly u sef dey respect.

|
|
|
|
|
|
The Sly
|
lol. . . . . wetin be this?  well u tried!. . . . nice one but i bet u couldn't pronounce most of 'em pidgin physically 
|
|
|
|
|
|
Wordsmith
|
Lol, nevertheless she tried.
Chi, don't mind 'em, go do your thang.
@ Malthuss,
nice one there, dawg. . .
|
|
|
|
|
|
Sharn06
|
Since Chi did it, I fit burst. Here goes nuffin
Ook, make una clear, tha bigger babe don enter, ma' una start to dey fear I no fit dey folo una dey yan, levels, komot or your eyez go tear//
I don dey yarn Britiko before, una no jasi so I go start to tasi anyhow, dey reel stunts like Michael Jackson//
I no fit dey do long thingz, I go just send , bruv, I can't do this, lol. Y'all can't say I din try. No claiming lvls, tis just so fuckin hard. See y'all in the faker world, lol!
|
|
|
|
|
|
chiogo (f)
|
@Wordsmith, thanx.
I'll be back, y'all. this is so much fun. 
|
|
|
|
|
|
mailmalc (m)
|
up Chiogo ! up Sharn ! e nor easy to burst two ways. keyboard check 1 2 make i murder this one small.
small boys make una stand still to welcome 'Big bros Malc'/ i dey wrestle una for here like say i be the big boss man/ some dey rap dust as if they use cement block their head/ my lines like rope dey tie their legs so i go knock them dead/ call them Bingo 'cause them dey bark like suffer suffer dog (dawg)/ ask Skingo when 'malc show all of em dey run hide under rug/ them nor be Cat - most of them na Pussy/ punchlines wit pidgin chei ! . . e Juicy/ like say i take their clock - i don get their time well well/ i dey bring the heat now all of them here dey smell sweat/ u go fear fear/ Ole ! them wan steal my flows/ if u bite my line i nor be tyson but i go bite your Nose/ i murder wit English then i bury cats wit pidgin/ If hip hop na nation, i be heavy rap indigene/
|
|
|
|
|
|
FLOWSHOW
|
yepa mogbe flowshow no be maga take the thing easy no push me to anger lega, lega ol boy coolu your temper i never chop how i go come belle full na mumu u be , na u be the real ode u no sabi me ask your papa for this area me i no be bolo for nigeria na him make me come dey chop for the cafetaria
|
|
|
|
|
|
mailmalc (m)
|
i dey feel myself  Alex wake up o nor tell me say u don crash. i reach house like few minutes to 10pm and mumsi come dey like  lol laterman Welcome to Benin
|
|
|
|
|
|
bolajibaok (m)
|
pidgin english rap make una no leave bolaji out i no be your papa who u dey call daddy if u wan carry nose make u borrow my hose see catarrh for ya nose wafy boy no get am for shows bolajibroke na the pro u be the chicken na u i go roast from this coast to coast na me dey shak the post
|
|
|
|
|
|
The Sly
|
Pass me da mic. . . . . l.emme show ya how itz done. . .  Everybody i beg make una vamoze, the king don ''come'' Dem hear my name, them shake like person weh wan ''Come" I be Igwe for this thing,people dey chew my lyrics like ''Kola'' Dem pikin dey enjoy my flow,like say them dey enjoy ''Cokacola'' Make he no suprise u, Sly na the king, bone all these ''ajebutters''  Me no be ''Glo'' he no go cost me anything to rule una ''world'' I fit dey spit from now, till the end of the ''world'' People dey feel me, dey talk about me like say i be ''Obama'' like play like play,everybody wan see me like say i be ''OSAMA'' This sly no be two,u fit search around the world, i be rare ''gem'' That na why everybody dey enjoy ma rap,like say na national ''anthem'' Me and una no dey the same class, For my face all una be ''ant'' Una no like am,i go spit for una face like woman we don ''pregnant'' From east to west to north to south, my style na ''classic'' Make una stop all una yeye lyrics,before una go give person ''headache'' Make una show sum respect anytime una see my ''name'' Me and una no be the same in this pidgin ''game'' 
|
|
|
|
|
|