|
KHAMILEON (m)
|
Nman I jest notice say one of una regulations, na say make all man no dey yarn pidgin, I just wan say that is unaceptable!, Yes this is your site, but even you don't have the right to barn Pidgin as it is the most spoken Language in Nigeria today and as far as i know this is a naija joint!,
Its like telling Jamaicans not to speak patoise on their web Or telling African Americans not to speak Slangs-ebonics (thats what a lot of them can actualy speak)
So whatever your reason for saying this, just know it wont hold, and I am here to speak Pidgin and would encourage others to do, If u barn me, i go re-sign in again as a new guy, so don't even bother, Pidgin is a language that i am proud of and will speak forever, Gbam! na im be that
|
|
|
|
|
|
|
|
Skidoc (m)
|
Hahahaha! I dey hail you my guy! Na you biko. The problem is that there are quite a number of Afro-americans, oyinbos and peops from other countries on this site. They won't catch the vibe but maybe we should have a special place for slaughtering pidgin english, abi no be so? By the way, I think I know you (that's actually why I'm replying to this thread  ) You be musician or u just picked up the guy's name?
|
|
|
|
|
|
KHAMILEON (m)
|
Re: Pidgin English! « #2 on: Today at 02:28:24 PM » Posted on: Today at 02:28:24 PMPosted by: Skidoc -------------------------------------------------------------------------------- Hahahaha! I dey hail you my guy! Na you biko. The problem is that there are quite a number of Afro-americans, oyinbos and peops from other countries on this site. They won't catch the vibe but maybe we should have a special place for slaughtering pidgin english, abi no be so? By the way, I think I know you (that's actually why I'm replying to this thread ) You be musician or u just picked up the guy's name? I feel you my guy!, The problem with ya tori be say this na NAIJA JOINT!!, How you go enter HOLLAND and you go say make the citizens no speak DUTCH because you get visitors??, Its just not possible, I don dey online for at least four years and this na the very first Joint to yarn like this and the ironic thing about it, be say this na Proper Naija based Joint!, If persin yarn pidgin and a few people no understand I know a million peeps always dey on hard to translate, Same happens when people speak yoruba, Abeg make the Modrators go change that warning because the thing no hold water at all!!, Unless them want make i go bring ma Area-boys to come flood this joint with pidgin. Nonsense & trying to be onyibo gramma gramma  PA J?? WHERE ARE YOU??, YAWA DEY GAS FOR HERE O!!!!!!!
|
|
|
|
|
|
vichel (m)
|
ma brother this thread dey make my belle sweet well well. anyways i think say if we wan trowey pidgin english for this forum, we fit do am, as long as we try to translate am for does wey no go fit get am. na ma own two kobo be that.
|
|
|
|
|
|
Seun (m)
|
Moved to culture section
|
|
|
|
|
|
YOUNGDICE$ (m)
|
that english sound like hausa to me.
|
|
|
|
|
|
Adetife
|
Be lik say i don find my post for this Nairaland o - Seun self no fit talk! 
|
|
|
|
|
|