Seun (m)
Ogun State, Nigeria
--------------------------------------------------------------------------------
'Sweet Mother', by Prince Nico Mbarga. the lyrics.
« #1 on: April 06, 2005, 02:19 PM »
--------------------------------------------------------------------------------
Sweet Mother
Sweet mother I no go forget you
for the suffer wey you suffer for me.
Sweet mother I no go forget you
for the suffer wey you suffer for me.
When I dey cry, my mother go carry me--she go say,
'my pikin', wetin you dey cry ye, ye,
stop stop, stop stop make you no cry again oh."
When I won sleep, my mother go pet me,
she go lie me well well for bed,
she cover me cloth, sing me to sleep,
"sleep sleep my pikin oh."
When I dey hungry, my mother go run up and down.
she go find me something when I go chop oh.
Sweet mother I no go forget you for the suffer wey you suffer for me
When I dey sick, my mother go cry, cry, cry,
she go say instead when I go die make she die.
O, she go beg God,
"God help me, God help, my pikin oh."
If I no sleep, my mother no go sleep,
if I no chop, my mother no go chop, she no dey tire oh.
Sweet mother I no go forget you,
for the suffer wey you suffer for me.
You fit get another wife, you fit get another husband,
but you fit get another mother? No!
And if I forget you, therefore I forget my life and the air I breathe.
And then on to you men, forget, verily, forget your mother,
for if you forget your mother you've lost your life.
Youtube video: 'Sweet Mother', Nigeria - Rendition by Tilda and Rocofilhttp://www.youtube.com/v/vPw1S1RNECU&hl=enor
Youtube video: 'Sweet Mother', by Prince Nico Mbargahttp://www.youtube.com/v/3mecNrIaWOA&hl=en