Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics

A Member? Please Login  
type your username and password to login
Date: October 14, 2008, 09:16 PM
249950 members and 148648 Topics
Latest Member: sokefun
Nairaland [Nigerian Forum] Home Help Search Who is currently online? Login Register
Nairaland Forum  |  Entertainment  |  Music/Radio (Moderator: eldee)  |  Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
Poll
Question: Who's your favorite?
Lagbaja - 1 (9.1%)
Sound sultan - 9 (81.8%)
Tuface - 1 (9.1%)
Eedris - 0 (0%)
Rugged Man - 0 (0%)
Other - 0 (0%)
Total Votes: 11

Pages: (1) Go Down Send this topic Notify of replies
Author Topic: Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics  (Read 1403 views)
Christino (m)
Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
« on: August 04, 2006, 10:32 PM »

Sound sultan, naija ninja
(Kennis Music)

Na for all ma brothers wey don ja commot for naija
always try to dey look back because there's no place like home
Yknawmean?
Yoruba man tell me say Ajo o dabi ile
And na true men
Check this out

Bridge:
(Ajo o dabi ile
No matter where u go
make u no forget area o area o
Na naija
Ti ode ba tile
Pada wale o wale o)

Chorus:
(How I wish say I fit reach u anywhere u dey, u dey
Far away, that one no say make u dey bone area o
Mother landi o)

na your area o

Chinedu somebody borrow you ego
Make you take travel go chicago
Remember Nnamdi sell him car
So you go go America
All these people wey bin dey raise you
still dey stay for face me i face you
promise say u no go fashie them
every other month u go dey tashi them
Hillary wey u been promise to marry
Still dey wait ol boy she don tarry
When she see u na inside Ovation
You marry Oyinbo from another nation
Use mago mago get dough
Now your Oyinbo wife don't know
next thing you know she don go report you
Wetin you know them don deport you

(Chorus)
(Bridge)

You been say na one year
E come turn to two years
You don go for seven years
But You dey serve eleven years
Even when your papa pai
Plus the tears your mama cry
Bayo for chicago o
them dey miss you for Okoko o
Biodun for Canada
Your mama still dey wonder
Igba wo lo to ma pada o
Remember for naija you get iyawo
Ko dabi ile (5 times)
Ajo o ma dabi ile o

(Chorus)
(Bridge)

You say u go call
Everybody wait tire for your call
Rote o, why u go like so o?
From germany, to carry coco enter Yankee
but then coco burst for your bele
Rest in peace.

You fly away
How come one day wey fun dey u fit come backi o
Your papa landi o
I understand sey u been so far away
Long long way from home (4 times)
You got a long long way from your papa land

(Bridge) Think before u enter that plane

All ma brothers in the west,south, east, north south
U know how we doing it
And all these people wey dey rule us
Make una try make naija sweet
Make we get water, light e.tc.
So that people go dey come house
(Kennis Music)
All the cardinal points
Respect
All ma people in da house.

(ripped by XSi) - hoping to find the lyrics to Gino's "No be God?"

pictures here please
Christino (m)
Re: Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
« #1 on: August 18, 2006, 07:14 AM »



* sultan.jpg (28.8 KB, 100x141 )
kbone (m)
Re: Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
« #2 on: August 18, 2006, 09:58 AM »

nice one puttin the lyrics up, the message is clear n simple and the words of the song talk to one's mind
Deepop (f)
Re: Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
« #3 on: September 01, 2006, 10:49 PM »

this guy is really hot!  his songs are loaded with powerful lyrics Kiss
Christino (m)
Re: Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
« #4 on: September 12, 2006, 09:23 AM »

If you google "Sound Sultan Area lyric" the first result is this page. Live! not even sound sultan's website. See levels. Grin

nairaland for sheezle ma nizzle. Cool
Christino (m)
Re: Motherland (area Acoustic) - Sound Sultan, Lyrics
« #5 on: January 18, 2007, 06:47 AM »

Any latest on dude's music Huh
 Atorise: A Gospel Musician?  Sauce Kid Is Better Than Modenine,ruggedman,freestyle Eldee,2shots All Of Em  Weird Mc Up For Channel O Award.  Page 2
Pages: (1) Go Up Send Topic to Friend by E-mail Reply 
Google
 
Web www.nairaland.com
Sections: TV/Movies (2) Music/Radio (2) Celebrities Job Talk Jobs/Vacancies (2) Career Talk Romance Books Politics Sports Fashion Travel
Health Schooling Religion General(2) Business Webmaster Programming Computers Phones Cars & Trucks

Links: Page1 Page2 Page3 Page4 Page5 Page6 Page7 Page8 Page9 Page10

Nairaland is owned by Oluwaseun Osewa
Nairaland Forum | Powered by SMF 1.0.12.
© 2001-2005, Lewis Media. All Rights Reserved.