Naija Love Rhymes For Valentine

Welcome. Please Login, Register, Or Activate! 
type your username and password to login
Date: November 21, 2009, 07:57 AM
430309 members and 297423 Topics
Latest Member: JatStraikar
Nairaland [Nigerian Forum] Home Help Search Who is currently online? Login Register
Nairaland Forum  |  Entertainment  |  Literature/Writing (Moderator: StephenP)  |  Naija Love Rhymes For Valentine
Pages: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) ... (25) Go Down Send this topic Notify of replies
Author Topic: Naija Love Rhymes For Valentine  (Read 9041 views)
rotimy (m)
Naija Love Rhymes For Valentine
« on: February 11, 2009, 07:06 PM »

You be  de correct sugar for my garri,
And I love you pass all girls for Warri.
You be de apple for my own eyes,
If no be you I go die frozen like ice.
You dey homely like ofada rice,
We no go fight again like cat & mice.
You be my ogbenga orishirishi for egusi soup,
Soon I go buy for you a mercedes coupe.
You be the only Christmas clothe for my wardrope,
If you leave me,walai, I go hang myself with a rope.
My endless love & African angel with you I no fit sleep,
Even my own people say you don turn me to a sheep.
At this season of Valen-wetin and always,
My bodi,heart, & pocket na for you always.
abdulone (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #1 on: February 12, 2009, 01:05 PM »

thats great and really lovely guy, i like it

here is mine

i write yuor name on the sand
and the breeze blew it away

when i write on water
it got washed away

when i write it in the sky,
the night covered it

when i write it on my heart
i got heart attack
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #2 on: February 12, 2009, 06:57 PM »

Quote from: abdulone on February 12, 2009, 01:05 PM
thats great and really lovely guy, i like it

here is mine

i write yuor name on the sand
and the breeze blew it away

when i write on water
it got washed away

when i write it in the sky,
the night covered it

when i write it on my heart
i got heart attack
LOL
True love surely do give lovers heart attack. Take heart. Love is pain. Love is life and death
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #3 on: February 13, 2009, 12:36 AM »

Quote from: rotimy on February 11, 2009, 07:06 PM
You be  de correct sugar for my garri,
And I love you pass all girls for Warri.
You be de apple for my own eyes,
If no be you I go die frozen like ice.
You dey homely like ofada rice,
We no go fight again like cat & mice.
You be my ogbenga orishirishi for egusi soup,
Soon I go buy for you a mercedes coupe.
You be the only Christmas clothe for my wardrope,
If you leave me,walai, I go hang myself with a rope.
My endless love & African angel with you I no fit sleep,
Even my own people say you don turn me to a sheep.
At this season of Valen-wetin and always,
My bodi,heart, & pocket na for you always.

bros, abeg u try
if i be your babe i for dyyee
'cos dis kain love fit kill
e sweet pass jack n jill
dis one dem say u turn to sheep
hope say for night u dey sleep?
no worry, if she no want u dis valentine
i get one small sister wey too fyyynnnee . . . .


u go like? Grin

no mind me o, all na psyche!!!



i dig your poem no be small sha . . .
make i tiff am for my val na . . . ?Tongue
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #4 on: February 13, 2009, 01:03 PM »

Quote from: maedan on February 13, 2009, 12:36 AM
bros, abeg u try
if i be your babe i for dyyee
'cos dis kain love fit kill
e sweet pass jack n jill
dis one dem say u turn to sheep
hope say for night u dey sleep?
no worry, if she no want u dis valentine
i get one small sister wey too fyyynnnee . . . .


u go like? Grin

no mind me o, all na psyche!!!



i dig your poem no be small sha . . .
make i tiff am for my val na . . . ?Tongue

I trip for your poem poem.
I like am pass suya & isi ewu!
Why your small Sista when we go be Vals?
A beg, use me as a stand by generator in case your powe holding hold the power!
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #5 on: February 13, 2009, 05:28 PM »



Grin Angry

No need for generator lai lai
my own na solar power!!   Cheesy

  no more fine sista for u again
   u no rhyme well at all 2day!!
olulu (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #6 on: February 13, 2009, 05:50 PM »

Quote from: maedan on February 13, 2009, 05:28 PM

 Grin Angry

No need for generator lai lai
 my own na solar power!! Cheesy

 no more fine sista for u again
 u no rhyme well at all 2day!!


lol Grin Grin Grin Grin

omoge , fine sista,
go easy on d brother,
no b everytime he go fit rhyme tight,
no even rhyme right,
d tin no easy like that,
abi, u get 9 lives like cat?
give am your sista,
and she go love no other,
everybody deserves a 2nd chance,
d guy can't afford to not eat dat yam

 Grin Grin Grin
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #7 on: February 13, 2009, 06:15 PM »

Quote from: maedan on February 13, 2009, 05:28 PM

 Grin Angry

No need for generator lai lai
 my own na solar power!! Cheesy

 no more fine sista for u again
 u no rhyme well at all 2day!!

How you come say you no need a generator?
When some men love dey quench like terminator.
At noon the love go over-load with solar power,
But for night, e go blackout like NEPA power.
Your fine sista I for true true like to take,
But now her hand I must try to forsake.
Bride price high well well for Auchi,
Make I manage Aisha wey dey Bauchi!
You fit apply,
And I go reply.
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #8 on: February 13, 2009, 06:19 PM »

Quote from: olulu on February 13, 2009, 05:50 PM

lol Grin Grin Grin Grin

omoge , fine sista,
go easy on d brother,
no b everytime he go fit rhyme tight,
no even rhyme right,
d tin no easy like that,
abi, u get 9 lives like cat?
give am your sista,
and she go love no other,
everybody deserves a 2nd chance,
d guy can't afford to not eat dat yam

 Grin Grin Grin
Thanks o jare. Man know man. I go dey rhyme all the time? I be Wole Soyinka or Achebe?
For your defence and effort, I go dash that her fine sista. Ebi like say you sabi eat yam.
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #9 on: February 13, 2009, 06:28 PM »

Quote from: rotimy on February 13, 2009, 06:15 PM
How you come say you no need a generator?
When some men love dey quench like terminator.
At noon the love go over-load with solar power,
But for night, e go blackout like NEPA power.
Your fine sista I for true true like to take,
But now her hand I must try to forsake.
Bride price high well well for Auchi,
Make I manage Aisha wey dey Bauchi!
You fit apply,
And I go reply.

ehen, na now u dey talk beta
u sure say your lv na all weatha?
anyway, na your scope i like
u sef, u no fit know psyche?
i dey play na, how i go give u my precious sista
u fit be one serious playa mister!!! Grin

Quote from: olulu on February 13, 2009, 05:50 PM

lol Grin Grin Grin Grin

omoge , fine sista,
go easy on d brother,
no b everytime he go fit rhyme tight,
no even rhyme right,
d tin no easy like that,
abi, u get 9 lives like cat?
give am your sista,
and she go love no other,
everybody deserves a 2nd chance,
d guy can't afford to not eat dat yam

 Grin Grin Grin

na my sister u dey call "yam?"
bros, make u stop am!! Grin
luv is more than dat
no be game of mouse n cat!! Cheesy
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #10 on: February 14, 2009, 07:49 PM »

Quote from: maedan on February 13, 2009, 06:28 PM
ehen, na now u dey talk beta
u sure say your lv na all weatha?
anyway, na your scope i like
u sef, u no fit know psyche?
i dey play na, how i go give u my precious sista
u fit be one serious playa mister!!! Grin
Cheesy
I must tell you say I no be playa
I just dey Church dey holla my prayer.
I dey ask Baba make E butter my tea
And bless me always in land,air and sea.
For true,I go prefer you to your little sista,
 Make two adults tango go dey better.
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #11 on: February 14, 2009, 08:02 PM »

lolxxx

u be longthroat no be small
u no wan hear word at all at all
how i go fall 4 brand new toaster
no be say u be d main kokomaster Cheesy

i tiff your poem give my boo, no vex
i also send am to all mypals by text
hope say e no get copyright
bc dat 1st poem dey v. tight . . . Grin
olulu (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #12 on: February 16, 2009, 08:31 AM »

Quote from: maedan on February 14, 2009, 08:02 PM
lolxxx

u be longthroat no be small
u no wan hear word at all at all
how i go fall 4 brand new toaster
no be say u be d main kokomaster Cheesy

i tiff your poem give my boo, no vex
i also send am to all mypals by text
hope say e no get copyright
bc dat 1st poem dey v. tight . . . Grin

since d guy flow tight
and rhyme right,
u come trip
and u let your guard slip
kuku enter d place,
run d race
make we see fit u no go carry belly two,
but, hope would not make u after two ? Grin Grin Grin

Quote from: rotimy on February 13, 2009, 06:19 PM
Thanks o jare. Man know man. I go dey rhyme all the time? I be Wole Soyinka or Achebe?
For your defence and effort, I go dash that her fine sista. Ebi like say you sabi eat yam.

i've got your back
u will feel no lack


Quote from: maedan on February 13, 2009, 06:28 PM
ehen, na now u dey talk beta
u sure say your lv na all weatha?
anyway, na your scope i like
u sef, u no fit know psyche?
i dey play na, how i go give u my precious sista
u fit be one serious playa mister!!! Grin

na my sister u dey call "yam?"
bros, make u stop am!! Grin
luv is more than dat
no be game of mouse n cat!! Cheesy

i no call your sista yam
so keep calm
but tell me, is she really dat fine?
abi u just cook up dat line?




rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #13 on: February 16, 2009, 01:58 PM »

Quote from: maedan on February 14, 2009, 08:02 PM
lolxxx

u be longthroat no be small
u no wan hear word at all at all
how i go fall 4 brand new toaster
no be say u be d main kokomaster Cheesy

i tiff your poem give my boo, no vex
i also send am to all mypals by text
hope say e no get copyright
bc dat 1st poem dey v. tight . . . Grin

Walai talai, I no get am for big longthroat,
Only say I dey over-honest as if I swear oath.
I no be kokomaster but correct lover- master,
And I day stick to friends like I be plaster.
I no vex you send my poem without copyright,
Don't forget say love dey like onions at 1st bite,
E go make you sneeze or cry,
But with me, we go just  fly!
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #14 on: February 17, 2009, 03:13 AM »



@ rotimy  Smiley

my guy dis is getting curious
i no believe say u dey serious
valentine don go since now
its high tym we take a bow
but since u say u be gud friend
make we stick dat way till d end. . . . Cheesy
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #15 on: February 17, 2009, 03:28 AM »

 @ olulu  Angry

  na true i talk from day one
  my sis dey fine n bright like sun
  e be like say u like 2yab
  but me too get quick upper jab
  anyway i no wan fight
  u sef u dey rhyme tight 
  (even tho' u get serious bad mouth . . . Grin)
 
 
olulu (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #16 on: February 17, 2009, 08:32 AM »

Quote from: maedan on February 17, 2009, 03:28 AM
@ olulu  Angry

  na true i talk from day one
  my sis dey fine n bright like sun
  e be like say u like 2yab
  but me too get quick upper jab
  anyway i no wan fight
  u sef u dey rhyme tight 
  (even tho' u get serious bad mouth . . . Grin)
 
 


i no fit fight woman,
afterall, u dey in dis world to serve man,
u think i like to yab?
and u can shut me up with your jab?
hey, go easy,
don't lets get messy.
u even say  i get bad mouth
well, by dis end of month
na dat same mouth
u go dey kiss on top couch  Grin


 
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #17 on: February 17, 2009, 06:08 PM »

Quote from: maedan on February 17, 2009, 03:13 AM

@ rotimy Smiley

my guy dis is getting curious
i no believe say u dey serious
valentine don go since now
its high tym we take a bow
but since u say u be gud friend
make we stick dat way till d end. . . . Cheesy

Who come dey talk say Valentine don pass?
Every day na for true lovers wey get class.
I no be Police or soja wey go take a bow
My love dey plenty like furafor Fulani cow.
My heart dey jolly  as U say we go  be good friends till end,
But I dey fear say like Naija babes your word go soon bend.
Asssure me you no go try break my heart,
Na only then I go truly throw in my hat.
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #18 on: February 17, 2009, 06:26 PM »

Quote from: olulu on February 17, 2009, 08:32 AM

i no fit fight woman,
afterall, u dey in dis world to serve man,
u think i like to yab?
and u can shut me up with your jab?
hey, go easy,
don't lets get messy.
u even say i get bad mouth
well, by dis end of month
na dat same mouth
u go dey kiss on top couch
Grin
 

OLULU
OLULU
OLULU
How many times I call you name?
True  true I no sabi your game!!
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #19 on: February 17, 2009, 10:29 PM »

  @ rotimy
 

  i know say u be beta person
  wey we fit trust for any season
  even if na e-love, nothing spoil
  at least e good to ease d toil
  na true say whether na valentine or wintertime
  correct couples need to flow n rhyme
  so make we jolly dey go
  with this our pidjin love show . . . Kiss
 
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #20 on: February 17, 2009, 10:39 PM »



 @olulu

  see me see palaver
  i think say u come enter as observer
  i even manage to swallow your yabs
  i come dey hail u for your vocabs
  now u don show your true colour
  kiss 4 couch ni, kiss 4 couch ko.  Cheesy
 
olulu (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #21 on: February 18, 2009, 09:45 AM »

Quote from: maedan on February 17, 2009, 10:39 PM

 @olulu

 see me see palaver
 i think say u come enter as observer
 i even manage to swallow your yabs
 i come dey hail u for your vocabs
 now u don show your true colour
 kiss 4 couch ni, kiss 4 couch ko. Cheesy
 

well,
if i kiss u, u suppose happy,
u think say na like kiss of those small boys still wearing nappy?
i only wanted to help your condition, Tongue
b4 u enter frustration.
but no yawa,
as u don talk like a typical mama tawa,
i withdraw my offer,
but no come beg me after
 Grin Grin Grin
olulu (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #22 on: February 18, 2009, 09:49 AM »

Quote from: rotimy on February 17, 2009, 06:26 PM
OLULU
OLULU
OLULU
How many times I call you name?
True true I no sabi your game!!



coolu temper,
i no dey tamper,
olulu na my name,
being a playa na d game,
but i no dey collect your woman,
after all, for dis forum u b d main man
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #23 on: February 18, 2009, 11:23 AM »



chei, for nairaland i don suffer
dis bros O wan make i run 4 cover
i come for peace, na him start war
dis forum of love e don make am curve
bend go a wrong slide
well, we go meet for d dark side
u think say u be player
wen u only sound like hater  Grin
dis valen-wetin no dey 4 u rara
as u come call me mama tawa

i talk am say your mouth no good
look as u dey yarn like boy from 'hood
na u gangan get d frustration
i don make u lose concentration
if u beg well well i fit pity u
turn u into my next mumu
but as u no get taste,
my time i no go waste
just leave me and my rotimy matter  Cheesy
b4 my luv-stylee make your head scatter

$Iceee$ (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #24 on: February 18, 2009, 11:31 AM »

DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #25 on: February 18, 2009, 12:28 PM »

Quote from: $Iceee$ on February 18, 2009, 11:31 AM
DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt


nice 2 c another ryhming sista
dnt mind the Olulu mista
turnin' me to a fighter
when i'm truly a peacemaker! Grin
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #26 on: February 18, 2009, 12:37 PM »

Quote from: maedan on February 17, 2009, 10:29 PM
@ rotimy
 

 i know say u be beta person
 wey we fit trust for any season
 even if na e-love, nothing spoil
 at least e good to ease d toil
 na true say whether na valentine or wintertime
 correct couples need to flow n rhyme
 so make we jolly dey go
 with this our pidjin love show . . . Kiss
 
One fine female singer wey get big bobby,
Talk say love wey be true no be for puppy.
She say love dey flow and float like butterfly,
Which mean say na patience one go apply.
Weather e-love,v-love or even sef 365-love,
I go tanda like rock and dey gentle like dove.
E dey do me for heart say you go dey always talk true,
Dat's why I wan flow and see this love show through!
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #27 on: February 18, 2009, 12:47 PM »

Quote from: $Iceee$ on February 18, 2009, 11:31 AM
DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt

Eninem no rhyme pass our own Tuface,
Naija get talents wey dey set de pace!!
You talk say your username na Iceee,
If u be rapper or rhymer we go soon seee.
olulu (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #28 on: February 18, 2009, 12:51 PM »

Quote from: maedan on February 18, 2009, 11:23 AM

chei, for nairaland i don suffer
dis bros O wan make i run 4 cover
i come for peace, na him start war
dis forum of love e don make am curve
bend go a wrong slide
well, we go meet for d dark side
u think say u be player
wen u only sound like hater Grin
dis valen-wetin no dey 4 u rara
as u come call me mama tawa

i talk am say your mouth no good
look as u dey yarn like boy from 'hood
na u gangan get d frustration
i don make u lose concentration
if u beg well well i fit pity u
turn u into my next mumu
but as u no get taste,
my time i no go waste
just leave me and my rotimy matter Cheesy
b4 my luv-stylee make your head scatter




pity me?
when na u dey beg to b with me.
i b d original player,
and i know say u go like b my bed partner,
i for help your matter,
and do u well well for your under,
but u fit go mess up my quarters
since u still b bed wetter.
and your kind sister,
no sabi love matters,
na when u c money,
u go come try b d person honey.
so go away with your wahala,
but i vex cause kasala. Grin Grin Grin


Quote from: $Iceee$ on February 18, 2009, 11:31 AM
DANG!!!!!!!!!
d flows' craziiiiiiiii
y'all make eminem seem laziiiiiiiiiiii
keep d rymz ryt
dis thang's soooooooooo tyt


i feel u girlfriend


Quote from: maedan on February 18, 2009, 12:28 PM
nice 2 c another ryhming sista
dnt mind the Olulu mista
turnin' me to a fighter
when i'm truly a peacemaker! Grin

lol
oya i no fight again,
since my love u no fit gain,
and if i don cause u pain,
no seek me to slain,
so go deal with your love matters,
but abeg, no do love for corner corner
Moyola (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #29 on: February 18, 2009, 12:54 PM »

hehe! weldun yu lot! Cheesy
rotimy (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #30 on: February 18, 2009, 01:09 PM »

Quote from: Moyola on February 18, 2009, 12:54 PM
hehe! weldun yu lot! Cheesy
Ah, thank you Moyola!!
Here we no get wahala
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #31 on: February 19, 2009, 01:09 PM »

Quote from: rotimy on February 18, 2009, 01:09 PM
Ah, thank you Moyola!!
Here we no get wahala

yes o, true true wahala we no get
na only one troublemaker make us forget
d real purpose of this sweet thread
but devil is a liar, 'im go regret
d day e try disturb true vals Cheesy
who don dey turn into real pals
so rotimy, how u dey
hope u still tanda as u say
abi d love don dry  Embarrassed
or u wan make i cry
well, friend in need na friend indeed
remember say u don plant d seed
make u no slack make e turn to weed . . .  Grin
 Short Story Contest: Tuneh Won  Best African Author: Wole Soyinka or Chinua Achebe?  Poetry Contest  Page 2
Pages: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) ... (25) Go Up Send Topic to Friend by E-mail Reply 


Sections: Autos/Cars (2) Jobs/Vacancies (2) (3) Career Talk Education General(2) Politics Romance Computers Phones Travel
Sports Fashion Health Religion Celebrities TV/Movies (2) Music/Radio (2) Books Webmasters Programming

Links: Page1 Page2 Page3 Page4 Page5 Page6 Page7 Page8 Page9 Page10

Nairaland is owned by Oluwaseun Osewa. See also: Nairalist Classified Ads
Nairaland Forum | Powered by SMF 1.0.12.
© 2001-2005, Lewis Media. All Rights Reserved.