|
rotimy (m)
|
FOR MY MAEDAN
When you think say our time go come? We go dey worried when to make a home. We de move from valen-thing de go Easter, And one fine lady dey eye me wey be Esther!
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
FOR MY MAEDAN
When you think say our time go come? We go dey worried when to make a home. We de move from valen-thing de go Easter, And one fine lady dey eye me wey be Esther!
lol . . . which Esther, which eye abi she wan dye  make she stop to dey looku looku or she go feel some chuku chuku  wit my roty sweety i no dey play our tym dey near, e no go tey just dey exercise patient u no say we stil dey for lent!! 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
lol . . . which Esther, which eye abi she wan dye  make she stop to dey looku looku or she go feel some chuku chuku  wit my roty sweety i no dey play our tym dey near, e no go tey just dey exercise patient u no say we stil dey for lent!!  I dey worried because e go good if we plan for this lent, I dey jolly say I don fin a big house & come pay de rent. I don take style de put things wey you go like for de house. Thank God I don comot for de other house I shared with mouse! Dis new one get very big fine kitchen with good air-condition, You go relax there dey cook and dey smile with satisfaction!! De bedroom get fine bed wey I cover with sheet wey dey pink, Aaaaa, we go dey relax and our two hearts go be one love link.
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
I dey worried because e go good if we plan for this lent, I dey jolly say I don fin a big house & come pay de rent. I don take style de put things wey you go like for de house. Thank God I don comot for de other house I shared with mouse! Dis new one get very big fine kitchen with good air-condition, You go relax there dey cook and dey smile with satisfaction!! De bedroom get fine bed wey I cover with sheet wey dey pink, Aaaaa, we go dey relax and our two hearts go be one love link.
dis one u organise bed wey pink, wetin u wan make i tink!  d air-condition kitchen dey nice but e go turn our hot fufu to ice i don tell u say i no mind your status rich, poor, e no go affect us make u dey continue to plan i know say u no be talk-talk but action man! 
|
|
|
|
|
|
firestar (f)
|
Rotimi make yu take am small small
Dis one wey yu yarn so - yu apply for Guinness records?
|
|
|
|
|
|
Akaraoku$ (f)
|
@ Maedan, You're too much , i dig your style GF
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
@ Maedan, You're too much , i dig your style GF
thanks, babe!  . Na rotimy teach me o. 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
Rotimi make yu take am small small
Dis one wey yu yarn so - yu apply for Guinness records?
E mean say you dey follo our love tory, Rotimy and Maedan dey do e-love story. Madean like Rotimy and say she wan be in wife, But Rotimy no get money but wan give him life!! Now things don better for the country man, Na im e take excitement de tell d woman.
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
dis one u organise bed wey pink, wetin u wan make i tink!  d air-condition kitchen dey nice but e go turn our hot fufu to ice i don tell u say i no mind your status rich, poor, e no go affect us make u dey continue to plan i know say u no be talk-talk but action man!  If you like pink I fit change the bedsheet to red, But e good say status no dey enter your head. I do tell Esther say vacancy no dey my heart, Make she go another man's house put her hat!
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
thanks, babe!  . Na rotimy teach me o.  Make you no mind am, without her poems wey de fine. I no think say I go fit think at all & write even one line!
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
E mean say you dey follo our love tory, Rotimy and Maedan dey do e-love story. Madean like Rotimy and say she wan be in wife, But Rotimy no get money but wan give him life!! Now things don better for the country man, Na im e take excitement de tell d woman.
see as u dey talk like say na me toast u  na so all u men for naija dey do once girl don gel, u come get mouth people go hear from north to south i no mind sha, say u dey boast at least for naija love rhymes na u rain most u start am well, so finish well i send u big time, but make your head no swell 
|
|
|
|
|
|
olulu (m)
|
@rotimy and maedan 9ice,  as i dey read my heart dey beat fast  i for even like be part of d cast,  but they say i get bad mouth,  and i too like fight like tout  so i just kuku siddon look feelin d line una dey cook i c two heart wey dey beat as one,  and 2 bodies wey wan merge into one  abi e neva reach dat level? una still dey on toasting level. anyway, i dey gbadun d love show e dey make my heart beat slow, as if i lie down for snow, but na d end i go like to know 
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
@rotimy and maedan 9ice,  as i dey read my heart dey beat fast  i for even like be part of d cast,  but they say i get bad mouth,  and i too like fight like tout  so i just kuku siddon look feelin d line una dey cook i c two heart wey dey beat as one,  and 2 bodies wey wan merge into one  abi e neva reach dat level? una still dey on toasting level. anyway, i dey gbadun d love show e dey make my heart beat slow, as if i lie down for snow, but na d end i go like to know  e be lyk say your mouth don change  your new good attitude dey v. strange but i hapi say u don see d light becos, e dey bad 2 always fight  u fit join us, to put more spice  just add your spoon 2 chop our sweet love rice but keep am for mind, rotimy na d main guy if u tink u wan take over, bros, na lie!  no worry your head which level we dey like joke like play, we fit marry 4 May!!!
|
|
|
|
|
|
olulu (m)
|
e be lyk say your mouth don change  your new good attitude dey v. strange but i hapi say u don see d light becos, e dey bad 2 always fight u fit join us, to put more spice  just add your spoon 2 chop our sweet love rice but keep am for mind, rotimy na d main guy if u tink u wan take over, bros, na lie!  no worry your head which level we dey like joke like play, we fit marry 4 May!!! una show i for like to join,  since no need to pay coin. but i no dey pursue women again  cause i no dey see d gain.  cos now na women dey seek me out  in order to ask me out,  cos i b a self made man,  d dream of all fine fine woman.  i no go even wan rock una love boat  since rotimy don dey sew him wedding coat, make una continue una love show, make i just siddon dey feel d flow 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
see as u dey talk like say na me toast u  na so all u men for naija dey do once girl don gel, u come get mouth people go hear from north to southi no mind sha, say u dey boast at least for naija love rhymes na u rain most u start am well, so finish well i send u big time, but make your head no swell  I de offer apology for my mouth wey dey open like doughnut Forgive If my mouth run pass dat of tory-teller Basketmouth, Because if we start carry face now,my sugarcane,we go gain nut, Make you 4get I dey beg on my knees with a flower coconut!
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
una show i for like to join,  since no need to pay coin. but i no dey pursue women again  cause i no dey see d gain.  cos now na women dey seek me out  in order to ask me out,  cos i b a self made man,  d dream of all fine fine woman.  i no go even wan rock una love boat  since rotimy don dey sew him wedding coat, make una continue una love show, make i just siddon dey feel d flow  Good pretty wife like Maedan na correct gift from yonder, I dey thank Baba God well well say you no put assunder. Make you dey jolly with us as we prove love to be a wonder, No be a thing wey person go dey fight with fire & thunder!
|
|
|
|
|
|
firestar (f)
|
Rotimi na true yu yarn jare
Guguru ati ekpa I dey chop look dis duet yu cal play
Any k-leg for dis naija loff rhymes, hhen- witness dey!
Make una dey carry go, My own go soon come, lai-lai by Jah's will e no go tey.
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
Rotimi na true yu yarn jare
Guguru ati ekpa I dey chop look dis duet yu cal play
Any k-leg for dis naija loff rhymes, hhen- witness dey!
Make una dey carry go, My own go soon come, lai-lai by Jah's will e no go tey. Amin oooo, Oluwa Jesu don sign am, Before June 12, Walai, you go get am
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
I de offer apology for my mouth wey dey open like doughnut Forgive If my mouth run pass dat of tory-teller Basketmouth, Because if we start carry face now,my sugarcane,we go gain nut, Make you 4get I dey beg on my knees with a flower coconut!
i don tire to dey laff sotey my neck long like giraffe ok, i don forgive u i no fit vex sef for my boo but which one be coconut, we dey for forest? abi u b dose guys wey dey form dem b d poorest? just 2 avoid to spend 4 dem wife dem go do lyk say no kobo for dia life  i trust u sha, u go dey spend well well both before and after i don gel! 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
i don tire to dey laff sotey my neck long like giraffe ok, i don forgive u i no fit vex sef for my boo but which one be coconut, we dey for forest? abi u b dose guys wey dey form dem b d poorest? just 2 avoid to spend 4 dem wife dem go do lyk say no kobo for dia life  i trust u sha, u go dey spend well well both before and after i don gel!  Flower na for Oyibo dem people, Which dem dey offer people wey give dem pimple! But we for Africa no dey pretend and wan make matters simple. Coconut wey you offer person na sign of peace you wan to seriously sample. Coconut wey two break 2gether, eat 2gether and drink im water go make hearts no crumble!
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
Flower na for Oyibo dem people, Which dem dey offer people wey give dem pimple! But we for Africa no dey pretend and wan make matters simple. Coconut wey you offer person na sign of peace you wan to seriously sample. Coconut wey two break 2gether, eat 2gether and drink im water go make hearts no crumble!
if na true u talk, den no be one coconut we go chop make am 100, so d love go neva stop  afterall, some girls dey use love potion but in my case, i go use love lotion rub am 4 my sweety's chest  so without my love, e no go rest na dis one dem dey call sweetheart insurance to keep my roty, i go need permanent assurance!!! 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
if na true u talk, den no be one coconut we go chop make am 100, so d love go neva stop  afterall, some girls dey use love potion but in my case, i go use love lotion rub am 4 my sweety's chest  so without my love, e no go rest na dis one dem dey call sweetheart insurance to keep my roty, i go need permanent assurance!!!  As we don prove to the nairalanders say we dey in love, E go dey good if we hand am over to Baba wey dey above. I don fall yakata for you so you no need love portion or lotion, All we go need na honesty & trust wey go put our love for motion.
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
As we don prove to the nairalanders say we dey in love, E go dey good if we hand am over to Baba wey dey above. I don fall yakata for you so you no need love portion or lotion, All we go need na honesty & trust wey go put our love for motion.
Yes o, Baba above own na d best Him kind love go put u at rest so no need to fear, i no go charm u  my hand no fit to ever harm u since u don choose me as your choice  u no go ever lose me or miss my voice 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
Yes o, Baba above own na d best Him kind love go put u at rest so no need to fear, i no go charm u  my hand no fit to ever harm u since u don choose me as your choice  u no go ever lose me or miss my voice  We go make sure say dat dis our love song is undending, As we be one voice & one choice we go march without bending. Last night, my Mama asked when we dey plan our wedding, I tell say na only my honey Maedan can unveil the timing.
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
We go make sure say dat dis our love song is undending, As we be one voice & one choice we go march without bending. Last night, my Mama asked when we dey plan our wedding, I tell say na only my honey Maedan can unveil the timing.
tell our mama say d time dey soon for one bright sunny day at half past noon any one wey object, make dem talk now or hold dia peace, for dat day we go take d vow! 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
tell our mama say d time dey soon for one bright sunny day at half past noon any one wey object, make dem talk now or hold dia peace, for dat day we go take d vow!  You get send the lists and price of things you go need, So that I can see how we plan and de amount to spend. I go like make U look dat day like a Princess in wedding gown, A pretty bride wey dey shine and on her head dey a fine crown! I go wear original oyibo suit and go de smile like a king, We no forget say dat wedding no dey complete without a ring! I dey think say Olulu go wan be my best man dat sunny day, But I fear say He go first try to kiss the bride b4 I say "hey".
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
You get send the lists and price of things you go need, So that I can see how we plan and de amount to spend. I go like make U look dat day like a Princess in wedding gown, A pretty bride wey dey shine and on her head dey a fine crown! I go wear original oyibo suit and go de smile like a king, We no forget say dat wedding no dey complete without a ring! I dey think say Olulu go wan be my best man dat sunny day, But I fear say He go first try to kiss the bride b4 I say "hey".
na everytym u go make me laff! i hapi say u b my beta half  e be like say u go be good husband wey go carry me go honeymoon 4 jand u go fine well well for your designer jacket me too go pose as i carry my flower basket e no easy to find a caring, charming groom so i go chase comot any rival wit big broom!! 
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
na everytym u go make me laff! i hapi say u b my beta half e be like say u go be good husband wey go carry me go honeymoon 4 jandu go fine well well for your designer jacket me too go pose as i carry my flower basket e no easy to find a caring, charming groom so i go chase comot any rival wit big broom!!  As you come mention honeymoon, I dey happpy e go come very soon. I wan make we go do de honeymoon and sun for Dubai, But from tory I hear, we go see fine things we no fit buy. I don dey consider de country dem de call England, But the wahala go be the visa wey we go take land. So as to explore Naija, we go spend am for Calabar, After that we go stop and greet my senior sista at Aba
|
|
|
|
|
|
rotimy (m)
|
na everytym u go make me laff! i hapi say u b my beta half e be like say u go be good husband wey go carry me go honeymoon 4 jandu go fine well well for your designer jacket me too go pose as i carry my flower basket e no easy to find a caring, charming groom so i go chase comot any rival wit big broom!!  As you come mention honeymoon, I dey happpy e go come very soon. I wan make we go do de honeymoon and sun for Dubai, But from tory I hear, we go see fine things we no fit buy. I don dey consider de country dem de call England, But the wahala go be the visa wey we go take land. So as to explore Naija, we go spend am for Calabar, After that we go stop and greet my senior sista at Aba
|
|
|
|
|
|
pureminded (m)
|
 Nice Rhymesssssss
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
As you come mention honeymoon, I dey happpy e go come very soon. I wan make we go do de honeymoon and sun for Dubai, But from tory I hear, we go see fine things we no fit buy. I don dey consider de country dem de call England, But the wahala go be the visa wey we go take land. So as to explore Naija, we go spend am for Calabar, After that we go stop and greet my senior sista at Aba
u don come again, which one be Calabar u go soon say make we do am for Yaba i no wan hear am for dis our honeymoon if no be oversea, d wedding go postpone 2 June as in, June two thousand and ten by then u go don save enuf dollar n yen  i don try for u now, i no demand much but til u take me go abroad, na look but no touch! 
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
 Nice Rhymesssssss many thankssssss 
|
|
|
|
|
|