|
maedan (f)
|
 @FL Gators, I sure say him no lie say im dey single Or why else he go dey come here dey mingle As u can see, he don give you im preference In fact, he come take YOU as point of reference  So quick quick, I hope u get twin or maybe even clone Wey you go give adebayo201 to be d bone of him bone 
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Dat 1 kno b crime, 2 b hukd 2 a prime, God don show me d way, i wil neva mak u go astray, u see say d tin don dey reflect, to say i kno fit sleep corect, i post arund afta 1, u rply dat afta 1,  shai, i kno go vigil, kno b say i dey ill, bt dat fink dey disturb me, to say i decid 2 see your hymn, shey u kno lyk 'am, meadan nd semid b padi, u nd me go dey joli, abi aw u see dat point, 
|
|
|
|
|
|
|
|
RuuDie (m)
|
like play, like play, i don dey old, na so time dey carry me go and i still dey find, looku looku efri'wh'ia, for dat chic'alla wen be my own.
dis wan no be joke, but like sey na film trick, i still dey siddon look, efri'bodi dey carry eye enter market, me remain like sigidi, put stone inside pot to boil.
dis na very serious matter oh, shuo whish levels with me so? shey na becuz i no fine, abi i no gree sabi yarn, d thin' don tire me pass mark, sotey wetin remain na "i no know."
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Oga ruud, i kno dat u'r gud, u see_nawa dayz babes, no wan giv guyz facez, aw many times i don talk 2 fl gators, she stil dey send me rhyme_terminators, she talk say she don get prime, wey me bcoz of her don already commit crime, i tink to say i cum dey cry, doktor Seun confirm say my bone don dey dry, i'm ready 2 du anytin 4 u, bcoz i dey support man u, abeg kno trow dat your rhyme arrow, na only u i want 2 dey see 4 my life rainbow. Fl Gators! Fl Gators!! Fl Gators!!!  :-C
|
|
|
|
|
|
RuuDie (m)
|
adebayor, j'owo coolu temper, ma' lo kpa ra e lori kini yi oh, shebi o' ti so' fun e kpe o ti ni eni'kan t'owun fe, abi o fe ki o'ko e, wa da bi'ba'i ru? well, nkan ti ma so' fun e ni'kpe, ko ni'suru fun, mi o' le kparo fun e, paddy ati ManU fans ni wa, su'gbon aw'on ebi wa ti so' w'in kpe, ee'fe o'kin sh'ey ee'ja, ti obirin ba like e, oma gba fun e, but o' la ti ni'suru fun, je'je l'aiye, je'je no ni o'ro ee'fe, ni'nu kini yi ti o'ba gbe ikpo'kini, ko'si nkan t'o buru n'be infact, o' ma pay e ju, because oni shey ra e le'shey, so paddy mi, shey solo, asiko olukaloko shi ma'de to ba like e' gan, o' ma du'ro de', jo'wo ma te'ley di'e di'e. . . . . . . . . . . . .
Abeg no vex, Yoroba no be my mama language hope sey i make small sense sha. . . . . lol
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
@ruudie, I don hear u, bt lik man u, we get al we want by pawa, and me kno bi mama tawa, wey dey sell rice 4 luth, i b correct yuth, atleast, she suppose reply, my broda fink say i don dey ly, babe, chek my calendar, d luv sweet pas sugar, i tin don dey du me yori_yori, nd me no b guy 4rm warri, just reply me, abi until i sing church hymn 
|
|
|
|
|
|
FL Gators
|
Oga ruud, i kno dat u'r gud, u see_nawa dayz babes, no wan giv guyz facez, aw many times i don talk 2 fl gators, she stil dey send me rhyme_terminators, she talk say she don get prime, wey me bcoz of her don already commit crime, i tink to say i cum dey cry, doktor Seun confirm say my bone don dey dry, i'm ready 2 du anytin 4 u, bcoz i dey support man u, abeg kno trow dat your rhyme arrow, na only u i want 2 dey see 4 my life rainbow. Fl Gators! Fl Gators!! Fl Gators!!!  :-C 
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Wetin b d meanin of dat TEETH 
|
|
|
|
|
|
|
|
RuuDie (m)
|
oh baby na u, only u can make my sky blue, blow 1 kiss cure ma bird flu, remix me sotey i turn new.
chei. . . . baby na u, only u i wan to be my boo, dey gum tight me so like glue, fit make me abandon ogbono and foo-foo.
egbe. . . . baby na u, only your food i wan see for menu, no be lie oh dis na true to God no wan fit ever do, biko, no deny jus say u luv me too.
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Me kno fit shout @oga ruudie.0 fl gators me kno nid your teeth just giv me your rhyme meat me dey hungry 
|
|
|
|
|
|
semid4lyfe (m)
|
Those flyin chickens don lose again And inflict on top me an unbearable pain Why be se things no just go our way? This match of all matches & 2day of all day Now, my supper I no go fit chop Because my appetite & morale don drop E be like se I go stop to dey watch our match After all, all our national teams just dey crash.
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
hmmmm 
|
|
|
|
|
|
McDoe (m)
|
I no fit commot my look frm you that's why i be like lucozade. everything thing about u dey spur me to action, that is why i dey churn out my unction. u be de rose wey dey inspire, and the reason i want to aspire. You be the one I love badly and the only one that cares for me like a buddie, nothing on earth can make me loose u, even everything will lost for your sake. my plea to youfor this valetine, is to accept my gift of violet . I want to say I love ya, like goat dey love yam. li
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
I stand stil kno kno wey tin i fit write, until i saw u standin by my right, let me b wit u, like a sheep and a ewe, your luv dey shak me like shepe, na e make me dey du lik Makelele, my frends cald me a brat, i tld dem dat i'm your female orifice cat, pls, turn me 2 your pillow, na only u i go dey follow, if my luv iz put inside prison 4 Alaka, walai, i swear i go turn 2 b a prison seeker, from they, u go kno say i b d man wey dem dey cal prison breaker,  me nd u kno nid revocation, in 2months tyme na 4 us 2 du convocation, 4rm Lagos City, 2 Manchester 'City' 
|
|
|
|
|
|
ravenzord (m)
|
E don tey wey I don enter dis place I dey busy dey hustle,tryna get outta d rat race But now I don come back make I show my face And my rhyming 4 2day na 2 sing my praise God create me,come give me d right 2 brag Cos I dey blessed,dat one nobody fit drag E no matter say my clothes no get Louis V tags Cos d one wey I get,I dey wear am with swag Now no get d impression say I dey go around feeling But I remember d time wey I dey spend my days dreaming Of how I go dey cool,but now I dey steaming (hot) I know say my rhyming s'poz dey in pidgin (but) This truth I've found: That my gifts abound, One of which is to speak thoughts so profound ,that great minds they enlighten and small minds they confound, so even if U feel bereft,got your soul on the ground, U'r gon' be lifted when u hear my sounds, cos they really are divine verses expressd by mortal mouth.
Happy independence day anniversary y'all.
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Amen,Amen,Amen, i open my eye i see myself 4 a tal hil, prayin 4 my nation on my kneel, God, wu iz goin 2 save uz, from diz pple wey cuk uz needle lyk nurse, dem dey climb uz dugbe_dugbe lyk Tufan horse, 9ja my papa land, wey ful of blaky lyk sand, dem talk say we b 49, wey we stil dey find our helpa go river nile, wat a pity! They cnt du deir duty, nation ful of human nd natural resources, bt we stil dey bak dey wear my stockings, wel sha, Gob bless 9ja, weda war or peace me i kno go ja, i go mak sure say i make am b4 i payin, i kno go let dem mak my lif wayin, Fellow 9ja, let rais d flag, mak we cary our freedom bag, coz I'M BLACK, I'M PROUD, I'M N_A_I_J_A. 
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
@ ravenzord, u really really hit the spot @adebayo201, you sef drop am like it's hot I always dey respect true patriotism Cos my luv for my country strong pass favouritism As we don finish to celebrate the independence anniversary Make we always remember to be a positive emissary Of the plenty good news wey go soon full our motherland And remember say, any foreign country wey we dey na contraband 
|
|
|
|
|
|
semid4lyfe (m)
|
9ja don nack 49 yrs but shey anythin' dey to celebrate? That na the big question wey we suppose dey debate Wetin we get to show for all these our independent 49 year? Apart from curruption, epileptic power, militancy & poor health care (etc) Sometimes I think the amalgamation was a mistake And on such occasions I wish Nigeria will just break See - our case don become very serious and critical And this in turn has made many Nigerians very cynical (like moi) I laugh everytime I hear 7 point agenda Becos to me all na noise & political propaganda Anyhow sha, I go give Yaradua the benefit of the doubt Afterall dem say em be academician & not a political tout Hmm - here is wishing Nigeria a happy 49th birthday I just hope our government would change its way
And sit down, govern well and not lead the country astray Finally, Make we just continue to dey pray To keep evil intentions 4 our country at bay.
|
|
|
|
|
|
RuuDie (m)
|
 shuo see men dey scatter ground, serious thing oh, no be lost and found, from all corner na ogbo'nge sound, e sweet pass cuz d thin' dey go round, mukulu melodies like were yam dey pound. . . . una no vex, me jus cross border, na kudi omo boy go find 4 side of d other, we need to arrange 4 father & mother, so dat dem no go too dey bother, na only dem dey, we no get another. . . .
|
|
|
|
|
|
RuuDie (m)
|
wetin i go do without your love? my church-mind don think am tire, still yet e neva do, na wan place i go jus dey motor wey no get tyre go too fast.
wetin i go do if u say u wan go? dis i no wan gree hear, but inside my mind i know e fit be, house wey dey on fire na small, my heart go da'ba'ru final-final.
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Dnt make me cry, inside my bones dey dry, see as evrybdy dey drop(rhymes), nt until i see or read your own i kno go chop, 9ja dey celebrate, we dey formulate, which day we go stop 2 calculate, i kno want diz agape luv 2 liquedate, 4 your eye i see y?, my own dey show fine, na only u, dnt mind semiu, na önly u, baby, dnt mind chinedu, na only u, your name Fl Gators. 
|
|
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Fatherland and or motherland al na join, mak we grab our löin, diz country must nt fall, if nt we go suffer 'am all, ppl dey shout say na government, government say na just the nation settlement, shey una dey comprehend, if nt better cum nd stand at diz end, ppl just 2 funny, dem say d country dey own money (debt), notin bad if dem self go borrow mony, al i kno iz dat 9ja na our surname, ourname na e b our username, yl our papa name na e b password, so let mak 9ja a beta home in diz part of d world. Gud morin, happy new SATURDAY
|
|
|
|
|
|
semid4lyfe (m)
|
I bin sabi one foolish & yeye guy like that Em case dey hopeless and em be useless brat The guy na also ogbanje and a certified retard Infact Yabaleft don confirm se the guy don run mad Na so so bush bush grammar em dey nack 4 all the thread But for em mind him get correct queen's english cred I don tell am se make em go take em medication Or better still make em enter mental institution Because em be living proof of the word ignorance Abeg make una come take am for special deliverance Before em case become critical and e too late Just incase una dey wonder, em name na Gaga4hate Even from em name sef una go know se em don go gaga And em be imbecile, M.U.M.U and a confirmed maga The guy be like those district 9 aliens from another planet So 4 now, I go sheath my sword cos em no be worthy oponent The guy is filth and not fit to be on cyberspace If dem born u well, enter here come show your face And u go see how I go quick put u 4 your place If u no do that thing wey u talk se u go do I repeat na holy thunder go fire you.
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Take it easy, i kno dat guy_just ful of satan fizzy, talk talk ful e mouth, wen dem born 'am na middle of month, oga semid point of correctiön, kno b say i b e fellow mechanization, e name na ogaga4luv, shai see name wey b lik loav, mak we settle diz matter, 'coz if mod yawa, i kno go happy, seein u goin out of diz rhymy. 
|
|
|
|
|
|
adebayo201 (m)
|
Take it easy, i kno dat guy_just ful of satan fizzy, talk talk ful e mouth, wen dem born 'am na middle of month, oga semid point of correctiön, kno b say i b e fellow mechanization, e name na ogaga4luv, shai see name wey b lik loav, mak we settle diz matter, 'coz if mod yawa, i kno go happy, seein u goin out of diz rhymy. 
|
|
|
|
|
|
FL Gators
|
Lol good morning y'all I see that you guys are having a ball writing about hatred, dislike and satan, no doubt have we forgotten what this thread was about? Where's the love? the sweet? the beds of rose? What's with this position of hatred that you guys pose? Has the thread lose its sweet aroma that draws one to read and post? No more can I smell the sweet aroma the thread used to boast 
|
|
|
|
|
|
maedan (f)
|
@FL Gators & co.
me sef no fit understand what went wrong d hatred wey dey pour for here too dey strong i understand say semid dey vex, i've been there b4 but na im even advise me to always overlook make anger no come hold person like hook I surely hope the bad mood go improve So we go continue our naija luv groove  
|
|
|
|
|
|
|
|
RuuDie (m)
|
5yrs don pass nah, And no wan fit reash u, Many egbedus don show, Cross many many water, Frog, toad, lizard i don kiss, Princess dem don do kongba dance, Door don open close, But dat hole still dey, And mouth don dry tey'lee, Wu'sai dat rain wan comot? Bad as e bad, I go dey wait.
|
|
|
|
|
|