Naija Love Rhymes For Valentine

Welcome. Please Login, Register, Or Activate! 
type your username and password to login
Date: November 21, 2009, 02:08 PM
430436 members and 297564 Topics
Latest Member: 86
Nairaland [Nigerian Forum] Home Help Search Who is currently online? Login Register
Nairaland Forum  |  Entertainment  |  Literature/Writing (Moderator: StephenP)  |  Naija Love Rhymes For Valentine
Pages: (1) ... (18) (19) (20) (21) (22) (23) (24) (25) Go Down Send this topic Notify of replies
Author Topic: Naija Love Rhymes For Valentine  (Read 9050 views)
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #736 on: October 06, 2009, 05:19 PM »

Yeh,
inside my rum i sit dey meditate,
haw me and u go elevate,
baby, i fink aw we go forwardate,
4 diz side of obodo wey bad tin don penetrate,
calculator i carry try to calculate,
haw many tymes i don try to kissiate,
bt doz guyz stil dey disturb to_say u kno get tym 2 regulate,
don worry, i'l mak sure i giv dem sum rhyme_educate,
inshort they must b isolate,
abi aw u see 'am
many tymes 4 my dream, i see u dey dedicate <my children>,
u see, your luv don dey contaminate,
to d xtend dat deir is no day i kno go decorate your face ,
your beauty dey mak me accelerate,
pls, shey u wan mak i debilitate Huh
Tym upon tyme na your name nd luv me and my frends dey debate,
shai, mak una see as her luv dey mak me liquedate,
even 4 my studies, i don dey decelerate.,
see as even i dey du mistake
.   
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #737 on: October 08, 2009, 06:48 PM »

Na ou'side i dey so,
Wen e go clear, i neva know.
Knock, knock na im i dey since,
Dis tori k-leg now no be beans.
To show me d way,
From wen we jam till today.
No be small road-block,
Like dem hol' me with padlock,
People say u don jazz RuuDie,
But na jus my turn 2 sort custom duty,
D shenke don dull me finish,
& her NL name na creamish!
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #738 on: October 09, 2009, 10:21 PM »

IMAO!

CREAMISH
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #739 on: October 28, 2009, 06:40 PM »

i enter no jam anybodi inside room,
shuo, how all man come take zoom!?
dis place been dey boom,
as oyibo go talk, e been don pass bloom,
but na e don enter matter of oyibo gloom,
area jus clear without even moto vrrrooom,
but nah e be like dem sweep am with broom,
e don resemble after war for khartoum,
bodi pepper me like wife wey loss im groom,
how we do sotey our thread doom!?

my bro & sis' dem in love,
correct people wen blend like glove,
as we mind pure like white dove,
make we try lift d thread up-up above,
no jus let we jolly fall burn inside stove,
dis kain flows we no fit see for palmgrove.


RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #740 on: October 28, 2009, 06:43 PM »

i waka sotey where i reash,
when i look look finish,
na only u i dey see. . . .
no matter how soap panic my eye,
or alu'bosa wan comot d tears finish,
baby still yet,
na only u i dey see. . . . .
even when i dey h die,
longa throat hook me for coo'ro,
na only u i dey see. . . .
make alarm tear me pieces,
money take shine,
pally dem shyte for shursh,
na only u i dey see. . . .
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #741 on: October 29, 2009, 01:06 PM »

e start like play,
now if e pass wan day,
im go do me like na since may,
anytime we jam i dey halla "hooray"
pesin try u i can can'tab am with shoo'lay,
i don fall in luv & no be today,
e been dey grow now e don tey,
like we been dey run marathon relay
how u snash my heart with no delay,
e don reash to shout ole',
wether with calabar or bob-marley,
inside buba-shokoto or designer donnay,
u rub ororo or oil of olay,
your beauty pass money wey i no fit repay,
if no be u then na which way,
all dis no be scopes kpere i jus say,
baby na u i go luv u till head gray,
and even wen i don die throwey!
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #742 on: October 29, 2009, 08:06 PM »

When i read your post, i dey delight,
b4 i go kno my papa don on generator light,
semid, maedan,fl gatorz and even u mr ruud,
it'z high tyme wen put on our rhyme mood,
as una see,
diz thread don dey go sea,
any aw e wön b,
i go mak sure say i du my part b,
u dey lauf,
ok, mak i kno rouf,
wey tin i dey talk,
yeh my tongue don stalk.
Finaly, mak we start,
semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #743 on: October 29, 2009, 08:46 PM »

Ruudie 'n'Adebayo, una do well - oya, pass me the mic
See as una don make my emotions dey soar like kite
Sorry se I go a.w.o.l on top this our pidgin thread
No b my fault, na the unending hussle for daily bread
But be that as it may, I happy se dis thread still dey on track
And we still dey strong kakaraka like bagco super sack
Hmmm, I don get serious case of 'pidgin rhymers block'
So make I drop my pen ,stop here, & no push my luck






adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #744 on: October 29, 2009, 09:09 PM »

 ;d ;d ;d ;d ;d
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #745 on: October 30, 2009, 11:46 AM »

all una welcome back,
and as una dey give so una no go lack,
for we hassle lai-lai we no go slack,
kwanta no go jam we for dark,
if no be white we no go call black,
baba God scatter all winchy attack,
anytime anywhere na pass mark,
maga go pay for inside sack
and luv go waka meet u wen your time nack.
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #746 on: October 31, 2009, 07:25 PM »

chei see dat sexy chica,
i swear she fine pass monica,
d wey she wine i don dey weaka,
bodi don begin turn harda and thicka,
who wan taka with u shey na veronica?
baby na u blend jus like de'rica,
too sweet like calypso and soca,
man fit grub u like tapioca,
becuz of u i refuse visa to america,
only she can fit keep me inside africa,
u don gum me finish like sticka,
me no be playa talkless of strika,
i no get any jersee not even the nika,
confirm, u be my 1 and only angelica.


adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #747 on: November 01, 2009, 08:25 PM »

ruud, walai diz your rhyme dey make me dey high,
i know say u don realy prepare to go river nile,
because your girl where dey 4 sapele,
don put peper(for your eye)
join me to go chicago,
he get i babe her name na machio,
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #748 on: November 02, 2009, 12:01 PM »

why finger go dey man no fit scratch nose!?
u dey boo'ga ontop all my flowz,
wen u sef sabi sey i betta pass all those,
your yeye boys wey no sabi pass clotzes,
dat na after dem don throwey blowz,
inside dis film, i no wan be d boze,
even harmattan no go make me froze,
if no be u den make i shack overdose,
make my shapter jus kuku'ma close,
d end na only baba God dey knowz,
but for dis wan, me sef go follow bulldoze!



adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #749 on: November 02, 2009, 05:32 PM »

My name na adebayour,
in dat film i want b d actor,
make doz boyz b d bus conductor,
dem turn 2 b diz thread terminator,
if no b maedan,ruudie,semid and fl gator,
i go don throw dem in2 my farm regulator,
1,2,3,4 into Seun'z refrigerator,
ruud, shey una get incinerator Huh
Make i show dem say i don tey to sey i b rhyme generator,
bt u see maedan, semid,fl gator,and oga ruudie are rhyme professorz Grin
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #750 on: November 02, 2009, 05:33 PM »

My name na adebayour,
in dat film i want b d actor,
make doz boyz b d bus conductor,
dem turn 2 b diz thread terminator,
if no b maedan,ruudie,semid and fl gator,
i go don throw dem in2 my farm regulator,
1,2,3,4 into Seun'z refrigerator,
ruud, shey una get incinerator Huh
Make i show dem say i don tey no b like motor
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #751 on: November 03, 2009, 05:44 PM »

ol' boy your back 'trong like aligator,
abi u wear face protector,
your gear dust hummer navigator,
or ground tanda u like ta'minator
if not u no go dey hia dey halla adebayor,
cuz gunners fi twa'yan u pass incinerator,
kpo'kpo u d way of illegal tax collector,
or d man wey wan fa'ap generator,
dem eye sharp-red blue-tooth communicator,
d wa'yaring go be chas'co ololo-ma'tor.


semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #752 on: November 03, 2009, 10:57 PM »

Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.


semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #753 on: November 03, 2009, 10:58 PM »

Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.


semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #754 on: November 03, 2009, 11:00 PM »

Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.


semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #755 on: November 03, 2009, 11:00 PM »

Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.


semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #756 on: November 03, 2009, 11:01 PM »

Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.


semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #757 on: November 03, 2009, 11:01 PM »

Tommorrow, I go add one more year
I go throw party and celebrate with my peer
Chops go plenty and Men go shak enuff beer
So make all of una fall in for where e go happen
All man dey welcome cos the invitation dey open
Make una sha come with my gift
I hope se una understand and get my drift
So come one, come all, make we celebrate all the way
Because tomorrow na my birthday.


adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #758 on: November 04, 2009, 12:11 AM »

Let me b d 1st 2 wish u happy birthday,
4 person 2 add one year no b play-play,
how i wish d day go stay,
semid, i fink sey na May,
plz d venue, i wan kno d way,
abeg tel doz galz make dem lay,
'coz me kno get tyme 2 delay,
and i kno get pawa 2 run relay,
HAPPY BIRTHDAY!!!
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #759 on: November 04, 2009, 12:12 AM »

Let me b d 1st 2 wish u happy birthday,
4 person 2 add one year no b play-play,
how i wish d day go stay,
semid, i fink sey na May,
plz d venue, i wan kno d way,
abeg tel doz galz make dem lay,
'coz me kno get tyme 2 delay,
and i kno get pawa 2 run relay,
HAPPY BIRTHDAY!!!
sugarcane
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #760 on: November 04, 2009, 10:57 AM »

My turn!!
E don take me 3 days to reach 24 pages, I swear I no go lie e feel like ages.
I no fit stop I just dey read dey go, no so so laff be wan kill me oh!
From the beginning to the end e dey too interesting,
the way una rhymes just dey do d wrestling.
Make I be the 2nd person wey go say,
semid4lyfe make u have a very happy birthday!
I wish to say I fit flow just like you,
I for no dey here dey flow like jew.
Maedan na u be the number 1 madam,
for this thread wey hook me like gbam!
I hope say you no go ever change,
cos your type na pidgin rhymes top range.
Wetin happen with rotimy sef,
he create the thread but left!
una loff trip me die, make I no lie!
Anyway e don do make I stop here,
if not I go dey here till new year.
Una well done again all of una for this thread,
it's time for me to go get some bread!
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #761 on: November 04, 2009, 07:34 PM »


semid4lyfe, sorry for the belated wishes, tried to post you a nice poem yesterday but something was wrong with my avatar and my post kept disappearing! I hope you had fun though!




As 50 cent talk say, go shorty, it's your buffday
make we pop champagne abi na chadonnay
i write one better poem for you yesterday
but it kept disappearing, now i don forget am throwey Cry
but the good wishes na d same, i hope say you flex
and if you no come with takeaway for me, i go vex Grin Wink
maedan (f)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #762 on: November 04, 2009, 07:44 PM »

@ sugarcane, i happy as u come enter our lane Wink

i always dey glad when ever I see a new fan  Cheesy
make you feel free abeg to join our clan
your poem dey very articulate, like say u be expert
e go good if you go become our latest convert
thank you for all the good things you talk about me
but if not for rotimy, semid, ruud and co, how I for be
just make yourself at home, i hope you dey here to stay
i no too get time to rhyme as b4, but with this thread i no dey play Wink.
semid4lyfe (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #763 on: November 04, 2009, 10:14 PM »

I dey overwhelmed and I no know wetin to say
Thank's 4 d good wishes & may good things come una way
Special thanks to Baba God 4 keeping me alive till dis day
Becos many peeps don pass away in the last yr
But me still dey kick and I still dey here
So I thank Bros Gode' for seeing me thru all the strife
And all the blessing I have recieved in my life.

THANK YOU ALL.
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #764 on: November 05, 2009, 06:09 AM »

Mr sugancane u ar welcum 2 rhyme thread,
just make your rhyme blend,
4 diz place we b rhyme mate,
if na lie ask ms. Kate,
please, pigin na our language,
xcept if worse come to worst we go speak yoruba or inglish language,
as i dey talk, ms. Maedan na my rhyme mistress,
ruudie na my oga 4 diz business,
semid na my one and only witness,
bt u see fl gators na my rhyme semistress.
abeg kno let am hear.
RuuDie (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #765 on: November 07, 2009, 02:24 PM »

oh baby boo listen to d racket,
me be short black boy from eket,
but i no small for month-end pay packet,
money no dey finish for my pocket,
u wan try i dey buy full super-market,
as i see u my heart beign yori-yori like bracket,
my love for u don full bucket,
infact, if i get u i don comot eye for market,
your virus ehn don re-format my diskette,
inside cold i go off shirt follow give u blanket,
pls come follow we go see mr. & mrs. ekat-eket,
together we can start we own mmo'ereket. . . . .
adebayo201 (m)
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #766 on: November 07, 2009, 03:32 PM »

;d ;d
sugarcane
Re: Naija Love Rhymes For Valentine
« #767 on: November 09, 2009, 11:24 AM »

Correct rhymes plenty for here,
make una enjoy this cold beer
Na morning now but you fit save am,
For evening use am chop stew and yam.

Thanks adebayo201 for the welcome!
But na miss I be where I come from.
 Short Story Contest: Tuneh Won  Best African Author: Wole Soyinka or Chinua Achebe?  Poetry Contest  Page 2
Pages: (1) ... (18) (19) (20) (21) (22) (23) (24) (25) Go Up Send Topic to Friend by E-mail Reply 


Sections: Autos/Cars (2) Jobs/Vacancies (2) (3) Career Talk Education General(2) Politics Romance Computers Phones Travel
Sports Fashion Health Religion Celebrities TV/Movies (2) Music/Radio (2) Books Webmasters Programming

Links: Page1 Page2 Page3 Page4 Page5 Page6 Page7 Page8 Page9 Page10

Nairaland is owned by Oluwaseun Osewa. See also: Nairalist Classified Ads
Nairaland Forum | Powered by SMF 1.0.12.
© 2001-2005, Lewis Media. All Rights Reserved.