|
ella.b (f)
|
Airller,na u biko oh.na monaco u dey go next 4 d WMA's?hmmm, i dey jealous u oh.bring goodies come bak oh.
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
@Ailler is good to have you back omo your job pay you well o you get the chance to travel and meet celebrities pls remember me o like we disscussed i will really love to travel to Monaco. @ELLA B was up Girl how you dey you and Ailler gist nearly let me faint with laugh.No be small thing o see as UMLB nearly put una for serious trouble but cos plenty yabbing.No mind Elisa wey they Sabi fall hand see as she Fcuk up again today allow that yeye Amphilia yeye her after Sergio warn her.Yesterday episode was interesting.Romina should better run Becos if Amphilia catch her or Gale she don finish.pls add Maria to that list and Gina.Her own don bend and she go draw her stupid doctor friend follw body na him good for that one.that doctor have neva hada good friend in her life and am sure she was bullied in school that is why she dumb like that.can't wait to see todays episode. i love Sergio and Elisa together today that really look adorable imagin how the pickin wey them go born go bi.very beautiful
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
Jeff,my broda,d time wey d tin happen e no funny oh.bt now,wen u fink of it,na laugh go carry u. una dey c elisa.Wetin dey worry dat gal sef.sergio warn her bout goin 2 c ophelia bt she still carry dose her crayfish leg and nngbeke body go c her.d cry wey she cry in front of ophelia and gayle wey she dey say she know Wetin she dey go tru,ophelia still be her wicked self.so tey she drive lisa comot. 1 tin wey i learn b say make u still care 4 your enemies,e go make dem feel bad. i pity rodrigo oh.as romina point gun 2 puma and rodrigo dem begin dey fear.so e dey fear gun lik dis.lol.its a pity his paralysis was comin bak and puma used d opportunity 2 escape. was gayle really serious bout surrenderin 2 d cops?hmmm, i smell fish here cuz even if e entr prison,d BLOCK go still rescue am. l8r ppl.
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
HEYY wat rubbish.todays episode was sp annoying and foolish and am so tiered of this program.Elisa should be voted to dumdest person on this soap infact she should just marry Rodrigue.She doesn't deserve Sergo at all Haba enough is a enough.the director has finanlly Portral her as a prostitue that can not be left alone with a man for a minute else she will fall in Love.infact she should marry him and continue sleeping with Sergio and Alahandro.And that Rodrigue is another fool.how can you go and steal another persons girl and u see say you dey paralize instead of you to focus on getting better u are chasing woman this Program is immoral and i don't see any lesson to be learnt at all.Even Nollywood movies make sense and get better morals pass am.See Emilianna sef.her mama don spoil her so tey na boy she they fall in love wit hand follow go school and then you see Romina knowing who she is and all your mother have been saying she still follow her enter motor after she nearly jam u with her suv.I wish romina will Kidnap her and show her pepper for me.all the montero women are spolt and stupid.Maria left her own problem and carried another man's child on her head,Gina spoil her own life and is crying for more drugs pls ignaso should give her.they are all disgrace to womanhood and i thank God that my Naija Babes are not like them at all.una get dignity and shame and una no go let una daughter spoil for una eyes.
I love Sergio for not buying all Gale said and see as Gale bend face like Monkey wey dem collect banana from him hand that guy na bastard and hector and Alahandro na mumu.well i know blame them any man that comes in contact with the motero women must turn mumu.I like Romina,Gale and Amphilia's part.very interesting and na there you go learn things.Never trust your Fellow enemy even when una get something together.a bad person is always bad no matter what.
i no sure i go watch tommorow own.i will just let people tell me what happened.mybe by nextweek i might get back my interest.Plssssssssssssssss Dreamara just explain wat will happen for us so we can rest this irritation is just too much.
|
|
|
|
|
|
Airller
|
hey wats up? me i dont understand dis people again o.@jeffo.i tut i adviced you say make you no dey wacth dis immoral prostitution presentation.me i dont know why you are still shoutin.to me elisa dosent deserve sergio.elisa dosent deserve rodriguez.she derserves fustration and loneliness.she is a typical example of a woman that men shud stay away from.on a serious note,she shud end up like rumina,alone and fustrated.please if you want to tackle what i have just said please do it sensibly.nobody shud tell me that she is confused sam sam i no gree.she knows exactly what she is doing.
as for her mother i think rumina has just got her where it pains the most.she go hear am no be small.they are still underating rumina.to me she didnt kidnap that child cos the child entered the car willingly.if maria was where she was supposed to be at the r ight time i dont think rumina will get the chance she had.
as for emmy.i think that girl shud be flogged seriously.she they dont warn children in mexico not to take lift?na wa o but e good for them sha.
as for alex and hector see as dem be like aki and pawpaw.e pain me them no let sergio beat that wicked soul.what were they xpectin that he'll thank them and congratulate them for shooting his brother?bull shit.i was pissed off.
as we all no now the battle line has been drawn it is now wrestlemania 1million OPHILLIA vs RUMINA.guys you really dont want to miss it.thats the only intresting part of the show.
whatever sha?i only wacth the show to see how the battle will end i wan know who go win.see ya all later
|
|
|
|
|
|
Airller
|
@ella b. babe e no easy no be say i dey go enjoy o.na work na im i dey go do and its not easy i tell you.you know hear say i wan run from there.i go marry one je'mappel turn le francee you dey feel me so?lol.no mind me o.i dey play. as for your younger ones,men dose kidz are raz and wicked them show you no be small.i laff sotey i dey cuff.una no go kill me with una mouth.i guess you are happy now they have called off the strike. @jeffo,ellab. see guys una no go beg dremara say make she con finish wetin she start.at least make she tell us the remaining part so that we no go dey suffer dey wacth all this nonsense.the other day i had to hurry from work i was driving like a tout.(na that time the prog.dey shack me no be now)if i dey traffic i go stay inside.no be me elisa go use her matter kill. @dreamara abeg i take GOD name beg you.talk now.she becos i dey call you eli michael?oya i go stop am.  .she daniel die?and tell me elisa suffered b4 marrying sergio.if not to me the boy is going to have a HAPPY BINGO LIFE with her. I SHA LIKE THE WAY OPHILLIA TAKE CURSE HER.E SWEET ME NO BE SMALL.the girl kips irritating me? i'll talk to you guys later i ve to catch some sleep now.nitey nite 
|
|
|
|
|
|
nanny o
|
@jeffoski my broda, na d thin i dey shout since, alicia na proper ashawo period
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
lik i said b4,elisa na slut.una no c d way she smile wen rodrigo talk say e dey in lov wif her?she tire me. i lik d fact dat sergio didnt buy d story gayle gave.see as hector and alex jus mumu. emiliana na craze gal.upon all d warnins bout ow bad romina is,she still dey entr moto.na wa o.tank God 4 9ja kids.weneva dem remembr d beatin wey dem go receive 4 hse,dem no go entr moto. dis show don dey piss me off.make ait do finish am. l8r guys.
|
|
|
|
|
|
jenace999
|
@ ella b, jeffoski, airllier, nany o, i swear this program don dey vex me. i thought this director was world class but he is full of sh*t. the prog is really frustrating now. to see elisa acting like a world class ashawoooooooo is really disgusting. as for what airller said about casting vote, i vote elisa the greatest prositute of all time. i am begining to hate this prog. i am only watching it becos of gael, romina, maria. they bring alot of drama to the soap. i swear gina is far beta than that idotic slut called elisa. just check the way she was looking at rodrigo. ashawo like her. i always wanted her to end up with sergio but right now i dont. it is so unfortunate it ended up with him. she doesnt deserve sergio. i think alehandro gave that crippled whore the exact thing she need. crippled b*tch. i dey vex ooo. make una just pardon me ok. e dey pain me well well. anyways, catch yall later.
|
|
|
|
|
|
jenace999
|
i agree with who whoever said this prog was about immoral prostitution presentation. among all the characters, elisa disgusts me the most. ashawo kobo kobo
|
|
|
|
|
|
Airller
|
hello guys @jenace999 wu u fink say fit title this prog.like that more than the HONORABLE OF THIS ROOM HERSELF.LOL  . NA ME NA .babe i feel your pain no be small think.wetin you sef expect from person wen no get sense.i no blame her at all.na me wen no get better thing do with my time wen i dey wacth their immoral practices. i dont know y AIT are fond of showing annoying soaps.now they want to bring mannana and mahoho again.with the way that girl is talking its obvious that that one too will irritate us. @ELLB ,JAY MAN, una never no wetin they wonder me now na the way wen dreamy take run comot for here she no dey talk.abi sometin don happen.abeg make them, halla me make i run rich AIT now now o.lol.jeffo i meant what i said stop shoutin before this people will kill you.ella i feel you jare.for naija we no dey born BASTARDS. e no possible.NAIJA PIKIN GO ENTER RUMINA MOTO CON SAY NA PAKORORO for that matter becos according to the show ELISA DEM BI PAKORORO.serious if na naija pikin as she see rumina she go pick serious RACE. abeg guys i go talk later i wan go chop.one more thing.una no dey vote o.i go sanction una o.na only jenace just vote.i GO FACE EVERYBODY O  UNA KNOW SAY I CAPABLE?LOL 
|
|
|
|
|
|
Airller
|
@nanny o, no vex say i no halla you jare.i feel you sef bottom line ELISA NA ASHAWO.sergio oughtb to free the girl.she derserves nobody at all.her mentor na her mama.cos na say she dey house i no tink say that girl for see that jeep talk less of to enter am . instead she dey MAN HOUSE dey carry her enemy pikin.na GOD go punish people like them.
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
ma ppl, make una know say as maria dey do bad tin,na so her children dey do.anytin u do,your pikin go follow u do am cuz e go tink say na gud tin. e be lik say evrybody dey vex wif elisa.take am easy oh.lol. BEST ASHAWO:elisa.gina no reach her. BIG MUMU:sergio.e dey follow elisa lik Shrek.alex beta sef. BEST VILLIAN:gayle na C.E.O.romina follow 4 bak.dnt undrestimate dis 2. BEST HUMAN BEING:jabela(lil diegos babysitter).natalia no dey dis one cuz she sef, inshort no comment. l8r guys.
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
phew! im glad i watched 2days episode. so sergio broke up wif elisa after he overheard her chit chattin wif rodrigo(finally.praise d lord sumbody). opheilia,who send u go romina hse.na wa.now shes bin abducted.by who?i dnt know.either d block or romina(DREAMARA AND DANIELLA,SHOW FACE 4 HERE OH). now,im beginning 2 lik paula.shes makin gud use of her time.givin sergio info bout gayle. sergio,i know no who send u wif dat your crayfish leg go IMMEX.dat gun wey e carry,make una watch oh.2moro e no go shoot am. romina na evil genius.she kidnapped emiliana.Wetin maria wan do now.u carry your leg steal person husband now na wahala u don entr. make we see Wetin go happen 2moro. 9ty 9t.
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
phew! im glad i watched 2days episode. so sergio broke up wif elisa after he overheard her chit chattin wif rodrigo(finally.praise d lord sumbody). opheilia,who send u go romina hse.na wa.now shes bin abducted.by who?i dnt know.either d block or romina(DREAMARA AND DANIELLA,SHOW FACE 4 HERE OH). now,im beginning 2 lik paula.shes makin gud use of her time.givin sergio info bout gayle. sergio,i know no who send u wif dat your crayfish leg go IMMEX.dat gun wey e carry,make una watch oh.2moro e no go shoot am. romina na evil genius.she kidnapped emiliana.Wetin maria wan do now.u carry your leg steal person husband now na wahala u don entr. make we see Wetin go happen 2moro. 9ty 9t.
|
|
|
|
|
|
jenace999
|
Yesday episode was kinda cool. But y does d director always make sergio luk 2 immature wit his ways of thought? 4 God sake y him go carry gun go immex? Sergio no dey tink b4 him act period. Anyway i kinda like d way he walked out on dat ashawo (elisa). She tinks she wil alwyz hv her way. B*tch. Romina romina, may God hv mercy on your soul. Paula it gud u doin sometin reasonable wit your time now.
|
|
|
|
|
|
affablekay
|
I really enjoyed yesterday's show especially dat btw Elisa & Sergio. Thank God it is finally over btw dem. I pray it lasts cos dat SErgio na one mumu of a man; he is too jealous for my liking.
I suspect Ophelia was killed by dat guy in Romina's house. I wish Natalia would let d cat out of the bag 2day.
I cant wait for today's show; i no it will be hottttttttttttttttttttt.
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
Airller how far abeg no mind me jire t his yeye soap wan turn person to wetin person no bi stupid director and crazy actors who really know how to act and make you feel exactly the way the director wants abi my people?
Finanly Sergio has been set free(Kezzy go rest now and happy well well).i really like it this way atleast if she truly love him she know what to do to get him back and things will be the way it suppose to be,not having him behaving like a puppet that she can manipulate any how.Thos os also the time she can redeem herself and prove to us that she is not a prostitue.If she date Rodrigue immdiately then the program don finanly spoil.i fell what will happen is that she will channel her pain into walking again and when she start walking she will go and Beg sergio and accept his proposal but if am him i won't accept like that o she must suffer well before iwill say yes and even when i say yes i will set rules.
God have catch Maria for underestimating Romina i really like the way Romina is dealing with her.i also pray Romina torture Emiliana small inorder to teach hera lesson.that small girl own don too much.As for Amphilia that babe no go take laugh kill person how she sef go person house alone and think say coma no go dey. For the first time Paula gave her sef dignity small.i like the way she was able to figure out Gale but trust mum Sergio,1 mins he will do something right the next min na to spoil everything.why in heavens name did he go and carry gun to Gale when we all know that he won't use it.i pray they arrest him and jail him then his mumu brain will not go and start begging Elisa becos i no trust am.e fit go dey beg her to come back.
Natalie haaaaaaaaaaaa i pity u everytime the Devil will be calling and you will keep answering.why didn't she just tell Doctor onces that she is pregant or if you no fit she dem no get text message or email.Hector and Maria wey dey sabi do amebo sef dey there why she no send dem or send aproko mistress Chibela.I feel sorry for her the dey Doctor find out. AIT stupid no bi small so are they trying to tell us that friday has been removed and we can only get to watch our program from Mon to Thurs.am sure is a plan for people to go and buy Daarsat e no go work my people havea great weekend and see u next week.
ps DREAMARA AND DANIELLA WHERE UNA DEY O
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
@Ella B you just typed the words out of my fingers.i agree wit you @jenace nanny o i feel una jire @affablekay welcome to the room i see you are keeping up but on advice if you want to saty safe here without the Iya Aye of this room getting on your case(pls o i no call name o)always get your fact rights Amphilia was not killed o.
|
|
|
|
|
|
affablekay
|
"always get your fact rights Amphilia was not killed o"
Jeffoski, it be like say the word "SUSPECT" no dey your dictionary (no harm meant).
|
|
|
|
|
|
jenace999
|
@affablekay, i just wan let u know say jeffosky was only lookn out 4 u so u dont step on d tails of da lions we hav in da room. Always know dat u r entitled 2 your own opinion. Some may respect it or some may not. Anyways lets all try to have fun here. Thanks 4 your contribution so far. U welcome to dis forum. Catch yall later.
|
|
|
|
|
|
affablekay
|
@Jenace: thank you jare @jeffoski: i appreciate your concern
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
all i know be say, actor no dey die 4 film.instead make hin die,d film go end or nepa go take lite. if opheilia quench 2day,dis film no go get taste 4 mouth again.
|
|
|
|
|
|
Jaymoses
|
@jenace thank you for understanding me.how u dey hope u had a great weekend @affablekay how u dey am glad u see wat i mean.we have alot of fans of this program that if u make any mistake at all or nearly make one dem go tear u to pieces that is one thing i like very much about this forum.is fun and crazy at the same time. to all my people Ella B,Kezzy,Nanny o Dreamara and Daniella(where una go since i hope all is well odis silience is becoming scary),Honorable Airller and every one hope u all hada great weekend and ready for a blessed week and rounds of Umlb.
Today episode gave me mixed feelings first why did Sergio g o tru all that trouble just to prove a point?I felt sorry for him today when he poured out his heart to Natalie,she gave him the best idea and automatically won my vote for the best Person on the program.Girls never apprieciate a good guy when they have one.He is a total package and they don't want that so the best thing is to be selfish a little for once and have fun.how i wish they where hot girls living in their area.Girls like Isabel,Paloma,Beyonce,Shakira and all those latina babes with wicked curves.Sergio for no get time for Elisa at all and even if he later does she go hold am well knowing that he can be taken at anytime.Foolish Girl.shei she didn't know that she was suppose to be alone small before jumping into another relationship and now she is leaving one again to enter another one.have neva seen anyone so selfish am sure is a girl thing?want guys to always be fighting for her always.I trust my Naija bobos we can neva be played or fooled.
Mariah is a stupid woman o.didn't she know that immediately Romina made that offer she is suppose to run as fast as she can,grab the baby and give it to Romina and then pursue Hector away.she still they think of Hector heyyyyyy.if iwas Elisa na slap i go land her for face.they think Romina is a small girl i really love her.
Amphilia don hear am.i thought that guy was going to rape her o from one trouble to another becos she loose focus.Na money u be wan collect u go fall in love turn witch.Paula is another ode i thought she set a trap for the fake police not knowing that is Alahandro she is thinking of all of them in this soap opera are just distracted including the Director and Producer too and as for Rodriguez i have nothing to say for now i will answer him when Elisa will start walking.i know what she is trying to do.concentrate on her therapy,use Rodriguez to walk and then run to go and be with Sergio.
lets see what happens tomorrow gud night
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
abeg make una no mind me o i know no say my friend no logout i use him id paste pls everything jaymoses typed is from me o jeffoski
|
|
|
|
|
|
ella.b (f)
|
LOL. Jef,i go report u 2 EFCC. @YALL,ow una dey.Yesterday was ok and obviously,Jef has said evrytin. as 4 elisa and rodrigo,no comment. if maria wants e kid bak she knows wat 2 do. i tell una say sergio no go fit shoot bt all i no is dat he ll be strong. l8r guys.
|
|
|
|
|
|
nanny o
|
 @every one in this group,  anoder one wey dey vex me b say, sergio don turn to detective, u no say nomally7 one will not easily think that gale could hire a hitman to shoot him, but mumu sergio know makin it feel lik fake, besides d guy is too immature for my likin, i no know why dem never shoot am throw away. as for maria, e really sweet me say them take emiliana, mak she know how painful it could be, she is just one naive idiot in love,if nt why she go carry thet little baby when d mama dey alive___ abi wetin una think 
|
|
|
|
|
|
benedictac (f)
|
If u want to see and anger of a hen, then touch her chic. Na wetin dey happen between Maria and Romina be dat. Maria Mrs Too Good, knowing the circumstance of Hector and Romina's seperation go dey carry her baby even in the present of the mom. If na me, i go roast alive
|
|
|
|
|
|
jenace999
|
Thanks 2 yall for the update. i actually missed yesterdays episode. so that ashawo wey dem dey call elisa still the misbehave? na only God go punish her. can someone tell be about gale. what happened between him and sergio. @jeff, u welcome jire. guess the air has been cleared so we all can have fun. see yall after todays episode.
|
|
|
|
|
|
dreamara (f)
|
UMLB lovers how far? I've been too busy with other things o that's why I haven't been writing here.Sorry people make una no vex. I will just say few words about the slut Elisa:She sucks. That girl needed a big slap on her face all the time I watched her on my screen.Just forget her o, my peeps.She finally went back to Sergio, actually it was the stupid Rodrigo that encouraged her to do so.I've always hated Maria so there is no need to explain anything about her. @Jeffoski:Daniel didn't die, see u guys later!
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
@Ella b if u call EFCC i go call NAFDAC for you sef lol how u dey?all my people in the house was up hope u hada great day@dreamara is good to have you back we really miss you.am glad u helped me with key details now am ready to face this yeye program. Let see wat happens today i will be back later
|
|
|
|
|
|
jeffoski
|
God todays own was so boring i was actually sleeping dis Program don mess up no bi small.plssssssss can someone tell me why Paula no break bottle for Gale head,then call Hector and Alejandro plus Sergio to come and see what he has done then before he wakes up he would have been caught and won't have time to order the killing of her parent that is if he even had them.
God don catch Amphilia she that just got miscarried is about to be gang raped she go see Oba. as for the rest people they showed no comment at all. dis program should pls pick pace again am still ready to give it a second chance
see u guy tomorrow those of you that miss today be happy nothing happened and it was so boring.Gud Night
|
|
|
|
|
|