WHITE SKIN, BLACK MAN.
So I fair?
Who come bad patapata?
I still dey try
Who come worst pass?
I yellow na�im make me fair
My brother different so therefore E bad
Na you come good because you white
Thank God I manage fair, my own don better.
My sister, you no fit white sh`a try fair
If you no fit fly, shey you go still jump?
Take wig make you wear,see cream sef make you rub
No be God? Black na disease wey get drugs.
Thank you Oyibo, you too try for us
If no be you, we still for dey mad
Thank you say this blackness go soon stop
Thank you O, this madness go soon cure.
But no mind me O, I jus� wan� ask
No jus� mind me at all, but why you dey tan?
If black so bad, why you like am.
E wan� come be say na you sef dey mad.
Sorry O, but E dey somehow
You no like black but you wan� black
Na white better pass, you born half caste
Which kain� palaver come be all that?
Oyibo sir, abeg I know understand.
"Master" please help me explain
Jesus, God, Angel: all na white.
This your "wayo" sef, na today?
Everything wey black jus� bad
Black magic, black leg, even black heart sef
With your skin like overall eczema,
Na you still wan� dey criticize.
But me I never see person wey black before
Me na yellow, my wife brown, my pickin chocolate.
E come be like say na ya own brain black
you no see black but you think black, you imagine black.
So now who come black?
Your coat, your car, everything black
Dye you hair black, smoke your air black,
wear dark shade make you dey see black.
So bros, tell me who come bad.
You wan' come brainwash your slave:
"Black is beautiful"; "black �n� proud"
you forget say black na state of mind.
You don already black finish
You jus� dey shame to talk am
But as you dey resist na ya sef you dey punish.
You wan black, you dey try, so claim am with pride.
"Crazeman wey 'gree don already cure.
So go ask John Hawkins, ask Lord Lugard.
Who come kill my papa, who thief my land?
Black Man!
nexbestthing@yahoo.com