|
emmagined (m)
|
ok
now wats the story with the UK, truth be told, all man wan jah from naija, statement of fact, boys dey die for embassy, one of their destinations, UK.
now other men dey jand for a while, and truth be told, a lot of stories are sour, e no easy, e no easy, FACT!!! gba be,
end of the day, y e no easy for boys? 50% of people leaving naija to UK end up in LONDON, and ol boy London tight die, omo job wey boys dey do before, na Poles dey collect am now, next year, HA!!! with Romania & Bulgaria coming in the EU, na God hand we dey,
My best advice, try comot for London B4 its too late, imagine wetin u dey go through, you dey pay like £300 for shared apartment (1 room), you go buy oyster(God help you if u dey Zone1), u go chop, u go pay 4 phone (mobile & land) , etc, on top of all na either care or Securico u dey do,
anyhow you spose get the gist,
Share your experiences, am out
|