Nico Gravity - I Wan Finish Timaya

Welcome. Please Login, Register, Or Activate! 
type your username and password to login
Date: November 23, 2009, 02:34 PM
431297 members and 298344 Topics
Latest Member: Benjamin.
Nairaland [Nigerian Forum] Home Help Search Who is currently online? Login Register
Nairaland Forum  |  Entertainment  |  Music/Radio (Moderators: lalaboi, Shaz)  |  Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
Pages: (1) (2) Go Down Send this topic Notify of replies
Author Topic: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya  (Read 1323 views)
bandely (m)
Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« on: September 13, 2009, 03:20 PM »

When I heard the song the first time, I was like "O boy wetin Timaya do this man". But after listening over again, I realized he was saying the truth. It goes like this


I wan answer Timaya
I wan pieces the maga
I wan enter the small boy wey tell everybody say im be egberi papa
The thing wey dey vex me be say nowadays children dem no dey get respect
If you give them microphone make them sing wetin dem sabi na to dey praise themselves
During our time, I say no be like this
Musician dey blow, musician dey fade
If you never blow, my brother wait for your turn
If you don blow, make you no use am dey pose
No use an dey brag, no use am dey show off o

See Timaya, e too dey pose
See Timaya, e too dey brag
Anywhere he enter na so e go dey pose
Scatter im face, carry shoulder up
He buy motor, he go take am sing
He f**k t*t*, he go take am sing
He smoke I**o, he go take am sing
He rent flat, he go take am sing

Me I take am say na lack of education
He no sabi handle fame and fortune
He no ever believe say he go get money
When small money come, e come enter im head
Come scatter im brain, come make am dey feel like egbe
Original egbe the papa

Chorus
I wan finish Timaya
I wan pieces the maga
I wan scatter the mugu
I wan enter the small boy wey tell every body say im be egberi papa

Well right now today today Naija dey gbadun your style
Thank God for your life, I happy say you dey shine
But I hope say no be only motor you just dey buy
I hope you dey put some money for bank
Because I hear you dey talk of Camry 2.2
And I hear you dey talk about Toyota Spider
Small thing you for tell us say you buy helicopter

See, I get small advice eh, I hope say you dey plan for your future well
I get one secret to tell you, no musician go reign forever
I get one koko to yarn you, one day Naija go bone your face o
Remember say na only one style you dey use
Remember say na *** dem dey use for your voice
One day your juju go clear from people eyes
That time if you sing, e go be dem like say na noise

Remember say you never reign reach Kimono
Remember say you never reign reach Baba Fryo
Remember say you never reign reach Daddy Showkey
Remember say you never reign reach Daniel Wilson
Remember say you never reign reach Blackky
Remember say you never reign reach Danfo Drivers
Remember say you never reign reach Shina Peters
Remember say you never reign reach Tuface Idibia

All these people dem reign, dem let person hear word
E don reach your turn, everyday na to dey pose
You don forget say to reign na luck, no be sabi and no be by work
So my paddy make you no come here dey start to dey pamurogo, carry shoulder up just like a tolotolo
Blah blah blah,


What do you think about it?
Mr_TA
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #1 on: September 13, 2009, 04:21 PM »

Just hating really. why not call him and talk man to man instead of making a whole song about it?
pheesayor (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #2 on: September 13, 2009, 06:58 PM »

Quote from: Mr_TA on September 13, 2009, 04:21 PM
Just hating really. why not call him and talk man to man instead of making a whole song about it?

He might advised him and he refused to listen, the song is becoming a hit sha
baslone
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #3 on: September 13, 2009, 08:00 PM »

That's the third Timaya diss track I'm hearing!!
MeGaStReEt
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #4 on: September 13, 2009, 09:46 PM »

To me dis guy is just being stupid, i mean the Nico Gravity.

If he wants to make hit song, he should kall timaya, then do a colabo with him instead of tryin to reap were he did not sow

Someguyes in the past did d same tin to African China when he came out with Mr. President, they also sang their own version to intimidate AC,  but to no avail

Mode 9 hav been dissing Rugged Man for years, yet RM is going higher

Nico Gravity whatever that means should try and come out on his own and not try to use other peoples name to gain fame, there is enuf space for him to do that


lousy simpleton

bandely (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #5 on: September 14, 2009, 10:15 AM »

Quote from: MeGaStReEt on September 13, 2009, 09:46 PM
To me dis guy is just being stupid, i mean the Nico Gravity.

If he wants to make hit song, he should kall timaya, then do a colabo with him instead of tryin to reap were he did not sow

Someguyes in the past did d same tin to African China when he came out with Mr. President, they also sang their own version to intimidate AC,  but to no avail

Mode 9 hav been dissing Rugged Man for years, yet RM is going higher

Nico Gravity whatever that means should try and come out on his own and not try to use other peoples name to gain fame, there is enuf space for him to do that


lousy simpleton


Did you say gain fame? He wasn't a bad musician during his time.
Caliente (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #6 on: September 14, 2009, 12:15 PM »

Not heard the song, any link to it.
MeGaStReEt
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #7 on: September 14, 2009, 05:46 PM »

Quote from: bandely on September 14, 2009, 10:15 AM
Did you say gain fame? He wasn't a bad musician during his time.

then he should allow Timaya to write and sing his songs the way it pleases him, afterall he is not doin bad
9ja4eva (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #8 on: September 14, 2009, 06:23 PM »

LWKMMMMMMM


Mehn this people funny ohhh

Abeg make someone upload the song.

If to say Timaya na musician e for be Nico Gravity,

LWKM
chronique (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #9 on: September 14, 2009, 10:55 PM »

@ megastreet: its not in every thread that you bring up a mode9/ruggedman issue. If you don't know jack about that beef,just keep mum instead of sounding ridiculous. It's embarrassing reading that line. As for nico gravity,he held it down at a.j in his time. You just shot yourself in the head by saying he dissed timaya for fame. How many people did rugged man diss to get fame? Am sure you can count up to 5. Don't say nuffin. Mode9 never dissed rugged for fame. Just enjoy the game as it is being played. Its notin new to da game.
st-kris (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #10 on: September 15, 2009, 06:44 AM »

a friend of mine visited naija over d summer n came back with dis track on his laptop. i laughed real real hard when i heard it. its a big joke. the dude is no doubt a stark illiterate, and da ironically funny part is dat somewhere in d song he says something like na lack of education dey cause am, referring to timaya as uneducated, when he probly cant spell his name. its so funny
o.val (f)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #11 on: September 15, 2009, 07:18 AM »

i thinktimiya deserves all the diss he got from this guy, seriously timiya got some attitude problem,i think heis takin 2much of that 'lalal'.
babaearly (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #12 on: September 15, 2009, 07:40 AM »

Even you timaya fans know theres some truth in that song. When artistes concurrently show lack of lyrical depth in their songs over and over again, they will suddenly die off. As we are evolving so is music. Timaya cant be singing the same pattern of songs 10 yrs from now.
bandely (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #13 on: September 15, 2009, 09:33 AM »

Quote from: chronique on September 14, 2009, 10:55 PM
@ megastreet: its not in every thread that you bring up a mode9/ruggedman issue. If you don't know jack about that beef,just keep mum instead of sounding ridiculous. It's embarrassing reading that line. As for nico gravity,he held it down at a.j in his time. You just shot yourself in the head by saying he dissed timaya for fame. How many people did rugged man diss to get fame? Am sure you can count up to 5. Don't say nuffin. Mode9 never dissed rugged for fame. Just enjoy the game as it is being played. Its notin new to da game.
Good post jare.  Wink
debetmx (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #14 on: September 15, 2009, 09:45 AM »

This Nico Gravity guy should get a life
bandely (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #15 on: September 15, 2009, 10:26 AM »

For those asking for the song, I have uploaded it and you can download it here.

gravity  i wan finish timaya.mp3 - 1.02MB
baslone
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #16 on: September 15, 2009, 03:56 PM »

Quote from: babaearly on September 15, 2009, 07:40 AM
Timaya cant be singing the same pattern of songs 10 yrs from now.

10Years ke Shocked You should be talking of 2010 xmas.!!! Grin
tosinaded@
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #17 on: September 15, 2009, 05:47 PM »

this guy Nico Gravity should just shut the FUkk up!!!
he should go and sit down sumwhere jare!!!!!
who gives a shit if timaya brags, about what he worked for???


Quote from: chronique on September 14, 2009, 10:55 PM
As for nico gravity,he held it down at a.j in his time.

who gives 2fuccs if he held it down in AJ???
his time is up!!!!!
if he is so good, we should still be hearing his songs till now!!!!!\


u wan comparte ruling AJ to ruling Naija???
please!
lawrence83
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #18 on: September 15, 2009, 06:29 PM »

ah ah timaya don enter am o

Nico gravity na wa for u o
 
cant stop laughing at this shit

egberi papa one of bayelsa over to u Grin Wink Wink Huh Huh Grin Tongue
asha 80 (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #19 on: September 16, 2009, 03:38 PM »

To all Timaya haterz  Grin

 <a href="http://www.youtube.com/watch/v/ttLcbVRuAuQ" target="_blank">http://www.youtube.com/watch/v/ttLcbVRuAuQ</a>
rapjunkie (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #20 on: September 16, 2009, 04:35 PM »

Quote from: tosinaded@ on September 15, 2009, 05:47 PM
this guy Nico Gravity should just shut the FUkk up!!!
he should go and sit down sumwhere jare!!!!!
who gives a shit if timaya brags, about what he worked for???


who gives 2fuccs if he held it down in AJ???
his time is up!!!!!
if he is so good, we should still be hearing his songs till now!!!!!\


u wan comparte ruling AJ to ruling Naija???
please!


co-sign   


PLUS this must be the WORST reason I have ever heard for person to start beef.

envy is a deadly sin
bandely (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #21 on: September 16, 2009, 05:50 PM »

*peeps in, check the last two comments, hisses and peeps out*
asha 80 (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #22 on: September 16, 2009, 06:02 PM »

Quote from: bandely on September 16, 2009, 05:50 PM
*peeps in, check the last two comments, hisses and peeps out*

Guy go siddon for gutter.In fact go compose your own beef track  Tongue
rapjunkie (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #23 on: September 16, 2009, 06:53 PM »

The song is NONSENSE.  Angry

they didnt think it through.

I wan finish Timaya because

1. he dey pose (so?)
2. he praises himself ( so?)
3. he too dey brag (so?)


If this is NOT hate spawned from jealousy THEN I DON'T KNOW WHAT IS. Person dey openly wish for the downfall of another. What did Timaya do?, 

He became more succesful than ALL of the Aj-city boys PUT TOGETHER through his music which happens to better than their BS . Instead of stepping up their game they  do a 'diss' track praying that he will end up broke like them.


PATHETIC LINES

See, I get small advice eh, I hope say you dey plan for your future well
I get one secret to tell you, no musician go reign forever . . . .  . .  . . . .  . . . . . . . . like u?, problem is u never reigned at all. Numpty
I get one koko to yarn you, one day Naija go bone your face o, . . . . . . . . . . .  . . . . . . . . . WOW!
Remember say na only one style you dey use. . . . . . . . . . . . . . . . . . . . . . .  errrr, is he supposed to go into Fuji music?
Remember say na *** dem dey use for your voice. . . . . . . . . . . . . . . . . . . . .  HuhHuh
One day your juju go clear from people eyes. . . . . . . . . . . . . . . . . . . . .  pathetic!!!
That time if you sing, e go be dem like say na noise. . . . . . . . . . . . . . . . . is that whats happening to your stupid ass?


How sad.

FU*K NICO GRAVITY.

Rapjunkie

Chairman
Fu*k Nico Gravity Commitee




Warfy Boy (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #24 on: September 17, 2009, 12:28 AM »

make una kno blame d guy too much, if kno be this disss track wey im drop, me for one for kno no wether person like Nico Gravity dey exist,

To be candid Nico Gravity and African China are JEALOUS of Timaya, I heard what AC said about Timaya and its alll bullshit.

Nico Gravity shld remain were he is, bkos of Timaya catch am! hmmmmm

Timaya i love u so much, kip on doin what u kno hw to do best, dem go soon kill theirself
whiteroses (f)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #25 on: September 17, 2009, 12:47 AM »

afro hiphop is just growing in naija just like how hiphop was growing in the 80's in america hopefully we will skip the so called biggy and tupac phase abi wetin be beef lol
bandely (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #26 on: September 17, 2009, 12:29 PM »

Quote from: asha 80 on September 16, 2009, 06:02 PM
Guy go siddon for gutter.In fact go compose your own beef track  Tongue
I no get anything to say you, anyway me and you fit do the collabo if you want.  Tongue Grin
aieromon (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #27 on: September 17, 2009, 12:44 PM »

I've heard this f#*@+ song somewhere and i was laffin' at the idiot that sang it.
Too bad the idiot had to be Nico.
@all
Another beef seems to be brewin' up between African China and Timaya.something about Timaya tryin' to do reggae music?
semid4lyfe (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #28 on: September 17, 2009, 11:29 PM »

IMO, everything the guy said about Timaya is true and spot on.

Timaya needs to step up his game, brag less and put more lyrical content in his songs.

dipo2much (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #29 on: September 18, 2009, 06:39 AM »

make everybody do him own thing. There is enough air for everybody to breath
baslone
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #30 on: September 18, 2009, 02:56 PM »

Quote from: semid4lyfe on September 17, 2009, 11:29 PM
IMO, everything the guy said about Timaya is true and spot on.

Timaya needs to step up his game, brag less and put more lyrical content in his songs.



I really don't see how he wants to step it up. Reading
today's PUNCH, I realised Timaya's got problems with
fellow artistes, with the media, hip hop awards organisers
as well as marketers.

Na so e dey start. Go ask Eedris!!!
Myself2 (m)
Re: Nico Gravity - I Wan Finish Timaya
« #31 on: September 18, 2009, 04:42 PM »

Quote from: baslone on September 18, 2009, 02:56 PM
I really don't see how he wants to step it up. Reading
today's PUNCH, I realised Timaya's got problems with
fellow artistes, with the media, hip hop awards organisers
as well as marketers.

Na so e dey start. Go ask Eedris!!!

Very true,he's become toxic baggage and most corporate organisations,artistse managers and even fellow artistes will soon begin to avoid him like a plague

I like the hard-truth diss by Nico,more reasonable artistes would've taken that as a wake-up call to amend their ways,but not Timaya
 Storm Records!  Swange Music: How Do You See It?  what time/day is jimmy jump off???Official Jimmy"s Jump Off Thread   Page 2
Pages: (1) (2) Go Up Send Topic to Friend by E-mail Reply 


Sections: Autos/Cars (2) Jobs/Vacancies (2) (3) Career Talk Education General(2) Politics Romance Computers Phones Travel
Sports Fashion Health Religion Celebrities TV/Movies (2) Music/Radio (2) Books Webmasters Programming

Links: Page1 Page2 Page3 Page4 Page5 Page6 Page7 Page8 Page9 Page10

Nairaland is owned by Oluwaseun Osewa. See also: Nairalist Classified Ads
Nairaland Forum | Powered by SMF 1.0.12.
© 2001-2005, Lewis Media. All Rights Reserved.