www.soundclick.com/nutraxNUTRAX EntertainmentPresents
Lagos Traffic Produced By Ghost Traxx________________________________________
• Album Intro (Shout out to all the Naija masses home and abroad, Lagos drivers, danfo drivers, molue drivers, taxi drivers, okada riders, hawkers, traders, mama puts, ice water sellers, pure water vendors, newspaper vendors, mobile showcase practitioners, jewelry merchants, recharge card and phone accessory retailers, pedestrians all di traders, omo Eko…How una dey ?)
E get many tins wey dey give Lagos city name o! Wedah na good name or bad name, that wan na for una to decide…if no be di rubbish heap wey dey for Oshodi or di doti wey scatter for along Ikorodu road, e go be di NEPA wey them take from Festac phase 1 carry go give Festac phase 2…or wedah na area boys wey dey keep peace or is it pieces… doz wey dey try make a living the only they seem fit…Di rich them dey for VGC and high brow Ikoyi dey drive Benz dey drink Five Alive dey chew short bread, while di masses them dey for Ajegunle dey enter Molue, dey climb okada dey chew chewing stick. Light no dey for Ogba but generator dey blast for Victoria Island… you go dey line for fuel station but oga tank dey over flow…see am as e dey inside AC dey drive 6 cylinder motor …masses never even see common gas cylinder… na kerosene stove wey mama Ronke dey use fry akara. So we don conclude say Rich and poor nor fit chop garri from di same soup pot…
Nonetheless, Lagos city get meeting point o! di only place wey masses and di so called elite fit meet …na for inside Lagos Traffic Jam …so even say you be millionaire or Billionaire wey dey use ragolis water dey brush teeth or you be aje-kpako wey dey form with pure water dey hide chop bone marrow…when you dey for inside Lagos Traffic e go definitely humble ya ego… Lagos Traffic na di meeting point of all di people from various works of life - di Masses and the elite…conductors, lecturers, vulcanizers, soldier…police them, molue drivers , danfo drivers, oga director, oga governor, recharge card sellers, handkerchief and underwear vendors, VCD and CD sellers, make una ask them for di latest gbedu wey them call Lagos Traffic, nurses and doctors o, students them, taxi drivers, okada riders with or without helmet, bankers, food and beverage retailers, showcase vendors, teachers, agberos, truck pushers, sisi eko them… Lagos Traffic na where everybody dey meet dey interact… wedah you dey bless or abuse oga conductor with ya mouth or you dey greet am with ya horn…wedah trailer don chance J5 or okada dey drag road with legehdiz benz, wedah you dey embrace Mama kunle just as okada nearly jam am from behind, wedah you march aunty Franca k-leg as you dey try dodge pedestrian traffic, wedah you dey for two lane wey them convert to 4 lanes or wedah you dey discuss in high tones with conductor dey demand ya complete change or person don collect ya wallet by mistake…my people na for inside Lagos Traffic wey Lagos Life dey start o! ,
Na eim I tok say make I use this meeting point… Our own Lokoja for Eko-city yarn una betta gist, knack una betta gbedu… because’ di average Lagosian dey for Lagos Traffic almost 1/2 of eim life, di odah 1/4 eim dey for either filling station dey queue for fuel; e dey work dey try meet up while oga don go house, e dey talk for phone, e dey load recharge card or e dey buy recharge card, e dey for tailor dey patch eim cloth wey tear for molue seat, e dey patch eim tire wey blow for pothole, e juss drop madam for market and pikin them for school, e dey drop egunje for check point or e dey argue eim case for inside police station, e dey for panel beater workshop dey pull out di dent for eim motor, or e dey for house dey chop, Or if you be sisi eko dey paint face bifor eim enter for traffic…or maybe eim just dey house dey sleep with empty belleh…. So therefore, una suppose use di remaining 1/4 of ya life dey cooleh like pure water …Kuku bring down una blood pressure. So where ever you find ya-self at this time, Just relax sit back, if you dey house off ya TV and Radio, if you dey for inside molue or danfo off ya GSM phone, if you dey siddon for mama Ronke buka make special music request for Lagos Traffic or if you dey chillax with madam and pikin them dey take small breeze for outside just tune ya radio listen to Lagos Traffic … this na free doctors recommendation o! Na ya special dosage before and after a hard days work…
Finally, remember say them get two types of Traffic o!, Bad Traffic and Good Traffic. Bad Traffic na when you wan rush go somewhere but go slow dey for ya front, when you burn ya clutch dey do brake and quench… when you want collect small change for bank and hold up come dey, when you wan enter market pick small crayfish for madam to cook soup road block everywhere, when you wan pick JAMB form or you wan check ya result people full everywhere… that wan na bad traffic. Now on the other hand, Good traffic na when you enter for night club and omoges full everywhere Deejay dey play di latest gbedu off the LAGOS TRAFFIC ALBUM, green light dey everywhere no brake light… ahen!!! that wan pass good traffic na real betta Lagos Traffic…
- This album ”LAGOS TRAFFIC” is Dedicated to the entire hard working Naija Masses home and abroad, .make una carry jeje dey go, carry jeje dey come… no live ya life for hurry o! –GHOST TRAXX.