|
denex
|
So I fair? Who come bad patapata? I still dey try Who come worst pass?
I yellow na’I'm make me fair My brother different so therefore E bad Na you come good because you white Thank God I manage fair, my own don better.
My sister, you no fit white sh`a try fair If you no fit fly, shey you go still jump? Take wig make you wear,see cream sef make you rub No be God? Black na disease wey get drugs.
Thank you Oyibo, you too try for us If no be you, we still for dey mad Thank you say this blackness go soon stop Thank you O, this madness go soon cure.
But no mind me O, I jus’ wan’ ask No jus’ mind me at all, but why you dey tan? If black so bad, why you like am. E wan’ come be say na you sef dey mad.
Sorry O, but E dey somehow You no like black but you wan’ black Na white better pass, you born half caste Which kain’ palaver come be all that?
Oyibo sir, abeg I know understand. "Master" please help me explain Jesus, God, Angel: all na white. This your "wayo" sef, na today?
Everything wey black jus’ bad Black magic, black leg, even black heart sef With your skin like overall eczema, Na you still wan’ dey criticize.
But me I never see person wey black before Me na yellow, my wife brown, my pickin chocolate. E come be like say na ya own brain black you no see black but you think black, you imagine black.
So now who come black? Your coat, your car, everything black Dye you hair black, smoke your air black, wear dark shade make you dey see black.
So bros, tell me who come bad. You wan' come brainwash your slave: "Black is beautiful"; "black ‘n’ proud" you forget say black na state of mind.
You don already black finish You jus’ dey shame to talk am But as you dey resist na ya sef you dey punish. You wan black, you dey try, so claim am with pride.
"Crazeman wey 'gree don already cure. So go ask John Hawkins, ask Lord Lugard. Who come kill my papa, who thief my land? Black Man!
NEX.
|