|
jaguda (m)
|
@ Nairalanders, sarcacism and whatever will not resolve the issues raised. The bobo dey vex say him guys jabo am, but i have a recipe for that, whenever any of my friends cross border go even Ghana, his contact details are moved to KIV (Keep In View) untill he shows face again, shikena. Stingy man na stingy man, no matter the area. but i hear say UK hard sha!
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
hmmm! ok o, My own na make i no go any hotel for UK come see any of my naija Bros dey clean the toilet, because me I go laugh openly o!!! Ehen!  laugh brother, laugh well well. but make sure say u pay the hotel bills o  the laff wey u go laff no go pass the one wey them laugh me when i dey like mad man where i de find level for naija  so no be today laff begin only difference be say, this time, as you de laff me, i de collect my hard currency and i go enter correct lecture room the next day  write exams and still do well  i no send your laughter  i'm good
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@ Jaguda! You too much Jare! I feel your style! @Darfur Hmmm! wetin dey smell for here! You forget to mention say You go dey smell shit and piss enter class the next day  , by the way me no go UK for those loitering as per sey me I don dey through wit school and as a Big Boy na only trainig fit carry my two legs go UK or Holiday. I no dey your kind of hussling!
|
|
|
|
|
|
godslead (f)
|
@ darfur and @ Elgaxon biko my bros them make una jiriwayo.Hmm because it looks like this tin is turning into darfur(Uk) Vs Elgaxton(Naija).Make e no b say when elgaxton reach hotel 4 UK na darfur e go jam dey clean toilet.Abeg o mi I no wan hear say 2 nigerians dey fight 4 news o.So therefore make una take am eazy.
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
many office workers for naija get some kind body odour wey be like say them de carry dirty toilet for body  (elgaxton i don touch you somewhere?  but when i clean the toilet of the hotel wey elgaxton de claim say he go stay, i go get enough money to buy body spray and correct bathing soap  still get change for bus (darfur no get motor o  ) and small to buy books etc wey i go read. change go dey for other bills too. BTW, elgaxton u think say the toilets wey dey UK na like that one wey u dey used to for naija  bro, try travel small u hear  exposure go help you well and in the unlikely event u find yasef for UK hotel, just know say UK no be naija wey poor people de worship rich ones for survival. for here poor people fit survive without the help of rich man and rich ones de respect themselves o. no disgrace yourself for public say u de laff hotel cleaner o. na you shame go catch. here na civilised society o.  no be that una PDP Abuja where if big man mess poor man and even smaller big men go de smile. here na respect ya self o 
|
|
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
@elgaxton, e be like say ya case na case of bad belle. i just go through all your posts for this thread, the only post wey u use smiley to show happiness na de last post wey u claim say i de smell. hmmmn  ewooo. i thought i was just having a good time here. i no know say some body de vex really. no worries, just try harder, one day, u go land for UK or something close. . . .  . . . . perhaps morrocco. . . .  . . . . . turkey . .etc sorry o
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
no mind elgaxton. him dey diss people wey dey wash toilet for abroad. at least they get paid on time and they can afford to buy soap/perfume (like someone mentioned) to drive out the smell afterwards. if you dey do that one for naija, you know say everybody go know where you dey come from. and you know say naija toilet no be a good sight o like say if them no dash you job for UK you no go take am. every successful person started from somewhere you know. 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@Darfur
I no get bad belle o! You just dey Yab nigeria like sey no be country again afterall no be sey make them born u here o!
@soul patrol!
C'mon so na to buy soap and all those kind things , that's what me I'm working for sha.
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
guy i can help you. i have a friend at the british high commission abuja. his name is Mr Winterbottom . he'll help you with visa. u hear. tell him darfur sent you  he wont fail me  i be student from a poor african family all alone in the UK no papa no mama here.and i no be thief. anything wey i fit do to make ends meet i go do am (except stealing and drugs). i no de shame b/c i know say na temporary stuff. no be my career. i get enough qualifications from naija to get the kind job wey go fit pay me to come spend holidays for UK in the hotel wey u de dream of  but i no get connection in high places for such jobs. so i came here. i de hussle, by the time i get british certificate, agenda go change.  i de God side. nothing de happen  i dey pay my house rent, tuition, trasport,clothes etc. no mama no papa. even sef i gas to pay for relaxation too  u know what i meanclubs, drinks etc (thank God babes for here like to be financially independent.  ) i get three jobs. na hussling. hoha. the tuition wey dey here, you no go fit pay am.  so leave me alone. sogbo
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
my people abroad, please send this my guy elgaxton something o. e be like say all him people wey dey abroad don jabo am, them no send an anything again, na im the guy just dey vex. biko, everybody put money together make we send am sometin, excluding chocolates and dollar/pound store items o thank you. maybe him eye go come down small. 
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
guy i can help you. i have a friend at the british high commission abuja. his name is Mr Winterbottom . he'll help you with visa. u hear. tell him darfur sent you  he wont fail me  i be student from a poor african family all alone in the UK no papa no mama here.and i no be thief. anything wey i fit do to make ends meet i go do am (except stealing and drugs). i no de shame b/c i know say na temporary stuff. no be my career. i get enough qualifications from naija to get the kind job wey go fit pay me to come spend holidays for UK in the hotel wey u de dream of  but i no get connection in high places for such jobs. so i came here. i de hussle, by the time i get british certificate, agenda go change.  i de God side. nothing de happen  i dey pay my house rent, tuition, trasport,clothes etc. no mama no papa. even sef i gas to pay for relaxation too  u know what i meanclubs, drinks etc (thank God babes for here like to be financially independent.  ) i get three jobs. na hussling. hoha. the tuition wey dey here, you no go fit pay am.  so leave me alone. sogbo God bless you my brother. you don talk am finish. anybody wey add jara is a counterfeit.  you're a perfect example of a hardworking person trying to make an honest living and these big mouths that still live with their pops/moms should learn a lesson or two. you know who you are! 
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
thank you my soul  elgie, i go work extra hrs this weekend. give me your number make i fax you credit  for ya mobile. infact, if things work out fine, i fit send you one handset (i go soon start new contract) so i go fax you the old one. na correct mobile,no fear. make i go do my cleaning job jare, my account done go down. . . . . . hmmn which one de today sef. . . . .thistle hotel abi na mariott. . . . ok na hilton. . . which one. . . .ok de one wey dey westminster. chei i don late oelgie, just give me ya number. i de go work now. cheers
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@ dafur!
I no dey for Uk groove!
Na Yankee be the groove, I go hail u when I come Uk for Hols or something!
me i know want phone wey them pick -pocket o!
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@ Darfur ! Use better perfume o! when u finish today own o! 
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
@elgaxton. your mouth sharp pass gillette razor. if them dash you pali to go nearby south africa to better your life, you no go go? 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@soul patrol!
na your turn now eh! ok o!
The question is wetin I wan South africa go do wey groove Abj!
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
elgaxton, elgie . . . . elgieeee. . . . . .NEPA don take ya light? na me o, darfur. i don reach work one hand. no hold up for road at all o. anyway, e be like say ya service dey down or NEPA don hit. anyway we go block later. i dey busy now for work. eheee, i get friend too for cameroon embassy in Abuja. he fit help out, anyhow abroad na abroad wether UK or cameroon. when you reach cameroon u fit bone all calls from naija like we naijans in UK  All de best bro. dey careful for gendarmes o
|
|
|
|
|
|
ne4real (f)
|
@ elgaxton (poster) and @ dafur
wetin connect both of u wey una de stroke unasefs like this?
abi una de marry one wife?
make una take am easy oooh.
i've got muscle-pulls on my stomach wey i wan die of laughter
man !!!!!!!!! i love this site
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
Daffy Dafy Duck! Darfur! so u dey travel go the work! chai too bad! na wah o! I sey me i no wan go London, if u get links for USA then we go talk! How many toilets u don wash now, na wah for Oyinbo so them get internet for toilet chei!!  maybe na that one carry u go Jand eh!
|
|
|
|
|
|
seun001 (m)
|
na wa ooo!!! 
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
it is a real wa o
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
hey elgie u don return? u say u wan enter US. hehehehehee  anyway sha, the connection wey i get na for US embassy in london. that means u go still 1st enter london so u still have to enter british high commission for Abuja. that brings us back to my friend Mr Winterbottom at the Abuja high commision  tell am say na darfur send you give me a call to update me (as I no go fit call you now, u know how far  we briticos no de ever call)
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
Daffy Dafy Duck! Darfur!
so u dey travel go the work! chai too bad! na wah o!
true true u nova comot that naija before. u no know say some cities na actually megacities eh?  elgaxton de bushman  many "cities" dey for london u hear. . . . . westminster, tottenham, chelsea, fulham, enfield(greater london) etc US has more megacities. anyway, you go try disvirging your passport with cameroon  anyhow, abroad na abroad 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
Daffy!!
So na me u dey form Baddo for eh, so You want make i enter UK make I come be like u eh( no way o)
Na only Holiday or training fit carry me go there,
If I no fit go Yankee straight na him be sey I don stay my house for ABJ at least na only light and water una enjoy there steady
, meanwhile u don use perfume so, I know sey the toilet wey u clean today carry big blocks(shit), O'l boy wetin be
colour of Oyibo shit? e dey white?
Oya go baff!!
Na only people like u na him Cameroon be abroad for, I know sey na all those kind korro u follow sneak go UK!
No too yarn o, I go contact the embassy for there make them check out your visa o!
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
bros no worry. i go soon finish school. i'll return to naija as a british trained technocrat, i go come be your boss for that your office  i know say cameroon no go even give you visa, but anyhow i go tell yar'adua say make him try extend ya visa to remain in naija b/c i hear say e be like say u from chad sef 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
O'l boy answer my question, How u wan take meet Yar' Adua, when I dey Abj? You no even ask where i dey stay for the Abj wey mosquito no dey, You see yourself? Isi aki, Go come back! u hear! by then I go employ you for my Company, just to help thee, Oh i forget sey na shit u specialize sef, wetin u dey study for school? Shit packing technology abi u even dey Unihome sef dey do sit down look, pack shit and sleep!  I know sey na Niger Republic u from come! Na him make UK dey shark u!
|
|
|
|
|
|
The One (m)
|
@darfur
you seem to have a misconception common to Nigerians abroad which I always try to correct. Whoever told you that you have to be connected to get a job in Nigeria? I know hundreds of people who didn't have any connections and are very gainfully employed now, living well above the average person in the UK.
Look, I am in the UK right now in school and I've seen both sides. Anybody that wasn't good enough to crack the job market in Nigeria will not vrack the market for the same kind of job in the UK. The quality comes through wherever you are. The reason you think it's better in the UK is because you are ready to do jobs won't touch in Nigeria. Abi person wey no dey good enough to enter oil company for naija go enter for UK? And don't tell me it takes connection to get into an oil company in Nigeria because it doesn't. That is not the view of Nigerians abroad though because it's a convenient excuse they use in convincing themselves that their decision was right. Ihave seen people try to get into the oil industry (for instance) in naija and in the UK and you find out tthat i is those people that got offers in Nigeria that also get offers in the UK. If you are ready to work in Mr Biggs, you will know there is work but no, you won't while you can go and work in Mcdonalds and then claim you need connection to work in naija.
Get your facts right brother!!
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
@The One. thanks for setting our brother straight o. he seems to think that everything revolves around "connections" and whatnot. at one point in your life, if you can't stand on your own two feet and work your ass off to get ahead based on performance, how can you stand proud? nigerians are just so into this whole connection bullshit thing - who said you can't get a decent job without knowing someone? your work should speak for itself. hiss! better quit that mentality. you don't realize that the people you're dissing are better off than you because they're making an honest living, whether it be dishwashing, hotel cleaning, burger flipping and whatnot. at least they're responsible. get a clue abeg, and if that still doesn't teach you anything, then please, darfur, help us get your friend, mr winterbuttocks, er i mean, winterbottom  to come and help elgaxton o. biko. 
|
|
|
|
|
|
Siena (m)
|
It's worth following this thread, just for the sheer entertainment value!
@ Darfur: Could you email / msn me? It'D be great to chat to a fellow Nigerian, and perhaps meet up.
@ Eglaxton: You do make me smile! I've no doubt you'll suceed in whatever venture you put your mind to, get in touch though.
|
|
|
|
|
|
PurestBoy (m)
|
Na true u talk joo. Nigerians in UK are very stingy, they always complain of no money and tax always and that they overworked themselves. They will even ask you to wait for a better time if u tell them u want to come over. They lie too much and they say all their money go on tax. Ask them to come back to Naija to work since they are complaining, they will refuse. Imagine a friend from UK flashed me and ask me to call him back.
Na wa oo
|
|
|
|
|
|
nynlicious (f)
|
All stingy men in da house are defending themselves voraciously, Lol. The truth hurts so bad!
@poster, thanks for a post like this. Men in Uk are scum bags, looking to reap where they didn't sow. extremely selfish, rude etc. did i mention they re gigolos? its so sad! perhaps they were good back in the days, but like y'all know what pounds can do to people. No matter how good their job is they still want to live off a woman, their wages is only for building in Nigeria etc shame on you guys!
|
|
|
|
|
|