|
|
|
omoge (f)
|
 @omoge how much do you pay darfur for his services? the guy is just damn too efficient.
|
|
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
omoge, call the guy before he dies from lack of affection from ur end o. 
|
|
|
|
|
|
omoge (f)
|
LOL  . the phone fall for inside water for bathtub  . omoge, call the guy before he dies from lack of affection from your end o. 
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
chei, ur lie no even hard. if u talk say thief steal am, i for believe u more. call am now. we dey wait o. 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@soulPatrol No mind Omoge jare  how far ur side?  @Omoge ur security too much courtsey of darfur! sun no dey shine for that place wey u dey? put the phone for sun dry am na!  u never even tell me the spec of phone wey u want sef  I'm stilll waitin sha 
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
@elgie e be like say you go wait until hell fire freezes 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@toshman wetin u sey make i do na? should i fashy Omoge and go for SoulPatrol, abeg tell me your opinion.  I don tire to wait jare
|
|
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
let me advise you. soulpatrol has alligned herself with the so called stingy diasporeans, so it wont be good to go for her. it will be foolhardiness to follow omoge b/c that darfur of a guy is a very bloody obstacle.
my advice is that you go for babes like simple-me. she is simple and is just herself. she is outspoken and will tell you her mind ASAP. if she like you, e go gel one hand, if she no like you she go tell you one time, she fit even advise you who to go next. leave darfur alone, let him eat omoge if he likes.
my 2 kobo
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
and try change that picture for ya profile. it's too local. nairaland is not an avenue for the glorification of poverty. (it may be why omoge and her security chief-darfur don't want to have anything to do with you sef) 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
Ok o toshmann!
I go change the pix but make simply me see am first, she fit just like me simply,
My pixes are in another system, can't get there now!
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
true she fit like am. the babe dey very different. i wish you luck
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
Thanks ToshMan 8)n!
|
|
|
|
|
|
omoge (f)
|
hehehehe laughing  El, sorry it's not an elepy keyboaring  . The thing be say, I tried to put my pix in there but anytime i put the picture, na only the elepy on dried landscape me too dey see. I'm trying to make my real pix stay put. Hang in there. the weather has changed you know (no more sun). i still put the phone on the roof top. so i'm waiting for it to dry up. oh yeah sorry i haven't told you specifically the kind of phone i want. it's not in the market yet. i will find out from verizon, tmobile and sprint and let you know. You know, just hang in there.
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
omoge e be like say u go 1st arrange ambulance wey go come carry my man b/c the guy heart don scatter to pieces and now na I'm brain wan join am put.
|
|
|
|
|
|
soulpatrol (f)
|
toshmann, ur mouth o. na me u dey call stingy? my brother, far from it o, wasn't i part of the people rebuking ya'lls stinginess? get ur facts straight o. and between, me i no dey compete with anyone for man on nairaland, so no even try hook me up with anyone. i get my own, thank you very much. 
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
@ToshMann I think sey u dey my side, anyhow sha, i get plans @Omoge I think sey na cute babes them dey call omoge but as e bes ey u don describe ur size, make we take anything wey bite us for night as mosquito  I no dey for futuristic groove wey u dey think about iPhone version 2.0 e no work? call me first with the toy wey u get now  Soul e mama cool down na
|
|
|
|
|
|
V.C.2007 (m)
|
Its really funny with this their oyinbo wey them dey go. One owed my just 10,000 naira before leaving for UK. Now whenever he sees me on-line, he will sign out. He has refused to reply my mails.
Naija is blessed abeg!
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
God blessed naija. naijans scatter the blessing. i hear say port harcourt na war territory. say the abductors are now going to homes to abduct people. it is now risky and unsafe to be rich or successful in port harcourt
|
|
|
|
|
|
Mc Omo (m)
|
This stingy thread still dey ? Stingy people !
|
|
|
|
|
|
omoge (f)
|
Its really funny with this their oyinbo wey them dey go. One owed my just 10,000 naira before leaving for UK. Now whenever he sees me on-line, he will sign out. He has refused to reply my mails. Naija is blessed abeg!
LOL  for real? well maybe he is broke  .
|
|
|
|
|
|
omoge (f)
|
El, just hang in there 
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
El, just hang in there  elgie this na polite american way of saying. . . "go hang" 2mrw una go say na darfur stop elgie from meeting omoge, but se as the babe don talk am say make elgie go hang. and she don talk am more than once. my man still de get hope toshmann this guy wey de smoke gbana, wetin concern you for this bizness  i hear say u get reputation for women for nairaland, just be careful. this one wey u don suddenly get interest in this thread, de even suggest make elgie leave omoge alone, to clear space for ya ambition, you think say i no know? look, i no care where u de live, but before u get to omoge you must follow due process. and that means you must get appropriate authorisation from. . . . . . me
|
|
|
|
|
|
|
|
darfur (m)
|
elgie i be ya friend o  how was ya b.day?
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
Darfur so na one week later u remember my birthday! You are a good friend indeed! The birthday was cool though, my office celebrate am for me, plus all the gift them wey i receive. Guess what? My friends wey dey far from abuja just dey send me credit anyhow(seriously o  ), I say make i call una na, no numbers, I sey make una call me, for where? Anyhow sha make una drop una numbers now so that i go hail una for the celebration season wey dey close here na 
|
|
|
|
|
|
|
|
Elgaxton (m)
|
na me u dey doo ummm for eh? is that a groan or a sigh! just dey burst jegge anyhow 
|
|
|
|
|
|
toshmann (m)
|
hope against hope. hmmn, na wa o
omoge that song wey u dey sing old pass u, why u de use am for elgie? u mean o
|
|
|
|
|
|
omoge (f)
|
toshmann  yeah but full of meanings now eh  Elgie dearie, my phone is almost dried (it's slow to dry up because of no sun). you got ta hang in there you know  .
|
|
|
|
|
|