na wa o! this kin hate hate mata tire me o! all those people wey dey claim say them no hate person for here, una don ask them wether na themselves them hate?
As for me sha! i fit hate anybody wey i like but if at all i hate anybody, e no go get effect because i kukuma no sabi the person, afterall, na computer the person dey,
na to sharap my mouth dey look like lucozade i go do o for hate mata,