Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / NewStats: 3,150,288 members, 7,807,975 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 12:50 AM |
Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# (8978 Views)
See What Happens When You Mistakenly Shout Sai Baba In A Fuel Queue(pic) / This Happens Only In Nigeria... / Hilarious Made In 9ja Keke (pics) (2) (3) (4)
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply) (Go Down)
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 5:57pm On Nov 01, 2013 |
tspun: una don hear the latest news ?wetin be the new? Abi una no wan tell us? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 6:15pm On Nov 01, 2013 |
tspun: una don hear the latest news ?wetin b d latest news?? Abi na gud or bad news? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 6:21pm On Nov 01, 2013 |
Damex333: wetin be the new? Abi una no wan tell us?y u dey ask am?? U sef wan follow knw? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 6:36pm On Nov 01, 2013 |
Damex333: i stop you? Shebi sitting room dey? And tom and jesry film dey play? Shebi na bedroom me and you go dey dey charge ur phone?na only 4 ya bedroom u go fit charge fone wit her? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:41pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: That fine tall, always smilling dude with white hair, I don forget im name, but you no knw am again? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:53pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: The thing be say I no know whether you good or bad, so I like hear from the horse mouth as oyinbo talk.., You good or bad? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:57pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: My kingdom dey above this kingdom, we dey teleport go anywere we like, we dey live very happily without stress and everybody na Genius. Free food, free jolly, no oppresion, no suffering, all happiness, all... Make I continue? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 6:59pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: How ur mata be self? Why you go know at all? You be Noah wife? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:04pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: No wahala follow na, abi u dey fear lesson? No be teach I wan teach u? U no knw say na were I dey comfortable be that? Where I go teach u to ur understanding, u go even come dey teach me the next day sef.. 9months no be wahala na, or you dey fear to be Mama Junior? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:05pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: That one no be bad mentorship so? You don follow the way nai Me no follow? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:08pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: No be wetin you dey yarn be that? You think say me self dey go private sch? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:10pm On Nov 01, 2013 |
Jovanna: dem tell u say i sabi cuk? hapi new month madam, hope u sabi cuk egusi soup? You no sabi cook? So na how my brother wen u marry go come tke chop na? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:15pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony: Dat kind faith dry na, shey? The faith wen I go respect be say, Go Atm machine and type 1.5million wen im be say na 20thousand dey. . .na dat kind faith I go respect. Instant faith Abi u no like that one? Okay which kind 'everything' u wan hear? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 7:17pm On Nov 01, 2013 |
tspun: una don hear the latest news ? Brother, wetin be the Latest news? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by tspun(m): 7:19pm On Nov 01, 2013 |
Damex333: wetin be the new? Abi una no wan tell us?na so u dull ? U one tell me say u nover still hear uptil now ? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 8:00pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:fast food no dey again? Abi e no sabi soak gari make e use groundnut chop am? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 8:02pm On Nov 01, 2013 |
How far my padis 4 here? @damex nd Ef hope u no disturb those chicks 4 una street 2much? My personal persin @preti-ebony how parol nw? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 8:11pm On Nov 01, 2013 |
Jovanna: fast food no dey again? Abi e no sabi soak gari make e use groundnut chop am? The fast food girl no be human being? Or u want make she give ur hubby both food and er...m er...m that thing? Na so u wan suffa my brother? I go recommend a bakassious and manchestally inclined housegirl for una... |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 8:13pm On Nov 01, 2013 |
Jovanna: How far my padis 4 here? @damex nd Erf hope u no disturb those chicks 4 una street 2much? My personal persin @preti-ebony how parol nw? Damex, no be u dem dey ask? I hope u no disturb the chicks 4 ur street too much? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Tmonex: 8:24pm On Nov 01, 2013 |
Make i jst Answa all of una, abeg wetin be d question?? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by ERF: 8:52pm On Nov 01, 2013 |
Tmonex: Make i jst Answa all of una, abeg wetin be d question?? Which question be that? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 9:46pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:The dude fine reach as u don describe am so? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 9:48pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:na wetin u dey try talk nw?? Sey i no dey mentor u well? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 9:52pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:y i no go fear? Coz u dey comfortable, u wan mah follow dey comfortable? How i go take teach u wen i no even believe sey u go knw hw 2 teach me? If i b mama junior, u go gree b papa junior? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 9:53pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:how i go take knw?? Na me send u skul? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 10:58pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:Una dey fly? U no knw sey i 4 lyk join dat kingdom? I no fit kum be princess 4 dia? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:00pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:which tin again housegirl d give her master?? B4 nko? As ur broda marry am, u no knw sey hin go sufèr? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:05pm On Nov 01, 2013 |
Jovanna: How far my padis 4 here? @damex nd Ef hope u no disturb those chicks 4 una street 2much? My personal persin @preti-ebony how parol nw?since wen i bcme ur persnal persin sef? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:05pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:wetin be ur own 4 our mater sef? Ur broda no knw say i no sabi cuk b4 e cari me 4 huze? Abi u want mah kill dat huzegurl u wan bring? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:07pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:i ask u sef join nw abi u no fit ansa? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Nobody: 11:07pm On Nov 01, 2013 |
E<R>F:hw dat wan take concern u? No b na nrmal tin 2 disturb chicks wey dey area?? Or u wan follow am? |
Re: This Happens Only In 9ja: Long Complete Conversations With Only Questions #FACT# by Jovanna(f): 11:08pm On Nov 01, 2013 |
PretiEbony:since 1901 abi u don 4get? |
(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (Reply)
Am Back / Guinea Brocade / 56 Funny Facts About A WOMAN
(Go Up)
Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36 |