Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,539 members, 7,808,988 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 08:36 PM

I Love Naija I No Go Lie!!! - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / I Love Naija I No Go Lie!!! (1873 Views)

Naija I Hail Ooh! / only for naija -I Love My Country / Imagine Shooting A Video Like This: Lmfao, Naija I Hail The (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

I Love Naija I No Go Lie!!! by FemoLondon: 9:35pm On Nov 11, 2014
I LOVE NAIJA I NO GO LIE!!!

God Bless Nigeria!!!

Na only for Nigeria you fit win Aeroplane by loading N200 MTN Recharge Card.

Very soon Etisalat go say recharge N200 and win a big ship.

Then Airtel go com follow sey, recharge N100 and win Benin Republic.

Glo, go just kuku say... Recharge N500 and win Nigeria because their colour na Green.

Na only for Nigeria you go see fish inside"MEATPIE"

Na only for Nigeria we dey count money after we withdraw am from ATM because we no even trust ATM machines.

Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if you pay your light bill (wat a pity)

Na only for Naija people dey horn for traffic light make e quick change from Red to Green.

Na only for Nigeria Pharmacy dey sell Coke, Recharge Card, Chin chin,Puff puff and beer.

Wetin you no see for Naija, you no fit see am anywhere in d world...Trust me.

Na only 4 naija you go find a graduate of Mechanical Engineering dey do him NYSC 4 Police station.

na only 4 naija you go see one person dey use Bold5, X3, Ipad2 and Nokia N8 all at once.You be Bill Gates? Abi na you invent internet?

Na only 4 naija you go see a graduate of law dey work as generator repairer.

Na only for Naija u go buy coke, dem go say make u no forget to return d bottle.

Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey...

Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country herself.

Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to make quick money.

Na only for Naija u go wish somebody 'happy birthday', he go answer 'same to u'.

Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED"

.. im proud of dis my country
Re: I Love Naija I No Go Lie!!! by adeyiga3(m): 9:40pm On Nov 11, 2014
No mata wat I love ma country

1 Like

Re: I Love Naija I No Go Lie!!! by chibanj(m): 11:14pm On Nov 11, 2014
Na 4 only Naija, you go see madman dey control traffic, people wey their head correct dey obey...


grin we too much abeg

1 Like

Re: I Love Naija I No Go Lie!!! by Nobody: 6:18am On Nov 12, 2014
Lol, you killed it grin

1 Like

Re: I Love Naija I No Go Lie!!! by Funniez: 12:16pm On Nov 12, 2014
Na 4 naija u go see poor man dey trekk under hot sun dey sell books with d title "HOW TO BECOME A MILLIONAIRE IN TWO DAYS". I just dey wonder why him neva read am.

1 Like 1 Share

(1) (Reply)

Please, This My Joke Will Crack Your Ribs / When Roman Abramovich Saw Ifeanyi Uba Slap Mikel Obi's Elder Brother. / Top 40 Mugabe Quotes

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 11
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.