Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,764 members, 7,806,090 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 11:17 AM

My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess - Pets - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Pets / My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess (40080 Views)

I Threw My Cat Away / I Named My Cat "Osinbajo" / LOL!!! Meet The Man Who Gave Up Being Human To Live Like A GOAT (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply) (Go Down)

My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 7:04pm On Jan 09, 2015
I hail u my people... I hope say all dey ok?

As I dey read plenty topics for this section e b like say I wan yarn small about my cat. Na this time two years ago, I don dey receive call from padi mi wey I know for work. E come tell me say this cat don become homeless... homeless sha?! how come?!

The cat don dey for one house like that, wey people nor sabi look after animals, e b like say the person head nor well at all. They don throw am for winder from 12floors high, reach ground. Omo God dey ooo - lucky say this cat nor dey break back!

Anyway sha, I don home am for one night initially - omo na almost two years don pass since!!

I don name am Tippy, na appropriately so, when u don dey think wetin happen to am. Since the time wey I don own am, omo nor b small mata.... she get one luxury fluffy bed, a personalised cushion cover, pink litter tray, cute food bowls and mat, a clawing board, a clawing tower with hiding space, toys don full the house self!!

She don tey since with these her toys ooo - I look am like... imagine na u be cat for 9ja oo - u nor go sabi anything sha. She dey lounge about anyhow, still as she don dey get all those things, she still come sleep for another place, like MY sofa!! She get big eye oo, na she dabaru!

Na house cat she be, e b like say if I free am for outside, another catgo scatter am anyhow, she go return house look like she don chop wowo lick plate!!

Chaiiii - God dey ooooo smiley

As you don read my topic finish, if u wan see more you for add me on here. I also get facebook (Oyinbo Princess) and I dey for twitter too @OyinboPrincess

Videos uploaded weekly on YouTube - subscribe to and watch Oyinbo Princess

ONE LOVE!

50 Likes 2 Shares

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by nwaanambra1(m): 7:16pm On Jan 09, 2015
okey we don hear!

now tell me wetin you wan make we do for u?

you wan make we find u 'horseband'? undecided undecided

40 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 7:18pm On Jan 09, 2015
Funny Op

If u see as i take rush open this thread as i see kitty cat.wink
Mstcheww
Op i no blame u shaagrin,
na my dirty mind I go blamegrin

By the way dat ur kitty dey flex wella shaa
Take gud care of am abeg
#luvCats

39 Likes 1 Share

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by SELENAqueensy(f): 7:30pm On Jan 09, 2015
So oyibo sabi pidgin like this?
E make sense o

39 Likes 1 Share

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 7:31pm On Jan 09, 2015
@nwaanambra1 - I nor wan make una take do anything sha - if una like make u follow my twitter, if u nor like abegieee nor b by force wink

@ KELVINXY - omo I nor dey blame u sha... see as u don dey rush am sooo, deliverance don dey come ur way grin I nor blame u self, na catchy title go get views ooo wink I don take good care, ose baba smiley

27 Likes 1 Share

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 7:32pm On Jan 09, 2015
@SELENAqueensy - ose smiley I hail u oooo!! Highest HAIL self - check youtube for a laff oo

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 7:42pm On Jan 09, 2015
OyinboPrincess:
@ KELVINXY - omo I nor dey blame u sha... see as u don dey rush am sooo, deliverance don dey come ur way grin I nor blame u self, na catchy title go get views ooo wink I don take good care, ose baba smiley
Chaii
I don bendcheesy
See as oyinbo dey chop pidgin like pepperoni.! shocked
U make sense joorwink

26 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Nobody: 7:56pm On Jan 09, 2015
Nawa o! U sure say u no be naija product? Anyways oyinbo people don dey copy our swag sha. Maybe na google translator u dey use. Who knows

7 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 8:04pm On Jan 09, 2015
It is a lie o cheesy
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 8:15pm On Jan 09, 2015
@KELVINXY - beta blending baba.... na pepperoni confirm grin e don sweet me well well self - abeg follow me jare cheesy u knw say eh, person like una good for me sha - u for help me go viral smiley OOOoooosssseeeeeeeeeee

@pureguide - omo nor b 9ja product ooo - I b confirm whitey smiley yes, Oyinbo don too like to follow 9ja sawg, because e don hot wink google na a very good thing ooo, but I nor need make e help me write, I don go school well well before sha!! Shooooo u too dey fear - if disbelief dey ur mind, go youtube watch my videos, then make I hear wetin u wan yarn grin

YouTube - Oyinbo Princess
Titles - Hit Me, Mata Dey O, Omo See Yanch

13 Likes 3 Shares

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 8:30pm On Jan 09, 2015
OyinboPrincess:
@KELVINXY - beta blending baba.... na pepperoni confirm grin e don sweet me well well self - abeg follow me jare cheesy u knw say eh, person like una good for me sha - u for help me go viral smiley OOOoooosssseeeeeeeeeee

grin
I knw sey u go like pepperoni,e dey ur facegrin
No wahala shaa
I don follow u for twitter
So na ur turn to go follow back.smiley

#you Just made my day

3 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 8:34pm On Jan 09, 2015
@KELVINXY - I don follow back Mr Man smiley chaaiiiii - pepperoni no dey for my face joooooooor shocked LOOOOOL - na viral mata dey for ur hand so ooo! Omo Chineke Baba dey ooo!!

ps - kiss @ just made ur day

2 Likes 1 Share

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Prodeegee(m): 8:48pm On Jan 09, 2015
*e be like say dust dey my eyes*


Brb...make I wash am

7 Likes 1 Share

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 8:53pm On Jan 09, 2015
@Prodeegee - omo dust nor dey dem ur eyes ooo wink abegieee make u nor make am sore with all this ur washing mata Baba grin

Check am for YouTube - u go believe say ur eye don dey tell u truth finally, na so e go b oooo shocked

2 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by KELVINXY: 8:58pm On Jan 09, 2015
OyinboPrincess:
@KELVINXY - I don follow back Mr Man smiley chaaiiiii - pepperoni no dey for my face joooooooor shocked LOOOOOL - na viral mata dey for ur hand so ooo! Omo Chineke Baba dey ooo!!

ps - kiss @ just made ur day

U na confirmcheesy
No worry u hear?
Just leave mata for mathaiswink

3 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 9:13pm On Jan 09, 2015
O girl, no be play o, I waka find you go YouTube, who teach you this kind pidgin wey you dey yarn so. Thumb up. I dey enjoy your style. You just perfect my day men.

12 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Nobody: 9:13pm On Jan 09, 2015
OyinboPrincess:
@KELVINXY - beta blending baba.... na pepperoni confirm grin e don sweet me well well self - abeg follow me jare cheesy u knw say eh, person like una good for me sha - u for help me go viral smiley OOOoooosssseeeeeeeeeee

@pureguide - omo nor b 9ja product ooo - I b confirm whitey smiley yes, Oyinbo don too like to follow 9ja sawg, because e don hot wink google na a very good thing ooo, but I nor need make e help me write, I don go school well well before sha!! Shooooo u too dey fear - if disbelief dey ur mind, go youtube watch my videos, then make I hear wetin u wan yarn grin

YouTube - Oyinbo Princess
Titles - Hit Me, Mata Dey O, Omo See Yanch

Nawa o

6 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 9:28pm On Jan 09, 2015
@iyisco2001 - I don glad say na u don see am with ur own eye b that - na u go tell me nor b lie oooo abi smiley ose baba

@pureguide - na so OOOOO!! grin

2 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 9:33pm On Jan 09, 2015
OyinboPrincess:
@iyisco2001 - I don glad say na u don see am with ur own eye b that - na u go tell me nor b lie oooo abi smiley ose baba

@pureguide - na so OOOOO!! grin
U for just edit the topic of the thread na, make u just change am to "my kittycat just dey live like queen"
E go dey meaningful like that.

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 9:43pm On Jan 09, 2015
@iyisco2001 - e nor go let me change am na.... sad or I nor sabi how - one or the other sha
Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 9:46pm On Jan 09, 2015
OyinboPrincess:
@iyisco2001 - e nor go let me change am na.... sad or I nor sabi how - one or the other sha
Waka go the first post wey you take open the thread, click modify, for the page, find the topic/subject section, then put wetin u want for there, submit am. Na so everything finish.

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by niggadee(m): 10:00pm On Jan 09, 2015
U know 2 much are u British

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 10:02pm On Jan 09, 2015
@iyisco2001 - I go try am now sha - oooosssseeee grin

@niggadee - na so I b ooo, una for check my video smiley

3 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 10:04pm On Jan 09, 2015
@iyisco2001 - OOOSSSSEEEEE BABA - I hail you ooo - u don see am abi?! grin na chief learner b me ooo cool

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by iyisco2001(m): 10:07pm On Jan 09, 2015
@OyinboPrincess no be big deal na, e don sweet well well like that. How u take enter nairaland self dey amaze me. There is God o. Wey me I never perfect myself for your language finish, u don master my own.

3 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by niggadee(m): 10:18pm On Jan 09, 2015
Your head dey there u sabi speak pidgin English Fluently and Confidently.

2 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 11:07pm On Jan 09, 2015
@iyisco2001 - lol e don beta jare - ose... omo na nairaland b the 'hub-ub' of the 9ja society and culture, na learning curve for me self... make I follow learn better things sha smiley abegiee baba, I never master am yet ooo - na longest way to go self! But, ose, all the same

@niggadee - omo na head mata ooo Mr Man - I knw say na my head I don take learn am, but na my heart go carry me finish am smiley

I hope say una both don see my video and follow me ontop twitter / facebook grin

5 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by yurme(m): 12:22am On Jan 10, 2015
Nawa 0

4 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Prodeegee(m): 6:17am On Jan 10, 2015
OyinboPrincess:
@Prodeegee - omo dust nor dey dem ur eyes ooo wink abegieee make u nor make am sore with all this ur washing mata Baba grin

Check am for YouTube - u go believe say ur eye don dey tell u truth finally, na so e go b oooo shocked

No worry, I don put u up for adoption...

2 Likes

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by OyinboPrincess(f): 11:26am On Jan 10, 2015
@Prodeegee - I nor b dog ooo - which kind adoption u yarn na?!?!

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by yurme(m): 11:34am On Jan 10, 2015
Lol adoption keh

1 Like

Re: My Cat Just Dey Live Like Queen Oooo!!! - Oyinbo Princess by Nutase: 3:08pm On Jan 10, 2015
na u b dat for d pix. kitty cat ke. be careful o.

2 Likes

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (Reply)

Lady Scolds Her Dog For Giving Birth To 6puppies Without Any Job (pics/video) / Joachim Iroko Names Daughter 'Aisha' / My Dog Is Going Blind :'(

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 36
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.