Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,147,934 members, 7,799,158 topics. Date: Tuesday, 16 April 2024 at 04:14 PM

My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA (1875 Views)

'Governor Wey Dey Pay Killers': Protest In Abuja Over Southern Kaduna Killings / Prof. Alexia Thomas To Buhari: Shut Down Nigerian Embassy In Uk Within 48hrs / Femi Gbajabiamila Suspended In Georgia For Collecting $25,000 (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by easystudy101: 9:56am On May 14, 2015
Last friday I travel go Atlanta to go renew my passport. I go change my passport to de one wey dem dey call e-passport. I don postpone dis trip too may times until I come decide to do am before March finish. And I go tell you say de waka to get my new passport no be small waka.

I start online to find out wetin and wetin I need to carry go de embassy office. My online waka come turn to full time research abi na project. I see plenty sites wey tell me different tins wey I need to carry go de embassy office. From birth certificate, local government identification letter to gurrantor letter wey I go declare all my property.

I come discover say some of de tins wey some of de site dey ask for no dey with me for US. Den when I try to call de number for de website, nobody gree pick. I try email, I no get any reply. Na dat time I come begin one by one to eliminate de tins wey no dey necessary . I come start to narrow everytin to US requirements. Na dia I come find out say if you wan change ya passport for Atlanta office, you go need:
Online application ( you go fill de form online, den come print am)
Money order $106
Letter say you don pay de money
Receipt of money wey you pay
Processing fee $30
Ya old passport
Photocopy of de biodata page
One passport photo
Afta I finish to gada everytin wey I need, I come begin plan my trip. I reach Atlanta on thursday, den friday around 10 'oclock for morning I land de office. When I enter Inside, and den look around, ee really feel like any typical office for Naija. For wall dem get TV wey dey show NTA and den anoda side you go see de ambassador and Oga Jona photo. Pidgin english and oda naija languages just dey fly from all angles.

And as usual, we get awa own naija wey to organize tins. Some sidon, odas dey stand up as chair no reach everybody. Some wan hurry finish quick quick. Na so some go wan take style jump line to go front. Even dos wey dey work dia no even fit coordinate de place well. As you come in, na so you go pick number. But I come notice say de workers (one of dem na phillipino woman) just dey call de number at random. Sometimes you go hia 76, den lata you hia 51. One woman wey de tin no gree come ask dem why dem dey jump number like dat, de workers explain say na de way de tin dey for dia list...lol.

Afta dem check ya documents finish, dem go come send you go anoda room where you go go snap picture. If you snap finish, dem go tell you to go bring priority envelope. Some body go direct you to go anoda building (wey no be post office oo!) to go buy de envelope. For dia one babe dey dia dey make quick money. Envelope wey dem dey sell $4, she go sell am to you for $10. Trust naija and dia hustle. I sure say na people for de embassy dey arrange dis one. And dem no go tell you for dia website to come with de envelope, so dat you go come de embassy come buy dem own (naija eh...!)

Well I tank God say my waka no enter K-leg. Everytin go smooth for me. Some people for dia say dem don come like three times, and each time dem go tell dem to go bring one tin or anoda. But afta everytin, de place dey organise sha as per yankee standard. Who say naija no dey respect dem sef when dem need to. Dem know say if dem try any of awa usual nonsense for yankee, na double wahala for dedi body for dem be dat.

7 Likes

Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by Spaxon(f): 10:08am On May 14, 2015
A round of applause for the write-up undecided

2 Likes

Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by Lordave: 10:20am On May 14, 2015
OP, did you study Pidgin English in College?

2 Likes

Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by yatch360: 10:49am On May 14, 2015
Classy pidgin English. Hope u didn't fill the forms in pidgin wink
Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by AAinEqGuinea: 4:21pm On May 14, 2015
Enjoying your write-ups @op

yatch360:
Classy pidgin English. Hope u didn't fill the forms in pidgin wink

I would've cool
Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by SUBWAY101(m): 4:51pm On May 14, 2015
Nice write up, you too make sense.
Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by easystudy101: 5:13pm On May 14, 2015
SUBWAY101:
Nice write up, you too make sense.

Tanx my dear

And you fit check out more gist for my blog- lifr4yankee
Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by AAinEqGuinea: 5:33pm On May 14, 2015
What's bring you to America @op??


Any pictures you'd like to share? smiley
Re: My Experience For Nigerian Embassy Wey Dey For Atlanta Georgia For USA by abeeolars: 5:02pm On Mar 31, 2018
how many days you use before you get the new one

easystudy101:
Last friday I travel go Atlanta to go renew my passport. I go change my passport to de one wey dem dey call e-passport. I don postpone dis trip too may times until I come decide to do am before March finish. And I go tell you say de waka to get my new passport no be small waka.

I start online to find out wetin and wetin I need to carry go de embassy office. My online waka come turn to full time research abi na project. I see plenty sites wey tell me different tins wey I need to carry go de embassy office. From birth certificate, local government identification letter to gurrantor letter wey I go declare all my property.

I come discover say some of de tins wey some of de site dey ask for no dey with me for US. Den when I try to call de number for de website, nobody gree pick. I try email, I no get any reply. Na dat time I come begin one by one to eliminate de tins wey no dey necessary . I come start to narrow everytin to US requirements. Na dia I come find out say if you wan change ya passport for Atlanta office, you go need:
Online application ( you go fill de form online, den come print am)
Money order $106
Letter say you don pay de money
Receipt of money wey you pay
Processing fee $30
Ya old passport
Photocopy of de biodata page
One passport photo
Afta I finish to gada everytin wey I need, I come begin plan my trip. I reach Atlanta on thursday, den friday around 10 'oclock for morning I land de office. When I enter Inside, and den look around, ee really feel like any typical office for Naija. For wall dem get TV wey dey show NTA and den anoda side you go see de ambassador and Oga Jona photo. Pidgin english and oda naija languages just dey fly from all angles.

And as usual, we get awa own naija wey to organize tins. Some sidon, odas dey stand up as chair no reach everybody. Some wan hurry finish quick quick. Na so some go wan take style jump line to go front. Even dos wey dey work dia no even fit coordinate de place well. As you come in, na so you go pick number. But I come notice say de workers (one of dem na phillipino woman) just dey call de number at random. Sometimes you go hia 76, den lata you hia 51. One woman wey de tin no gree come ask dem why dem dey jump number like dat, de workers explain say na de way de tin dey for dia list...lol.

Afta dem check ya documents finish, dem go come send you go anoda room where you go go snap picture. If you snap finish, dem go tell you to go bring priority envelope. Some body go direct you to go anoda building (wey no be post office oo!) to go buy de envelope. For dia one babe dey dia dey make quick money. Envelope wey dem dey sell $4, she go sell am to you for $10. Trust naija and dia hustle. I sure say na people for de embassy dey arrange dis one. And dem no go tell you for dia website to come with de envelope, so dat you go come de embassy come buy dem own (naija eh...!)

Well I tank God say my waka no enter K-leg. Everytin go smooth for me. Some people for dia say dem don come like three times, and each time dem go tell dem to go bring one tin or anoda. But afta everytin, de place dey organise sha as per yankee standard. Who say naija no dey respect dem sef when dem need to. Dem know say if dem try any of awa usual nonsense for yankee, na double wahala for dedi body for dem be dat.

(1) (Reply)

Security Agents Comb S/ East For Operators Of Radio Biafra / Some Northern Traitors Are Trying To Isolate PMB! / FINALLY! The Beginning Of The End Of Saraki’s Corruption Dynasty [must Read]

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 31
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.