Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,149,760 members, 7,806,081 topics. Date: Tuesday, 23 April 2024 at 11:09 AM

Igbo Landing - Politics - Nairaland

Nairaland Forum / Nairaland / General / Politics / Igbo Landing (431 Views)

Igbo Landing Mass Suicide (1803) / Fuel Price To Increase As Landing Cost Soars To N213 Per Litre / Aisha Buhari Delayed From Landing By Patience Jonathan - Stella Dimokokorkus (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Igbo Landing by easystudy101: 6:26am On May 18, 2015
For today post, I wan tell una small history tory wey connect yankee and Naija. I believe some of una neva hia dis tory before. Dis one na about sometin wey happen for one town wey dey for Georgia state. De place na Dunbar creek wey dey for St. Simon island.

I remember one time wey me and one akata been dey talk, afta I don tell am say I from Naija, him come ask me weda I don hia about de tory of IGBO LANDING. I tell am no. So de guy come begin tell me about am.

So de tory na about some igbo people wey onyibo bring come america around early 19th century. Just like dem don dey bring people by force come yankee, dis one no get anytin unusual about am, except say dis group of igbos do sometin wey none of de onyibo people expect.

Dem no rebel like some groups don do before, like to fight dos wey capture dem or try to run from. De tin wey dem do be wetin I go call ultimate courage. You must get enough liver to do wetin dem do!

All of dem from pikin, women and men been wait until de ship carry dem from West Africa come reach Georgia state for america. Afta dem land, all of dem come decide to march enter de ocean and come drown dem sef. With de chains wey dey dem hand and leg and neck, all of dem commit mass suicide.

Now when you come tink am, for igbo culture dem see suicide like one kind big taboo. Person wey kill im sef no dey get proper burial. But dis people get de mind do am. Dem realize say to stay alive for dis strange land go worse pass HELL FIRE. So dem discover say to kukuma end everytin go be dia best choice.

I know say some christians go say dis poeple go still end up for hell fire. And den you go begin wonda why ee be say na de same people wey carry christianity come give us, be de same people wey begin catch awa people to be dem slave. Shey na femi kuti sing am for song-you go wona wonda wona, until you go turn to wonderer! Me sef don begin wonda about dis christianity tin well.

Some people say if you go dat place for Georgia wey dis people comit de mass suicide, you go hia strange voices and de noise wey dey sound like chains. Well....., me I no believe too much for kpoju-kpoju tory, but I dey plan to go see de place with my eyes. Any time when I get small break I go like to travel go Georgia to see de place with my two eyes!!
Re: Igbo Landing by shakazuldadon: 6:30am On May 18, 2015
Make I Google am first angry

Igbo Landing (alternatively written as Ibo Landing, Ebo Landing, or Ebos Landing) is a historic site in the sand and marshes of Dunbar Creek in St. Simons Island, Glynn County, Georgia. It was the setting of the final scene of an 1803 resistance of enslaved Igbo people brought from West Africa on slave ships. Its moral value as a story of resistance towards slavery has symbolic importance in African American folklore and literary history.

1 Like

Re: Igbo Landing by Nobody: 6:54am On May 18, 2015
I fit join body follow u see d place. Tori nice o
Re: Igbo Landing by ki02020(m): 6:59am On May 18, 2015
The slave trade was an era nobody wished to withness their action is justified

(1) (Reply)

Benue Rep-elect Loses Seat, Faces Prosecution Over Forgery / Saraki Sits Pretty For Senate Top Slot / Mega Cctv Trainning In The Great City Of Port Harcourt/buy Solar Products..pics!

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 13
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.