Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,414 members, 7,808,475 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 12:31 PM

Naija Love Rhymes For Valentine - Literature (6) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / Naija Love Rhymes For Valentine (61069 Views)

Must Read: Naija Love Part 1 (one) / Re: Naija Love Rhymes For Valentine / A Space For Peoms, Hot Rhymes, Quotes And General Sayings (2) (3) (4)

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply) (Go Down)

Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:01am On Mar 27, 2009
ashmanpolo:

@maedan, hope ur sista name no bi kate. My last date name was kate. She almst make me suffocate.Wen we start 2 date, she con de behav lik say we be mate. Girl wey de eat rice like 5 plates, drink beer like 2 crates. Serious i no de exaggerate. So i pray make her name no bi kate. I prefer immaculate

abeg o, im name no b kate
babes of dat name too dey perambulate
my sista dey decent
she just turn 21 of recent
she dey quite immaculate, for real
so no show 4 u, her heart u no go steal cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:07am On Mar 27, 2009
BILILIS:

wetin N/L don join together
abeg make no man put asunder

becos me and meadan
na bumper to bumber

BILILIS:

kai who dey claim loverboy for this thread
abeg to the left go chop ur akara n bread

no come here dey form superhero
but rather keep ur cool instead
slow and steady
they say wins d race
n me i dey ready


yes o, nairaland don join me n roty
so you no fit put asunder
so u really believe say u fit thief me
and snatch me comot from under?
no way, my guy,
tho u get ur nice style
make u save am for another
'cos if na 4 maedan, no even bother cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:41am On Mar 27, 2009
@ rotysweety kiss

as u don promise to pamper ur honey
i go show u say, i value dat pass money
u wan give me breakfast for bed,
even bathe me from toe to head,
na such attention i dey consider
dat's why our love no one fit hinder
tho' dem get sweet mouth like heyo
wey wan tune my heart like stereo cheesy
& not forgetting mr. playa bililis
wey shoot d ball but e come miss cheesy
all these no fit take ur place
dem no dey there 4 start of d race
even kidgenious talk say make i no mind dem,dem dey deceive
but u na"superlative n conjugative", "inventive n creative"
so wetin dey again, u get everything i need
na only to prepare ourself 2 finally do d deed! wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by zillonnair(m): 10:34am On Mar 27, 2009
Guys i must confess, i read this from the beginning to the end, Roty and Maeden, you are guys are just too much, thumbs up guys, wow, i really dig this, chai
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 11:19am On Mar 27, 2009
hey denony y r u lookin 4 ma attention? u r a nobody
i aint a yahoo boy
just wanna give maedan so much pleasure and joy
but u cd call me a millitant
cz am here 2 kidnap maedan's heart
with her consent and make her life more pleasant
i can prove myself worthy if she demands anything
am not like u dats hungry,u r thinner than a pin
this is true love not a fling
so close ur mouth up or u want some bling?
nah i no be gay so i aint buying u sh*t
i cd help u pay ur bride price with what's on my wrist
and yes i am here 2 put asunder
cuz roty and maedan together is a total blunder
so if u have a problem it
u can kip typing or maybe grow hairs on ur teeth
don't have ur time so free me like terry gee

@ Heyo

hey heyo abi your name na Mr. Bean angry
i just dey my own na you dey choke me for yash
Your attention i never seek, i just dey talk reality


why u go call me nobody when i be big time somebody wink
don't you know dat everybody na king for own Palace grin
Abi na your big mouth na him we go chop?

your type na him dey claim say every moto right goods only na your papa get am
only to trip the girl and get better of her
Abeg stay clear for what God don join together
me i no be their defender, but no need to be offender thereby put assunder

i mean no harm my brother, but na you find my wahala
as i dey so i no like kasala
but u can't step on my tail and just go scot free

E be like say u come here to dey messmarize people future
i dey feel your rymn but no pass your border
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 11:22am On Mar 27, 2009
@ Heyo

hey heyo abi your name na Mr. Bean angry
i just dey my own na you dey choke me for yash
Your attention i never seek, i just dey talk reality


why u go call me nobody when i be big time somebody wink
don't you know dat everybody na king for own Palace grin
Abi na your big mouth na him we go chop?

your type na him dey claim say every moto right goods only na your papa get am
only to trip the girl and get better of her
Abeg stay clear for what God don join together
me i no be their defender, but no need to be offender thereby put assunder

i mean no harm my brother, but na you find my wahala
as i dey so i no like kasala
but u can't step on my tail and just go scot free

E be like say u come here to dey messmarize people future
i dey feel your rymn but no pass your border
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 2:19pm On Mar 27, 2009
@denony


hey,take a chill pill
or rather like statue of liberty,just stand still
i haven't seen any love story that has no bad guy
involved to let the chic in question tell her guy bye
i am not starting any drama with u
i just want to focus on roty n his boo
but u called me a yahoo boy n a militant
so i had to make the beef constant
no b me find trouble
but if u want it,i go give u double
wat the hell? u r making me waste my rhymes
wey i suppose dey drop 4 maedan make she get the signs
hommie lets just enjoy the game
no time to call each other names,no time 2 lay blames
pisso

@billis

tanx 4 attacking me indirectly
but let me brush u up properly
i am the foremost loverboy on this thread
so do ur thing and leave me instead
let me do my chase
cuz i am number one in this love race
if u claim u r d baddest and meanest
let's see who gets maedan first
or rather lets see who rhymes best
they r a lot of judges
let's just do this and leave all the grudges
didnt come here 2 fight no one
am just here 2 get maedan n catch fun


@maedan

my princess
d love i v 4 u dey excess
i can see u r not a material girl
so like cassie,u could be my official girl
i wd listen 2 ur problems
and find ways 2 solve ur problems
my shoulders r broad enuff 4 u 2 lean on
like usher,my love i would let it burn
for u,only 4 u so much dat u cannot comprehend
even if u no fine without make-up,i no send
u need to concentrate on me a little more
cz u gat the keys 2 my heart which is door
2 ur emotional happiness and satisfaction
if u need me 2 bring ur breakfast 2 bed,don't mention
we could stroll at the park hands in hands
tellin u hw much i care as we sit on the beach sands
we could kiss at night on the rooftops
while the cool breeze sensitizes us,as we caress with no full stops
like 50cent said,all i need is a liitle bit
a little bit of ur time,b4 u know it u wd b mine
so maedan stop the frontin and the long thing
u aint nobody's wife yet so i can still place my bet
u said next time i wan vex,make i chill 4 swimming pool?
dont worry with u by my side 4 d pool,i go cool
enough said


@roty

i gatta give u props tho 4 this initiative
real talk wat dat dude said,u r creative
read the first 4 pages b4 i came thru
and i must say u r good
but the way u were rhyming got me in d mood
2 wanna put some drama into this
and see if u r stil worthy of d marital bliss
with maedan
so dude kip doin ur thingny
cuz this is a freestyle thingny
i wanna see how much more u gat
cuz u v been quiet as a matta of fact
since i stepped into the scene
come on, u gatta a lot of fans out there
so fight 4 ur love ,maedan's teddy bear
hahhahaha!!! enuff said
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by dimitri(m): 3:22pm On Mar 27, 2009
@ roty

guy make you no fear
because of these guy wen just appear
your lyrics wen u sow like seed
don be like the proverbial mustard seed
make you make sure u tend am make e no turn to weed
because the heart break, i sure say u no need
de girl correct indeed
she no dey for any deceit
but if you dey fear her deeds
u fit carry her go Redeem, lipsrsealed
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by gReenmAn(m): 3:25pm On Mar 27, 2009
A beg where's roty?

Or has all these hot blooded rhymestars scared him off the chase.

Waiting tongue
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by dimitri(m): 4:08pm On Mar 27, 2009
@maedan

abeg o, im name no b kate
babes of dat name too dey perambulate
my sista dey decent
she just turn 21 of recent
she dey quite immaculate, for real
so no show 4 u, her heart u no go steal



this talk about your sister
don bring another drama into the matter
because you say she turn 21 of recent
and come equally dey descent,
me i de interested with no pretence,
thank GOD say my girl miliscent
don take recess,
so i de free to access
i de feel the scent
of ur sister innocense
i know say she deserve no non-sense
make you introduce me to her because i make sense
and i know say she go like my american acscent cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 5:50pm On Mar 27, 2009
Heyo, now you are welcome
i think say u be bitter for titter,
but now i know u just want a piece of the cake.

You wanna ride with Roty, at the back of maedan,
lets see who wins
but to my own perspective i can ser roty
clinching the title. league already won

i cross my finger
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 6:07pm On Mar 27, 2009
What should i do?
i don't wanna go
and i don't wanna stay

i must see the end, as i have witnessed the beginning
join the race? it's a cantamosion,
This is not by power,
its by feeling,
Can you feel wat am feeling
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by lexdino: 6:19pm On Mar 27, 2009
my rhymes too dey rhyme and me nor get una time smiley
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by kidgenious(m): 6:38pm On Mar 27, 2009
Hey roty,y d freak jeez did u freeze
either ur system was attacked by a virus catalyst
or ur internet subscription suddenly cease
maedan hope dere's no crisis
or u guyz ar trippin across d sea
dis is gettin interestin
we 1na c mor thrills n flicks.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 7:19pm On Mar 27, 2009
@ heyo,

heyo i didnt attack u indirectly
was only tryn to prove dat i might be
showing meadan that most likely
she'll end up being my wifey
more of letting her understand
i want to be her certified Mr. Man
pls 4get there r a lot of judges
n leave all d grudges
cos we all are N/L Buddies
so lets go ahead n keep the thread on
cos its all for the fun

@ meadan

na lie
actor no dey die
instead them go write the end
i really want to be more than a friend
no wonder
u strike tough words on me like a thunder
and act like u scared of d anaconda
anyway thanx for complimenting my style
cos right now, u making me smile
am writing this love letter
hopefully things will change
n turn 4 d better
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:23pm On Mar 27, 2009
maedan:

@ rotysweety kiss

as u don promise to pamper ur honey
i go show u say, i value dat pass money
u wan give me breakfast for bed,
even bathe me from toe to head,
na such attention i dey consider
dat's why our love no one fit hinder
tho' dem get sweet mouth like heyo
wey wan tune my heart like stereo cheesy
& not forgetting mr. playa bililis
wey shoot d ball but e come miss cheesy
all these no fit take ur place
dem no dey there 4 start of d race
even kidgenious talk say make i no mind dem,dem dey deceive
but u na"superlative n conjugative", "inventive n creative"
so wetin dey again, u get everything i need
na only to prepare ourself 2 finally do d deed! wink

I still dey thank Baba wey dey yonder for de day we come meet,
Something come tell me say you be one lady wey no be easy meat.
For de strong confidence U get for me even when others dey propose,
Our marriage go dey stronger pass Olumo Rock & you I no go dispose.
I no go fit buy you a water bed but U go dey sleep with joy in your heart.
I no go fit even buy you fine jeep but we no go live like a dog and a cat.
Prince Charles and Princess Diana come get everything in dis world,
But true love which be the center for every marriage dem no fit hold.
True wife like you no be an article for market which every man wan price,
Na your inner quality and strong virtue I consider to be a very high prize!
I go love you my beauty queen untill sun no dey for the blue sky again,
I go love you in all seasons of life, in storms, in severe winter & in d rain.
I go love as you love me no be because of what you are but who you are to me,
Take these words into your heart because dem be true and come from Rotimy!!!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:29pm On Mar 27, 2009
kidgenious:

Hey roty,y d freak jeez did u freeze
either ur system was attacked by a virus catalyst
or ur internet subscription suddenly cease
maedan hope dere's no crisis
or u guyz ar trippin across d sea
dis is gettin interestin
we 1na c mor thrills n flicks.

Rotimy no freeze or attacked by any virus catalyst,
I dey busy de share our wedding cards from de list
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:33pm On Mar 27, 2009
gReenmAn:

A beg where's roty?

Or has all these hot blooded rhymestars scared him off the chase.

Waiting tongue

Roty dey very busy dey prepare de wedding,
because with Maedan e go be a happy ending!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 8:37pm On Mar 27, 2009
dimitri:

@ roty

guy make you no fear
because of these guy wen just appear
your lyrics wen u sow like seed
don be like the proverbial mustard seed
make you make sure u tend am make e no turn to weed
because the heart break, i sure say u no need
de girl correct indeed
she no dey for any deceit
but if you dey fear her deeds
u fit carry her go Redeem, lipsrsealed



The rope wey dem don tie double,
To break am na to look for trouble
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:40pm On Mar 27, 2009
@ all

how i go fit describe
how much i dey feel una vibe
even plus heyo wey wan snatch cheesy
but in naija flow e no b roty's match
e be lyk say im be americana
wey jus dey learn 2 b africana grin
he wan bust my head with him big grammer
bt true true e dey add more class 2 dis drama

bililis nko, he no wan slack
e dey continue im romantic attack cheesy
even if e lyk, make e dey dribble
but my love 4 roty no go ever cripple
i only pray u no go chase am away
i no go forgive u if mysweety abandon d loveplay!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 8:57pm On Mar 27, 2009
2 my roty

i almost wan dey start 2worry
say u no wan finish dis love story
but as u xplain say u dey prepare,
i don already stop to dey fear wink
because some men dey run wen competition too hot
dem no lyk stress, so dem go comot hand 4rm d pot
but as u stay n fight
u make my smile shine bright

now back to our main agenda,
on how 2 keep d love strong yet tender
4get Diana n Charles, even Michelle n Obama
na we be d original couples, our lv dey bammer! cheesy
ur sweet words of lv dey rub pancake for my tummy
soon we go start family n i go b ur pickin mummy! shocked grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by rotimy(m): 9:06pm On Mar 27, 2009
heyo:

@denony


hey,take a chill pill
or rather like statue of liberty,just stand still
i haven't seen any love story that has no bad guy
involved to let the chic in question tell her guy bye
i am not starting any drama with u
i just want to focus on roty n his boo
but u called me a yahoo boy n a militant
so i had to make the beef constant
no b me find trouble
but if u want it,i go give u double
wat the hell? u r making me waste my rhymes
wey i suppose dey drop 4 maedan make she get the signs
hommie lets just enjoy the game
no time to call each other names,no time 2 lay blames
pisso

@billis

tanx 4 attacking me indirectly
but let me brush u up properly
i am the foremost loverboy on this thread
so do ur thing and leave me instead
let me do my chase
cuz i am number one in this love race
if u claim u r d baddest and meanest
let's see who gets maedan first
or rather lets see who rhymes best
they r a lot of judges
let's just do this and leave all the grudges
didnt come here 2 fight no one
am just here 2 get maedan n catch fun


@maedan

my princess
d love i v 4 u dey excess
i can see u r not a material girl
so like cassie,u could be my official girl
i wd listen 2 ur problems
and find ways 2 solve ur problems
my shoulders r broad enuff 4 u 2 lean on
like usher,my love i would let it burn
for u,only 4 u so much dat u cannot comprehend
even if u no fine without make-up,i no send
u need to concentrate on me a little more
cz u gat the keys 2 my heart which is door
2 ur emotional happiness and satisfaction
if u need me 2 bring ur breakfast 2 bed,don't mention
we could stroll at the park hands in hands
tellin u hw much i care as we sit on the beach sands
we could kiss at night on the rooftops
while the cool breeze sensitizes us,as we caress with no full stops
like 50cent said,all i need is a liitle bit
a little bit of ur time,b4 u know it u wd b mine
so maedan stop the frontin and the long thing
u aint nobody's wife yet so i can still place my bet
u said next time i wan vex,make i chill 4 swimming pool?
dont worry with u by my side 4 d pool,i go cool
enough said


@roty

i gatta give u props tho 4 this initiative
real talk wat dat dude said,u r creative
read the first 4 pages b4 i came thru
and i must say u r good
but the way u were rhyming got me in d mood
2 wanna put some drama into this
and see if u r stil worthy of d marital bliss
with maedan
so dude kip doin ur thingny
cuz this is a freestyle thingny
i wanna see how much more u gat
cuz u v been quiet as a matta of fact
since i stepped into the scene
come on, u gatta a lot of fans out there
[s]so fight 4 ur love ,maedan's teddy bear
hahhahaha[/s]!!! enuff said


 


A wise man wey him Papa born well do dey fight woman fight,
because dem fit wound am below him belt or on his lips give him a bite!
I dey use my energy dey do something wey go cement my marriage,
Walai, I no sure say I go get time to fight or with you exchange rage!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 9:08pm On Mar 27, 2009
dimitri:

@maedan




this talk about your sister
don bring another drama into the matter
because you say she turn 21 of recent
and come equally dey descent,
me i de interested   with no pretence,
thank GOD say my girl miliscent
don take  recess,
so i de free to access
i de feel the scent
of ur sister innocense
i know say she deserve no non-sense
make you introduce me to her because i make sense
and i know say she go like my american acscent  cool

as 4 u mr dimitri cheesy
ur own b another mystery
2 toast my sister, u go need 2 start a new thread
because e go take 20 pages 4 u to prove ur street cred grin
u sef u too lyk better thing!
make u drop d idea or u go feel my sting wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by dimitri(m): 12:25pm On Mar 28, 2009
@ maedan

I no fit stay away because of your sting
especially when i no say i de luk 4 good thing
i go struggle tru thick and thin
untill i give ur sister platinium ring
since last nyte, her tots de strengthen me like ovaltin
i no fit wait for me and her to run things
as for you , in roty u don get everytin
so make u let ur sister get little thing.
her decency don scater my evry  other exigencies
so i must try hard even if na to get support from donor agencies wink
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 1:41pm On Mar 28, 2009
@ dimitri
lol, if u lyk use all ur biggest english
see as u wan take big net catch one single fish
well,good thing no dey come easy
if u wan win dis prize, oya get busysmiley
post in ur CV, wit enuf proof of ur romantic skill
plus ur financial status,2show say u fit d bill!!
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by dimitri(m): 3:26pm On Mar 28, 2009
@ maedan

me i don de busy
because i no say she go like plenty efizzy.
Granted say she no go come easy,
even as i expect you to de bossy,
but  by the time she see me
she go stop to de choosy,
because i de different frm de other guys wen de sleazy.

i go luv her to full capacity
even as i go take her to New York city
we no go get any complexities
even if we de  hexagon for benin-city
I go give her publicity
because two of us go be celebrities  grin
so make u leave all trivialities
make two of us get lasting unity.
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by denony(m): 5:02pm On Mar 28, 2009
@ Dimitri
i don enter this race with heat
I no go fit sleep over this
this one na total overthrow u wan do,

This game no go easy
cos enough gigsy don enter chessy
na my turn to grab this chicky
but i no say e no go easy
cos' a lot of guys here can cause confusy

@maedan
maedan dear, i have been guiding your proposal with roty grin
this time you will guide me to this promise land
tell your sister about this Lovely, caring, romantic and extrovert niggi
tell her i will do anything for her, even though it takes kissing her fit wink
tell her everything will be hers, if only she go accept my proposal undecided

I will always be with her through rain come sun
i will always be her shade, even when there is no sun grin

Tell her that she will never be alone
cos' i will always be there for her
tell her that her burdens i will bear wink

that i will climb a mountain to high for the sake of her love
tell her am humble in her grace
that i will spill like a carosell
and make her world always alive.

That somebody needs her most
ready to die for her, and ressurect again because of her grin
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:34pm On Mar 28, 2009
dimitri, and even u, denony cheesy
una mouth too dey flow like honey
but u just dey put una sef for torment
u wan start a new love tournament
for dis one, i no fit be umpire,
i get enuf stress 2 make me tire
i no hear from my roty for some time
i don dey miss im sweet naija ryhme
so if una like, continue una quest
to try tiff a dove like my sista from her nest cool
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by maedan(f): 11:42pm On Mar 28, 2009
dimitri:

@ maedan

me i don de busy
because i no say she go like plenty efizzy.
Granted say she no go come easy,
even as i expect you to de bossy,
but  by the time she see me
she go stop to de choosy,
because i de different frm de other guys wen de sleazy.

i go luv her to full capacity
even as i go take her to New York city
we no go get any complexities
even if we de  hexagon for benin-city
I go give her publicity
because two of us go be celebrities  grin
so make u leave all trivialities
make two of us get lasting unity.



denony:


@maedan
maedan dear, i have been guiding your proposal with roty grin
this time you will guide me to this promise land
tell your sister about this Lovely, caring, romantic and extrovert niggi
tell her i will do anything for her, even though it takes kissing her fit wink


that i will climb a mountain to high for the sake of her love


That somebody needs her most
ready to die for her, and ressurect again because of her grin


chei! na laff i go take sleep dis night!
e be like say una don get d love bite!
anyway sha, una try for d effort
just manage una pillow 4 now to get some comfort! tongue cheesy
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 12:42am On Mar 29, 2009
@roty


homeboy!! u r cementing wat?
yo!! its high time we fought
i am not gonna take this likely
i am gonna pressurize u definitely
to leave my future wifey
u r busy sharing cards?
u jokin rait?one of those ur blabs?
yeah it should b ur blabs
just like saying usher got no tummy abs
thats how unrealistic you can get
sharing cards?i think i would like 2 hit u below da belt
if i don't have maedan,none of us will
so better back off,hope u get the drill
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by heyo: 1:04am On Mar 29, 2009
@denony


homeboy,u can cross ur finger pass the one of calvary
roty is clinchin sh*t! dats my boo he wants 2 marry
and tanx 4 being reasonable
i can see u want maedan's sis dats available
i can see she sey stubborn 4 dat one
my guy carry on


@dmitri

where the hell did u come from?

@maedan

my queen,i no b americana
and i no dey smoke marijuana
but i am just bein my fly self
roty tite 4 d naija rhyme no doubt
but i am walkin in my shoes,dats wat i'm about
if u want me 2 break it down 4 ya,i will
but happy i want u 2 make me feel
by adding some suspense in this fiasco
even tho u no be lupe or johnny brasco
let the readers feel some suspense
and keep them yearnin for more
don't let anyone snore
shift sides a little bit baby
either 2 mine or billis
maybe he has more action like bruce willis
who knows?
but i am PDP so u gatta come 2 mine
cuz i rule up in this mothaf***
roty's love show is old news
am new school so lets play by my rules
so do ur thingny!!enuff said
Re: Naija Love Rhymes For Valentine by BILILIS: 12:53pm On Mar 29, 2009
@ meadan

i no send anybody but u
want u know dat i've always got u
neva eva do anything to hurt u
God forbid someone's heart is broken, baby not u

this thread no fit tempt me
with plenty bad guys in disguise
wey dey promise u bently
when their bank a/cs still dey very empty
n recently
playa hataz don enter dis thread acting like say them dey vexing
but they'll remain depressed and distressed while we'll be flexing
n finally making u mine has been on my mind n dats d next thing
so to all those pple who no like us, n see us dey bone
i dey tell dem too say make dem, leave us alone
cos i be die hard n i no dey give up my own

real poetry in motion on dis thread, is wat it is
a lil swagger mixed wit some street cred, is bililis
yes when i release
n take my shot, i neva miss
becuz i take my tym n move smoothly based on the "G" Principle
i strongly believe dat d connection btw us is invisible
ur light i want to rekindle
to shine so bright on me till i feel the goose pimples
n to prove to u my love is simple
by droppin rhymes n hotlines on dis thread like some sweet jingles

(1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10) ... (40) (Reply)

Shadows From The Past....[The Past Came Haunting]-- A Short Story. / Nephilim / Wole Soyinka: Things You Never Knew About Him

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 113
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.