Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,358 members, 7,808,242 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 09:17 AM

Made In Nigeria Proverbs - Jokes Etc - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Jokes Etc / Made In Nigeria Proverbs (1256 Views)

Some Common Nigerian Pidgin Proverbs / Corrected Nigeria Proverbs / Funniest Pidgin Proverbs Ever (2) (3) (4)

(1) (Reply) (Go Down)

Made In Nigeria Proverbs by ezeigbo194(m): 9:18pm On Sep 11, 2015
1. Na for old age ashawo dey know
the value of pikin.

2. Woman wey never see problem...
Na im dey still hold breast run.

3. Woman wey dey find pikin no dey
wear pant sleep.

4. Rat wey follow lizard enter rain, Na
later é go hear am.

5. Na for afternoon dem dey find
black goat.

6. Weather hot!! É No mean say fowl
go lay boiled egg.

7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.

8. Pikin wey him mama back cross
water, wey say him march fish, wetin
him mama go march?

9. Small pikin wey dem carry for
back no know say the journey far.

10. Person wey don faint before no
be stranger to death.

11. Person wey chop belle full, no
know wetin hungry man dey see.

12. No be as woman dey close eye
enjoy sex she dey enjoy labour
pains.

13. Yansh no get teeth but e dey cut
shit.

14. Lizard wey fall from tall iroko
tree, if nobody hail am!! é go hail
himself

15. Toto water small, but é reach
prick take baff.

16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO
BOYFRIEND, SHE GO TAKE
BOYFRIEND DO HUSBAND.

17. Cockroach wey jam fowl, jam bad
luck.

18. Na cricket tell him children say,
No matter how ground strong, Them
no go sleep outside.

19. Pikin wey say him mama no fine
they use style call him papa blind
man.

20. No be eye wey dem take chop
eba dem take dey share meat.

21. Person wey use Elephant set
trap, na him know wetin he wan
Catch.

22. When Breeze Blow Fowl Yash Go
Open.

23. STUDENT WEY READ NA HIM
SERIOUS, BUT STUDENT WEY PASS
NA HIM KNOW BOOK.

24. Dem no dey tell tortoise say race
don start.

25. Dem no dey tell blind man say
salt no dey for food.

26. Before you see monkey, monkey
don see you.

27. Thief wey jump fence enter house
where owner dey wait for am, no go
jump again.

28. If pikin say he sabi die, him papa
sef go tell am say him sabi bury.

29. Na wetin dey sweet for goat
mouth, Na im dey kill am.

30. If e be like say everybody dey
craze" na you dey craze.

31. Meat wey you dey forbid, no use
your teeth cut am.

32. My thing and our thing no be the
same oh

33. Na happiness dey make prick
stand.

34. Na as goat stand for market dem
dey price am.

35. Craze no hard to form, na the
trekking be wahala.

36. Its a small world!! No mean say
you fit trek from Naija go London.

37. No matter how hot your temper
be, e no fit boil beans.

38. Chicken wey run from Borno go
Ibadan go still end up inside pot of
soup.

39. Today’s newspaper na tomorrow
Suya wrap.

40. Akara and moin moin get the
same parent, na wetin dem pass
through make dem different.

1 Like

Re: Made In Nigeria Proverbs by datYoyo2000(m): 9:36pm On Sep 11, 2015
Correct. Oya FP things
Re: Made In Nigeria Proverbs by jessejagga(m): 9:56pm On Sep 11, 2015
lmao this rilly kul cheesy.
No be as woman dey close eye
enjoy sex she dey enjoy labour
pains.

1 Like

Re: Made In Nigeria Proverbs by Nicklaus(m): 10:07pm On Sep 11, 2015
Lol. Make sense cheesy
Re: Made In Nigeria Proverbs by ezeigbo194(m): 8:46pm On Oct 20, 2015
Naija too make sense

(1) (Reply)

Illiteracy Is A Disease. Don't Laff Alone / Coin A Name For This Tricycle. Funny Pix / Picture Of Apc Change.

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 16
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.