Welcome, Guest: Register On Nairaland / LOGIN! / Trending / Recent / New
Stats: 3,150,295 members, 7,808,003 topics. Date: Thursday, 25 April 2024 at 02:20 AM

How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) - Literature (10) - Nairaland

Nairaland Forum / Entertainment / Literature / How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) (244912 Views)

Future In Chaos (A True Life Short Story)written By Etz Sky Prince / Soyinka Backtracks On U.S Visit, Returns To Deliver Lectures / The Day MTN taught me the Lesson of my Life ( Short Story) (2) (3) (4)

(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (36) (Reply) (Go Down)

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by micronut(m): 1:48am On Oct 18, 2015
Una dey here still dey expect op to update, when the guy don they snore already. OP you no do well oooo, this kind yeye sleep wey u dey sleep so... if dem born u well, no come finish wetin u start early mo mo....

Wen i don dey plan to hire you to come and fool yourself for me and my family. Redeem your image first thing tmrw morning by pasting that fucking tori... Tell me the end of ichinbong abeg!

2 Likes 2 Shares

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by puskin: 2:01am On Oct 18, 2015
Yungmilio2:
even puskin and pholz viewing

sleep no gree come.
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Mcslize: 2:04am On Oct 18, 2015
classcaptain u no try o...as per say u dey stingy wit ur update ur updates go dey get short hand and leg.....who wan read dis short short update u dey drop?

We r all tall and u dey drop us short short dwarf post. Ur left yansh there

1 Like

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Pdizzle(m): 2:41am On Oct 18, 2015
Classcaptain, nice one as always
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Zico4real(m): 5:29am On Oct 18, 2015
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Johnbosco77(m): 5:55am On Oct 18, 2015
@classcap I Don read sotehhh I no knw wen time for early morning mass take pass me. a beg finish am before I come back oooo. nice fiction bro. keep it up. forget those bad belles . my people say no matter Wetin u do dem must talk.
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 7:09am On Oct 18, 2015
Make we sharply drop some episodes before we go out various places of worship..
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by johnchukky: 7:11am On Oct 18, 2015
make i reach church. brb
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Daddydavid(m): 7:29am On Oct 18, 2015
Na tonder when dey practise pressup since 1985 g0 fire u if u no complete this sweet dellof story when u start. Na people mama and papa u put for punishment so.....@classcaptain jumbu
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by chikwendujohn: 7:30am On Oct 18, 2015
una no dey well come new person? E like say na me be the last born here
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 7:46am On Oct 18, 2015
Episode 14 ( Going The Spiritual way.. scoping the man of God )


Na the Fourth day be this ooo.My guys don day ask me how far with the package ...dem sabi say he no day take me long like this before parole go click.

Rokiatu no take me pass 2 days even almighty Ishilove na d first day we meet i chop am,na only tantalizers meat pie and Cold Fayrouz he cost me .why dis inchinbong own wan con different. Na ??.

I sha dey whine dem sey work is in progress ,then show dem our previous chats .dey sef dey nod day await result.

Me wey i no get myself..Na different foolish ideas just day come my brain..

Make i try my luck with this one.



The next day, I chop the concontion rice wey i cook yesternight...I no finish am as salt too much.. i sharply do rub and shine,Wear my nigerian super eagles Jersey ,jeans and timbaland.

Spray my aboki perfume,rub damatol full my hair and set out to ichinbong's fellowship center..

7 Likes 3 Shares

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 7:52am On Oct 18, 2015
Episode 15

As i dey waka go the syd. Na different things day come my mind..me me?? .Angel..Na me con turn person wey day waka about .day struggle on top one babe ?? OK.. no probelm.

If no be something way make crayfish bend .Me to dat kind ichinbong .

God sabi when last i don step my leg for inside dis church.The last time wey i con scout for babes. Na d first female usher i meet for door discourage.

..How usher go wear blue top on top red skirt join am with yellow socks con finish any form of Attractiveness she suppose get with her pink beret ?? Later dem go full vigil say dem no see husband .. "" How u go see husband when your dressing be like person wey no sabi house to support for interhouse sports .... Yeye dey smell



The person i meet for church nearly tear race comot on sighting me.. Me i just bone face enter. Me i no see d guy blame because i don sabi d atrocities wey i commit .. As i day talk say the babes for d church no fine reach. i still manage tear deir three of their choir members including the much loved holy mary ,choir mistress. Sis blessing Ojai.


How d news take spread i no sabi till date ..The matter almost tear d church into two.But dat one na tori for another day.

17 Likes 2 Shares

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 7:55am On Oct 18, 2015
Episode 16

Brother boo " The guy abi na man wey i meet for church greeted me.I look am from head to toe as he be like Stick man sweet inside hin Oversized shirt and Backo bag trousers..

" Am not a brother pls ".. i responded
" But brother.. sorry ..we are one body in...
" ( Cuts in ) pls is pastor Seun around...
" Pastor Seun ??
" No pastor lalasticlala..is he around jare " i said getting impatient
' Haa hope there is no probelm " he said ..he was Smiling all the time clearly ignorant of his delapitated brown dentition.

' Will u get me d man of God or will u keep me waiting.. Isthat what d book of the lord taught u ??

No sorry sir.i will get him now....He said..He beckoned to one sister in the blue shirt and red Skirt uniform and asked her to check the pastor in his office...

Omo dat sister get yansh no be small ..on top all d wahala wey carry me come.i couldnt help but check out dat sister basia as she walk enter pastor office..

" Haa brother boo ..i have a message
" Oga pls i dont want any message...

Haa ok..The sister soon came back and gave a report that d pastor bin day pray for inside room and say he fit take like 2 hrs because na Special Week prayer he day pray today .Haa which kind thing be this.


2 hours ?? Him day pray for the whole school ?? Wich kind level be this naw... Ehn today na today .I go wait..

9 Likes 1 Share

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by MARINS(f): 7:57am On Oct 18, 2015
Abeg.. How burnt goat dey laugh. undecided undecided
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Nobody: 8:04am On Oct 18, 2015
@classcaptain.....u try small sha.....

2 Likes

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by dagred(m): 8:14am On Oct 18, 2015
Alaye finish dis tin na abeg
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Obakenny01(m): 8:21am On Oct 18, 2015
Ok
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Obakenny01(m): 8:23am On Oct 18, 2015
dagred:
Alaye finish dis tin na abeg
lol
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Aminzy(m): 8:30am On Oct 18, 2015
if house dey burn,rain dey fall,I will wait for d next episode
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by charlespaker(m): 8:34am On Oct 18, 2015
Hmmmn Classcaptain u sure sey u don finish this story for your head? CUZ it sounds like you are still seeking for inspiration, just saying sha,dont rush,take your time so mk u no sour d tori.....

2 Likes 1 Share

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Abdulgafar86(m): 8:36am On Oct 18, 2015
#ClassCaptain... grin#ClassCaptain...
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by charlespaker(m): 8:38am On Oct 18, 2015
Choi people too like bleeping tori,c as dem line up abeg grin,I bet some of ya r constantly reloading this page while in church grin grin
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by ClassCaptain(m): 8:47am On Oct 18, 2015
Episode 17

People day enter day look me day shook head, me sef look dem back they shook head.

" What's that thing on your face",Did u injure yourself " the backo trouser guy ask me..
" Nothing to concern yourself with ," i responded.

The backo bag trouser guy dey look me sef day look am. .Look me i look you.Man no go wetin ------------- ( Fill in d gap ).

The concontion rice day make stomach sing Tonto dikeh songs since morning .My guys be day call me for lectures ,i no pick infact he reach one stage way i just switch phone off . The hunger wey day gbab me plus d Kind eye people take dey look me reach make i vex comot d Church but no. Am here for a reason.

Na on top d chair i be don sleep day dream of how i go take spend my 40k winning when i just waka comot from d sleep enter reality.. Haa 2 hrs don nak..30 minutes join am sef.

I look around for the Backo trousers guy i no see am ..Haha..I bin don day fear untill i bin see d Guy day come inside with small small pikin speedy biscuit and purewater,they crack d thing chop..

" U mind "..he said offering the speedy biscuit to me..

Dis one day craze..Na speedy biscuit day do me naw

" Pls where is d pastor " he should be through by now " i said as calmly as i could..

" haa brother...sorry ..dont u think u shld come back d next day...I think he will

He will be kini?? See i cant come back d next day oo..I must see d man of God today.. Lai lai..

Even the people wey day read this tori wan sabi wetin i wan go do for d man of God syd..

U con say make i come back the next day.. Next day kor. days of d future past ni. oga i no day come back kan kan.

17 Likes 1 Share

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by timmycris(m): 9:05am On Oct 18, 2015
I sha hope sey dz tori no gt season 2 cus dz ur episodes many ooo
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Helkayklassic(m): 9:38am On Oct 18, 2015
@classcaptain sey u no go need assistant classcaptain like dis? wey go dey help u update the story! we r waiting sha #Following
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by nobosaba(m): 9:44am On Oct 18, 2015
What I like @Op is the originality of this Story. Keep it up.


So But male and female full this thread since yesterday dey wo read how person wo take chop person punany. Even I see one moniker wey be PastorBen, na WA o

1 Like

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Tolupage(m): 9:48am On Oct 18, 2015
ClassCaptain wetin now?? Dis ur story sweet o but e don dey long pass Jumong and 24 oo ur half time break don too plenty.

Biko write d remainin episodes sharparly....

1 Like

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by speak2leo(m): 9:52am On Oct 18, 2015
this ur tori don dey lose value o. Abeg kuku finish am shapely make man rest.


U go good to write script for season movies, I swear down!

1 Like 1 Share

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by phatriqk(m): 9:54am On Oct 18, 2015
OP too much of everything is bad, d suspense too much na, ifna likes u went u gotten over needed likes, if na followers you want u don get more Dan enough wat else du u need abeg post d rest joor

3 Likes 1 Share

Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by McKc22(m): 9:59am On Oct 18, 2015
class captain any where u go I go day follow follow u eeh until u finish d tori
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by lmm4real: 10:05am On Oct 18, 2015
I think the law of diminishing marginal return is already taking its course here. See as viewer ship done drop.

My guy u try but finish this thing we get work to do.
Re: How A Girl"s Visit to My Room Changed my Life ( Short Story) by Alihkizito(m): 10:17am On Oct 18, 2015
Av notin to say yet.....
But awaits the end of this article

(1) (2) (3) ... (7) (8) (9) (10) (11) (12) (13) ... (36) (Reply)

Iyawo Nylon Bag / HERO (A Violence, Mind Control And Sex Story) a story by Queenliz / Showers Of Mercy - True Life Story

(Go Up)

Sections: politics (1) business autos (1) jobs (1) career education (1) romance computers phones travel sports fashion health
religion celebs tv-movies music-radio literature webmasters programming techmarket

Links: (1) (2) (3) (4) (5) (6) (7) (8) (9) (10)

Nairaland - Copyright © 2005 - 2024 Oluwaseun Osewa. All rights reserved. See How To Advertise. 38
Disclaimer: Every Nairaland member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on Nairaland.